Blog masonry

Background

obodo oyinbo

Magyar Win Hungary Election, Become New Prime Minister

For Hungary inside Budapest on Sunday night, election result show say Péter Magyar and im Tisza party win big landslide say pipo vote against corruption and old gornment rule. Dat di country vote with high turnout of about 79%, say dem use ballot box choose change, reject di long rule of Viktor Orbán and im Fidesz party. Magyar now dey warm up to take over as di new prime minister of Hungary

todayApril 13, 2026 10

obodo oyinbo

Trump Order US Navy To Block Strait Of Hormuz Say Iran Nor Wan Respect Demselves

US Presido, Donald Trump like dis don order US Navy say make dem block Strait of Hormuz because Iran say dem nor go stop dia nuclear program. Trump tuk for im truth social say even though, dem get small peace agreement for Islamabad with Iran, im nor go spare anybody wey go attack US property. Di US Presido warn say any Iranian wey go try attack US or other ships go face serious military response. Dis one dey come afta […]

todayApril 13, 2026 17

National

Tax Reform Team Say Oyedele Nor Make Any Error For Di Reform

Presidential Fiscal Policy and Tax Reforms Committee don deny report wey tuk say Minister of State for Finance Taiwo Oyedele admit say new tax law get error. Dem tuk say, di news misrepresent wetin di minister actually tuk during fireside chat for Nigerian Bar Association Section on Legal Practice conference for Lagos. Dem sti clear say e no tell pipo make dem dey wait for any legislative probe, as certified and gazetted copies of di law, dem don already publish […]

todayApril 13, 2026 10

National

NAF Launch Probe Over Air Strike Wey Allegedly Hit Borno Market

Nigerian Air Force don start investigation over report say dia air strike wey hapun on April 11, 2026, hit market for Jilli, Borno State, wey cause civilian wujuries. Dem say, dem dey take any report of civilian harm serious, and dem no wan joke with protection of innocent pipo. As part of di mata, di Chief of Air Staff, Air Marshal Sunday Kelvin Aneke, don order Civilian Harm Accident and Investigation Cell make dem go di area go find out […]

todayApril 13, 2026 12

National

Governor Zulum Tell Borno Residents To Stop Supporting Boko Haram

By: Esther Ayoola Borno State Governor, Babagana Zulum don warn residents make dem no support, hide or supply Boko Haram insurgents anything. Air Component of Joint Task Force (North East), Operation Hadin Kai, carry out operation for Jilli area for Gubio LGA on Saturday. Jilli na border community wey dey between Gubio Local Gornment Area for Borno State and Geidam Local Government Area for Yobe State. For statement wey di govo aide, Dauda Iliya release, dem say Jilli market na […]

todayApril 13, 2026 10

National

INEC Clear Air, Deny Report Wey Say Amupitan Dey Support APC

Independent National Electoral Commission don deny report say, dem nor copy post any press statement from a Special Assistant to President Bola Tinubu on New Media, Dada Olusegun, describing di report fake and misleading. According to statement wey INEC secretary, Adedayo Oketola sign, di mata dat INEC Chairmo, Joash Amupitan, repost All progressive congress post for X na fake rumour. Say di allegation post wey go viral for X say na bad belle pipo wan spoil INEC chairmo name. INEC […]

todayApril 13, 2026 12

south west

FG Put Beta Investment For Health Launch Ogbonge Project For Ogun

By: Esther Ayoola Federal Gornment don declare say dem go continue to push beta policies and strong regulation to grow Naija pharmaceutical industry. Minister of State for Health, Dr. Adekunle Salako, naim tuk dis one during di commissioning of new ultra-modern factory for SAM Pharmaceuticals Limited for Sango-Ota, Ogun State. Salako say di pharma sector get key role for Naija economy and also for making sure say medicine dey available and secure.

todayApril 13, 2026 9

south west

Yewa Pipo Celebrate former IGP Kayode Egbetokun Afta Retirement

By: Esther Ayoola   Ogun west senator, Solomon Adeola, alongside oda senior mens for Ogun state don give dia honour to whom honour is due, dat di pipo of Yewaland dey proud of wetin Kayode Egbetokun achieve as IGP. Adeola, wey dem sabi as Yayi, run dis package for one event wey YPDC and Yewa Traditional Council organise. Di tin be say di senior man wey dem honour sef dey ground wey all dis dey hapun, and Egbetokun dey very […]

todayApril 13, 2026 10

Lagos

South West Commissioners Gather For Lagos, Plan New Way To Solve Housing Palava

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment Commissioner for Physical Planning and Urban Development, Dr. Oluyinka Olumide, don host im first meeting of South West commissioners for physical planning for Alausa, Ikeja. Commissioners from Lagos, Ogun, Oyo, Osun, Ekiti and Ondo all join hand with DAWN Commission and South West Development Commission tuk how dem go take build strong regional integration and beta urban development. Dem press tuk say di South West dey face issues like housing shortage, transport wahala, infrastructure […]

todayApril 13, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds