Blog masonry

Background

Sports

Naija Athletes Burst Outdoor Season with Records, PBs and Big Wins For US

By: Esther Ayoola Say like dis, Nigerian athletes dey show workings for outdoor season, recording wins, personal bests and even national record for sprint, jumps and throws events. Chinecherem Nnamdi win men javelin for Tom Jones Memorial for Florida wit big personal best of 84.68m wey break im own national record and push am go seventh for Africa all-time list. Kanyinsola Ajayi run 100m invitational for Auburn meet clock 9.90s wind-assisted to lead Nigerian 1-2 finish as Israel Okon come […]

todayApril 20, 2026 13

Sports

Rangers Beat Enyimba 2-1, Worsen Dia Relegation Fight

By: Esther Ayoola Rangers International FC of Enugu don make Enyimba International FC relegation battle worse beating dem 2-1 for NPFL Week 35 match wey happen for Nnamdi Azikiwe Stadium, Enugu, behind closed doors. First half no get goal as both teams struggle to convert dem chances. Enyimba first score for 48th minute through Wonah Williams, but Rangers equalize for 61st minute as Chiedozie Iwundu slot am in during goalmouth scramble. Ifeanyi Onyebuchi later score winner for 68th minute, as […]

todayApril 20, 2026 10

obodo oyinbo

Ukraine Police Boss Resign Say Im Officers Run From Gun Battle For Kyiv

By: Esther Ayoola Head of Ukraine patrol police, Yevhen Zhukov, don resign afta two of im officers face serious criticism say dem run comot during deadly shooting for Kyiv. Di attack hapun on Saturday for Holosiivskyi area, wia one-man open fire for street, kill 6 people and injure 14 others before e take some people hostage for supermarket. Police later engage am for gun battle and dem kpai di attacker. Ukraine Interior Minister, Igor Klymenko, tuk say dem don suspend […]

todayApril 20, 2026 11

obodo oyinbo

US Navy Seize Iranian Ship For Gulf, Iran Vow To Retaliate

By: Esther Ayoola US Presido and Im Navy don go intercept one Iranian cargo ship wey dem dey call Touska for Gulf, as part of dia blockade dey cause serious gbege. Trump explain for im Truth Social say di ship no respond when dem warn am make e stop, naim make dem seize am. Iran dey vex for di other side, say na violation of ceasefire and dem go retaliate, calling am “armed piracy.” Meanwhile, US Vice-President JD Vance dey […]

todayApril 20, 2026 10

National

JAMB Release 1.2 Million UTME Result Again

By: Esther Ayoola JAMB don announce di release of result for candidates wey write 2026 UTME on Friday 17 April and Saturday 18 April. According to dia tuk, tuk, Fabian Benjamin, over 1,264,940 results for those two days don ready for candidates to check. Dem also tuk say dis one, say e dey follow di earlier batch wey dem release for people wey write exam on Thursday 16 April. Candidates fit now check dia result online as JAMB don make […]

todayApril 20, 2026 6

National

SSANU Reject 30% Salary Raise, Threaten Strike For Federal Schools

By: Esther Ayoola Say wi Federal gorment bin approve 30% pay increase for non-academic staff for federal universities, polytechnics and colleges of education, but like dis, SSANU don reject di 30% increase. Nor be amebo say di Minister of Education, Dr Tunji Alausa, put for one letter wey e write on March 30, 2026, say di raise go come as Consolidated Non-Teaching Tools Allowance to reduce salary wahala and settle long-standing agitation. But SSANU NEC reject di offer, tuk say […]

todayApril 20, 2026 9

National

Fintiri Launch Big Campaign Movement For President Tinubu

By: Esther Ayoola Adamawa state govo, Ahmadu Fintiri don launch one movement to campaign for di re-election of Bola Tinubu for 2027 inside Adamawa State. Im yarn dis one on Saturday for APC congress wey hapun for Mahmud Ribadu Square for Yola. Fintiri announce one group wey dem call Adamawa Renewed Hope Movement, wey go get plenty gornment pipo and ward councillors as members. Im sti promise say dem go build strong structure from ward level reach state level, and […]

todayApril 20, 2026 6

National

Benue Hail Security As Dem Rescue Kidnap Victims For Benue Road

By: Esther Ayoola Benue state Govo, Hyacinth Iormem Alia don praise security agencies as dem successfully rescue passengers wey kidnappers carry from Benue Links bus for Makurdi–Otukpo road. Di governor tuk dis one on Sunday, when e receive di freed victims for Old Banquet Hall inside Government House for Makurdi. E thank di Commissioner of Police and other security operatives for dia strong effort wey make di rescue possible. Alia sti promise say im gornment go continue to fight insecurity […]

todayApril 20, 2026 7

National

NYSC DG Explain How Dem Wan Take Protect Corpers Nationwide

By: Esther Ayoola NYSC oga, Brigadier-General Olakunle Nafiu, don tuk say dem dey put more effort to protect corpers for all over Naija. E yarn dis one for interview wey e get with news pipo for Abuja, as pipo dey worry about security, kidnapping and corpers welfare. E sti explain say security na general problem for di country, and NYSC dey depend on security agencies to provide correct information and protection.

todayApril 20, 2026 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds