Blog masonry

Background

Lagos

Lagos: Customs, NDLEA Stop Big Drug Smuggling For Apapa Port

By: Esther Ayoola Di Nigeria Customs Service (NCS) join bodi with NDLEA don stop major drug smuggling afta dem seize 347.5kg of Canadian Loud cannabis For Apapa Port, Lagos. Custom tuk, tuk, CSC Isah Sulaiman, ni tuk for statement on Friday say di drugs, dem bin hide am inside Toyota Sienna, wia custom take block am Sulaiman explain say di cannabis dey packed inside 13 bags, and dem bin hide am four di motor. Afta thorough weighing, dem find ten […]

todayJanuary 30, 2026 7

Lagos

LAWMA Beg Lagos Resident To Stop Attack On LAWMA Officers

By: Esther Ayoola Di Lagos waste Management Authority don warn resident make dem try stop di bad habit of attacking and harrassing officers wey dey enforce waste management laws across di state. Untop yanings with newsmen, Oga Managing Director, Dr Muyiwa Gbadegesin, say officers wey dey try protect public health, enforce sanitation rules and keep Lagos clean, suppose get beta public support and not gbasgbose. Gbadegesin press tuks dat, all enforcement work dey backed by Lagos State Environmental Management and […]

todayJanuary 30, 2026 6

Sports

Alcaraz Beat Zverev For Epic Battle, Reach Him First Australian Open Final

By: Esther Ayoola For Melbourne, Australia, world number one Carlos Alcaraz don ruffle Alexander Zverev feathers on Friday to reach im first Australian Open final, wining di battle wey enter 5 ogbonge  sets, 6-4, 7-6, 6-7, 6-7, 7-5 afta 5 hours 27 minutes for hot conditions. Alcaraz nearly chop defeat for third set, at 4-4 when e overcome pain, to fight till di end. With dis win, Alcaraz move within one match to become youngest man to complete career Grand […]

todayJanuary 30, 2026 4

Sports

Anthony Joshua Finally Tuk Afta Di Askident Wey Kpai Im Two Frens

By: Esther Ayoola Anthony Joshua don finally tuk afta weeks of silence, as he appear for camera first time since di fatal car crash. U sabi say, Joshua bin dey inside SUV wey crash with parked truck for Lagos–Ibadan expressway on December 29. For video wey im post for YouTube, tears almost drop as he mourn Latif Ayodele and Sina Ghami, two of him close backroom guys wey he call dey brothers.

todayJanuary 30, 2026 10

Sports

Sabalenka And Rybakina Clash For Australian Open Glory

By: Esther Ayoola Unto Australia open 2026, say Aryna Sabalenka don buy waka to face Elena Rybakina for di ogbonge final, afta di world number one beat Elina Svitolina 6-2, 6-3. Sabalenka win afta her small struggle for di fourth game of di match. Rybakina self beat American Jessica Pegula 6-3, 7-6 (9-7), just to try, revenge her 2023 final loss to Sabalenka.

todayJanuary 30, 2026 5

obodo oyinbo

Colombia Lawmaker, 14 Others Kpai For Plane Crash Near Venezuela Border

By: Esther Ayoola Nor be small gbege for America, say, one Plane, wey dey bin dey fly from Cúcuta to Ocaña for Colombia don go crash for mountain near Venezuela border, kill all 15 people wey dey onboard, including lawmaker Diógenes Quintero. Di state‑owned airline Satena ni konfamate dat, di small plane lose contact with air traffic control before e hit ground and  no bodi survive di crash. According to report Gornment and rescue teams dey recover di bodi dem […]

todayJanuary 30, 2026 4

obodo oyinbo

Trump Tell Putin To Stop Firing Kyiv For Di Next 7 Days

By: Esther Ayoola Ukraine Presido, Volodymyr Zelenskyy, nor bi small happiness for am yesterday, say Donald Trump tell Russia to stop attack on Kyiv and some other towns for seven days. Zelenskyy tuk say, im support Trump and dat, e go hellep protect pipo during di cold winter. Dis pause for bombing dey come afta di leaders  tuks for United Arab Emirates, say, di next tin na to reach peace agreement fully. Trump bin tuk say Vladimir Putin, agree to […]

todayJanuary 30, 2026 4

National

NAFDAC Start Di Ban Of Sachet Alcohol To Protect Pikin, Youths

By: Esther Ayoola Di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) don begin enforcement of ban to stop pipo from di production and selling of alcohol inside sachet or small bottle wey less than 200ml. Inside statement on Thursday, di Director-General NAFDAC, Prof. Mojisola Adeyeye, explain oh, dat, dem no close any alcohol company, dem just wan protect pikin, youths, and young adults from di wahala of Alcohol. According to her, small sachet alcohol dey cheap, easy […]

todayJanuary 30, 2026 19 3

National

DSS Share Victims Complain About Tukur Mamu For Court

By: Esther Ayoola One investigator for DSS don go report for Federal High Court, Abuja say some victims complain about Tukur Mamu, wey dey involved for terrorism negotiation, dey align with wetin dey with di DSS. Di DSS witness na sixth person wey dey give evidence for Mamu terrorism trial. During cross-examination, Mamu lawyer, Johnson Usman, ask whether any rescued victim, including wife of NDA Commandant, don complain about Mamu. Di witness Konfam say na true, some victims don complain […]

todayJanuary 30, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app