Blog masonry

Background

National

Soludo Shut Onitsha Market One Week Over Sit-at-Home

By: Esther Ayoola Anambra State Govo, Professor Chukwuma Soludo, for Onitsha on Monday don order im mehn to lose Onitsha Main Market for one week say traders no follow state gornment order to ignore Monday sit-at-home. Soludo give di directive during on-site visit to the market as e move with aides and other government officials. He warn say dem fit extend the closure if traders still refuse to comply, as security agencies don seal di market to enforce di order. […]

todayJanuary 26, 2026 13

Lagos

Police, PSC Extend Recruitment Say Mehn Nor Dey Turn Up

By: Esther Ayoola Di Police Service Commission (PSC) and Nigeria Police Force for Nigeria don extend dia recruitment programme of 50,000 police constables, say dem don add two weeks based on some states, including Lagos, dey record low application. PSC Head of Protocol and Public Affairs, Torty Kalu, tuk dis one on Monday, say extension dey follow receipt of over 400,000 applications nationwide and uneven participation across states. Di online application wey open on December 15, 2025, wey suppose close […]

todayJanuary 26, 2026 9

National

Governor Adeleke Drop Report Card, Say Former Govo Dey Block Progress

By: Esther Ayoola Osun state govo, Ademola Adeleke don show report card on why Osun state local gorment council never truly see beta change, wey dem desire, say na former gorment ni dey frustrate dem Di Govo yarn dis one for TV sit don tuk on Monday, giving report of di state of things for Osun ahead of di Osun state governorship election Im say All progressives’ councillors for di state even threaten for social media say dem go continue […]

todayJanuary 26, 2026 5

National

First Lady Tell Nigerians To Protect Environment

By: Esther Ayoola First Lady, Senator Oluremi Tinubu, for Abuja on Monday, don wire wire message to every Nigerians, say  make wi try our best to protect our environment and keep everywhere clean. She tuk dis one  as dem di world dey mark International Day of Clean Energy 2026, with theme “Clean Energy for People and Planet.” Senator Oluremi explain say make everybody dey use renewable energy and sustainable technologies because na di only way to preserve environment and healthy […]

todayJanuary 26, 2026 6 1

National

Naija Health Workers Blame Gorment For Strike

By: Esther Ayoola Di Joint Health Sector Union (JOHESU) for Naija don tell Nigerians on Monday make dem hold Federal Gornment responsible ugly health wahala for di country on why health workers strike JOHESU explain say dia main demand, say na implementation of report on adjustment of Consolidated Health Salary Structure (CONHESS) to improve health workers’ pay. National Secretary, Martin Egbanubi, yarn for one Media sitdon tuk tuk say dem don already tell gorment wetin dem want and dat na […]

todayJanuary 26, 2026 4

obodo oyinbo

China, India Settle Dia Fight For Trade Tuks

By: Esther Ayoola China presido, Xi Jinping don declare dat  China and India na  good neighbours and friends wey suppose to run marras together. Oga Jinpoing dey uyan dis one, as di two of both of dem dey try  fix dia  relationship after plenty  Trump tariff  wahala wey hit dem. Xi send Republic Day greeting to Indian president Droupadi Murmu, say relationship between both countries don  dey get head small small again and e good for world peace and progress. […]

todayJanuary 26, 2026 9

Sports

Former Man United Midfilder Keane Says Carrick Nor Be Di Right Man For United

By: Esther Ayoola Former -Man United midfielder Roy Keane  say United don improve  but Micheal Carrick nor be di man for di job after im beat Arsenal 3-2 for Emirates. Ontop yanings for post match conference, Keane  say anybody fit win two games, and even if United win all dia matches till season end, e ma nor go still  give Carrick di job. E say United need bigger and better manager wey fit handle di club size and help dem […]

todayJanuary 26, 2026 7

Sports

Naija Athletes To Jim Bodi For Scotland Four Weeks Before Commonwealth Games

By: Esther Ayoola Naija athletes go camp for Scotland for four-weeks todo jim jim di body before 2026 Commonwealth Games For Glasgow. National Sports Commission Director-General, Bukola Olopade, ni dey konfamate dis infomate, say dem pick Aberdeen to make things easy and reduce wahala of travel. E say early arrival go hellep athletes adjust well and sabi how di conditions go be once di competition start. Team Naija go reach Aberdeen four weeks before di games for training, preparation, and […]

todayJanuary 26, 2026 10 9

obodo oyinbo

UN Convoy Don Reach Kobane, Bring Food And Fuel

By: Esther Ayoola Say United Nation, UN, Office for di Coordination of Humanitarian Affairs (OCHA) Don konfamat dat,  UN convoy don reach Kobane for north Syria to hellep save lives for wia Syrian army and the Kurdish-led Syrian Democratic Forces (SDF) bin fight as ceasefire tuk continues. Di humanitarian pipo say, dem bring 24 trucks wey get fuel, bread, and ready-to-eat food for pipo wey dey suffer because of di unrest for north Syria. U sabi say, Residents bin complain […]

todayJanuary 26, 2026 13 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app