Blog masonry

Background

Lagos

Immigration Boss Suspend Lagos-Seme Border Commanders Say Dem Do Yahoo

By: Esther Ayoola Di Comptroller-General of Nigeria Immigration Service, Kemi Nandap, don shake table remove di commanding officers for Lagos-Seme border corridor, afta online report say di officers do extortion. She tuk say di action na to allow proper investigation and to make sure say all officers wey involve go face disciplinary action. According to NIS tuk, tuk on Friday, Akinsola Akinlabi, di service condemn di alleged bad conduct, say e dey against dia ethics and operational standards. Di suspension […]

todayApril 10, 2026 13

Sports

Barca Face Espanyol Derby Wahala Ahead Atletico Return Leg

By: Esther Ayoola Barcelona coach Hansi Flick like dis dey face serious decision ahead of dia La Liga derby against Espanyol for Saturday, afta dem lose 2-0 to Atletico Madrid for Champions League quarter-final first leg. Flick tuk say, dem go analyse all options because di match na very important match. Barcelona sti dey top La Liga with seven points ahead Real Madrid, but di gap fit reduce if Madrid win Girona match on Friday. Di situation dey hapun one […]

todayApril 10, 2026 12

obodo oyinbo

Germany Open Scholarship for African Graduates

By: Esther Ayoola Germany don open application for one scholarship programme wey dey target graduates and postgraduates from Sub-Saharan Africa, to give dem chance for further study and research abroad. Dem announce am for dia X handle on Friday, tuk say na part of their plan to support international academic cooperation. Dem say DAAD scholarship don ready now and make interested people check di flier for full details and apply before deadline wey be 29 April 2026. Dem sti advise […]

todayApril 10, 2026 9

Sports

AFCON Final Ref Miss Out As FIFA Pick World Cup Referees

By: Esther Ayoola FIFA don release list of referees wey go handle di 2026 FIFA World Cup 2026, wey go hapun for USA, Canada and Mexico with 48 teams. From Africa side, countries like Algeria, Egypt, South Africa, Morocco, Gabon, Angola, Somalia and others get officials wey FIFA pick. But big name referee like Congolese Jean-Jacques Ndala Jean-Jacques Ndala, plus Issa Sy and Boubou Traoré no make di final list.

todayApril 10, 2026 20

Sports

Super Falcons Cry Out As NFF Fail To Arrange Friendly Matches Ahead WAFCON

By: Esther Ayoola Super Falcons captain Rasheedat Ajibade and goalkeeper Chiamaka Nnadozie don voice dia frustration say di team nor get any friendly matches to play for dis international play. Dis FIFA women international window start on April 7 go reach April 18, wey suppose allow teams play at least three friendly games. But Naija Football Federation never sti announce any match for di Naija women's national football team, and normally say dem suppose to dey prepare for di WAFCON […]

todayApril 10, 2026 18

Sports

Fury Tell Joshua To Forget Wilder Fight

By: Esther Ayoola Tyson Fury don tell Anthony Joshua say make im forget Deontay Wilder and focus on fight wey dem fit do next if he win Arslanbek Makhmudov on Saturday. Fury go come back from im 16 months break to fight Makhmudov for Tottenham Hotspur Stadium. Di British boxer dey push Joshua make e no go pick any interim fight, but instead make e face am direct. Meanwhile, Deontay Wilder don already show face afta Joshua last win, dey […]

todayApril 10, 2026 10

obodo oyinbo

Melania Trump Deny Report Say She Nor Get Link With Epstein

By: Esther Ayoola For White House on Thursday, first lady, Melania Trump don address reporters how she nor get any connection with Jeffrey Epstein, di widespread sex trafficking network. She say make all those claims stop because dem dey spoil her name. She explain say na only once she “cross path” with Epstein around year 2000, and say di rumor dat she introduce Epstein to Donald Trump no be true, as e dey try defame her reputation.

todayApril 10, 2026 9

obodo oyinbo

Trump Call Out Iran Say Dem Need To Do More For Di Strait Hormuz

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump say like dis Iran dey do “very poor job” for how dem dey handle oil wey dey pass through di Strait of Hormuz. Im tuk dis one for public statement, say Iran nor dey match di agreement wey dem agree. Even though say oil don dey pass di Strait of Hormuz, say di ceasefire agreement never show full workings.

todayApril 10, 2026 11

National

World Bank Report Say Naija Poverty Now Na 63%

By: Esther Ayoola World Bank don share update, say poverty dey press Naija for neck, dat e don rise enter 63% for 2025, not minding say inflation slow down small. Dem show for dia Naija Development Update say, poverty move from 56% for 2023, enter 61% for 2024, then reach 63% for 2025. Dis one mean say economic stabilizing nor be for di poor for Nigerians. In all, about 140 million Nigerians sti dey live under poverty line.

todayApril 10, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds