Blog masonry

Background

Sports

Fredrick Go Miss AFCON 2025 Due To Injury

Super Eagles defender Benjamin Fredrick don set to miss 2025 Africa Cup of Nations with knee injury, according to reports. Di young star knack di injury during training for Belgian Pro League club Dender last week Friday. Di 20-year-old wey impress for im debut against Reggae Boys of Jamaica in May don become key player for Eric Chelle, starting di Super Eagles last six games. Di versatile defender even miss Dender’s 2-1 win over Royal Antwerp last weekend. Reports show […]

todayNovember 26, 2025 6

National

Why We Still No Dey Open Our Business For Mondays — South-East People

Despite better security for South-East after years of insecurity, some commercial cities still no dey open business on Mondays; shops remain locked, and even wey dem open, activity dey very scanty. Banks sef no dey operate for Monday. Places like Aba, Okigwe, Onitsha, Nnewi and other growing urban centres still dey slow on Mondays, with some reluctantly opening from 12 noon. But for capital cities, full commercial and social activities dey go on. Residents yarn say communities wey recent dey […]

todayNovember 26, 2025 3

National

NDLEA Don Seize ₦6.7bn Worth of Tramadol, Codeine From Lagos Warehouse

Operatives of di National Drug Law Enforcement Agency (NDLEA) don clamp down on one big opioid cartel as dem recover illicit drugs wey worth over ₦6.7bn from dia secret warehouse inside one residential estate for Lagos State. According to statement wey Director of Media & Advocacy, NDLEA, Femi Babafemi, drop for Abuja on Wednesday, di bust happen as dem arrest suspected drug baron, Onyekachi Pius Nwanagu, plus five members of him gang with di hard drugs. Babafemi talk say NDLEA […]

todayNovember 26, 2025 3

International

UK Man Don Change Plea, Admit Say Na Im Drive Into Liverpool FC Parade

One British man, Paul Doyle, don change him plea on Wednesday and admit say e deliberately drive him car into crowd wey dey for Liverpool FC Premier League victory parade for May, as court case take dramatic twist. Doyle first deny 31 charges wey include causing grievous bodily harm with intent, wounding with intent, affray and dangerous driving for di May 26 incident wey injure dozens, including infants and children. On di second day of him trial, Doyle wey wear […]

todayNovember 26, 2025 4

International

Floods For Thailand, Malaysia Kill Over 30, Scatter Thousands

Di death toll for days of heavy flooding wey don scatter southern Thailand don rise to 33, as tens of thousands for Thailand and Malaysia dey displaced, according to officials. Di Thai government don declare state of emergency for Songkhla after torrential rains since last week flood Hat Yai and di entire southern region. AFP photos show how murky brown water don swallow streets and ground floors for residential buildings. Government spokesman Siripong Angkasakulkiat yarn say people die across seven […]

todayNovember 26, 2025 4

International

EU Go Support Ukraine ‘Every Step Of Di Way’ Until Peace Show

Di President of di European Commission, Ursula von der Leyen, don vow say Europe go stand gidigba with Ukraine and support dem every step of di way until dem achieve “just and lasting peace”. She tell EU lawmakers on Wednesday say di revised US plan to end di war fit be “starting point”, even as Europe dey scramble to boost Ukraine and counter US proposal wey many see as tilted toward Russia demands. Von der Leyen talk say days of […]

todayNovember 26, 2025 4

National

Bandits: Govt No Rescue Schoolgirls, Na Negotiation Dem Do

A new video don surface show say Nigerian government and di bandits wey kidnap di Kebbi schoolgirls negotiate and reach agreement before dem release di girls. Dis video contradict government claim say no ransom enter as dem free di students of Government Girls Secondary School, Maga, Kebbi State, on Tuesday. For di clip wey @AM_Saleeem share for X, one armed bandit dey question di girls about military jets wey fly above di forest during dia captivity, as di girls talk […]

todayNovember 26, 2025 5

National

How To Collect Your Pension Before You Retire

Under di National Pension Commission (PenCom) rules for Contributory Pension Scheme, Nigerian workers fit access part of dia retirement savings while dem still dey work, but e get conditions. Both employer and employee dey contribute monthly to Retirement Savings Account (RSA), and normally di savings dey for pension income at retirement. But if worker lose him job and no get another one for at least four months, e fit withdraw up to 25% of him RSA balance, provided e show […]

todayNovember 26, 2025 3

National

Abducted Kebbi Schoolgirls Release No Be Victory – Atiku

Former Vice President Atiku Abubakar don criticise di Federal Government over di release of abducted schoolgirls for Kebbi State, yan say di girls freedom no suppose be achievement but show how Nigeria security don worsen. Atiku talk say di return of di schoolgirls no be “trophy moment” but na reminder say terrorists dey operate freely, dey negotiate openly, and dey dictate terms while government dey issue press statements to save face. Di statement na response to Presidential Special Adviser on […]

todayNovember 26, 2025 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app