Blog masonry

Background

OBODO NAIJA

Presidency Fire Back As Donald Duke Criticise Lagos-Calabar Highway

By: Olabisi Olatunji Presido don reply Donald Duke after him question di N15 trillion Lagos-Calabar Coastal Highway project. Presidential aide Temitope Ajayi tok on Wednesday say di project remain important despite di criticism. Donald Duke, during Arise TV interview on Tuesday, argue say di money fit solve problems for oda sectors instead. Duke also claim say di highway no go pass Epe and say road already connect Lagos to Calabar.

todayAugust 5, 2026 22

OBODO NAIJA

WAEC Withhold 167,486 WASSCE Results Over Exam Malpractice

By: Olabisi Olatunji WAEC don withhold 167,486 results of candidates wey write di 2026 WASSCE over alleged examination malpractice. WAEC Nigeria Head, Dr Amos Dangut, announce di release of di results on Wednesday for Lagos. According to am, use of mobile phones and organised cheating for some schools cause di affected results. Di withheld results represent 8.59 percent of candidates, lower than di 9.7 percent recorded for 2025.

todayAugust 5, 2026 18

Education

Ekiti First Lady Say Sexual Harassment for Higher Institutions No Go Pass Just Like Dat

By: Esther Daniel Di Wife of Ekiti State Gofnor, Dr. Olayemi Oyebanji, today for Ado-Ekiti vow say sexual harassment for tertiary institutions no go go unpunished, as she talk during meeting with FUOYE management led by Vice-Chancellor Prof. Joshua Ogunwole, because she wan protect students and stop di crime from happening again. She also announce say she go organise statewide gender summit and visit higher institutions across Ekiti to educate students, lecturers and other stakeholders on gender rights and di […]

todayAugust 5, 2026 23

obodo oyinbo

Ontario Open New PR Route For Foreign Workers

By: Olabisi Olatunji Ontario for Canada don open new permanent residence pathway for eligible foreign workers. Qualified applicants fit apply from August 4, 2026, with valid job offer. Di programme get three pathways for skilled workers, lower-skilled workers and doctors. Applicants must register through di OINP Employer Portal.

todayAugust 5, 2026 14

Politics

Mimiko Calls for More Powers for States to Fix Nigeria

By: Esther Daniel Former Ondo State Gofnor, Olusegun Mimiko, don call for more powers to be given to states and local gornments, im say too much power for the Federal Gornment don cause many of Nigeria’s govrnance problems. Mimiko make di statement during di RCCG 74th Annual Convention, where e use di biblical "Jethro Principle" to explain say good leadership dey work better wen responsibilities dey shared among capable leaders. According to am, true federalism go make each state fit […]

todayAugust 5, 2026 18

OBODO NAIJA

Businessman Say Him Pay Fake PFIPC DG ₦400 Million

By: Olabisi Olatunji Managing Director of Divine Dopacy Nigeria Limited, Gbenga Collins, don tell House of Representatives committee say him pay ₦400 million to Adeniyi Adeyemi after promise of contract. Collins tok dis one on Tuesday as lawmakers dey investigate di alleged operations of di Presidential Foreign Investment Promotion Council. According to am, him believe say di agency na real because Adeyemi dey use Federal Secretariat office for Abuja, security officers and gornment vehicles. Di investigation dey continue to uncover […]

todayAugust 5, 2026 7

Sports

Arsenal Players Believe Vinicius Jr Transfer Don Near

By: Esther Daniel Reports from Spain claim say Arsenal dressing room don believe Real Madrid star Vinicius Junior fit soon join di Gunners. According to AS, Arsenal players don begin ask questions about di possible transfer after sporting director Andrea Berta reportedly show say di club serious to sign di Brazilian. Manager Mikel Arteta also don reportedly discuss wit Vinicius about d i role wey e go play if e join Arsenal. However, Vinicius never decide whether e go leave […]

todayAugust 5, 2026 14

OBODO NAIJA

Three People Kpai as Crane Jam Truck for Sagamu-Benin Expressway

By: Esther Daniel Three pipo kpai and three others sustain wujuries after one crane collide with one truck for Sagamu-Benin Expressway, Ogun State, on Wednesday morning. Traffic Compliance and Enforcement Agency for Ogun State, TRACE, tuk, tuk person, Babatunde Akinbiyi, tok say di crane dey drive against traffic at high speed before di crash happen. Rescue teams from TRACE, FRSC and Police carry di wujured go Babcock University Teaching Hospital for treatment. Di bodies of di dead victims don reach […]

todayAugust 5, 2026 19

Uncategorized

Osun Gornment Drag EFCC Go Court Over Frozen Bank Accounts

By: Esther Daniel Osun State Gornment don drag EFCC go Federal High Court after di anti-graft agency freeze gornment bank accounts, as Gofnor Ademola Adeleke order legal action on Wednesday to challenge di move. Osun Attorney General and Commissioner for Justice, Oluwole Jimi-Bada, tok say EFCC issue "Post No Debit" directive to First Bank, where several gornment accounts dey, without getting court order first. Jimi-Bada explain say although EFCC fit investigate financial transactions, di agency no get power to freeze […]

todayAugust 5, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds