Blog masonry

Background

Sports

Carragher Explain How Liverpool Go Take Replace Salah

By: Esther Ayoola Liverpool legend Jamie Carragher don scatta table again oh, say di club nor go get problem replacing Mohamed Salah wen Salah go comot by di end of 2025/26 season. E tuk dis tuk for Liverpool website say plenty great players bin play for Anfield before Salah. E explain say nobody dey for football, wey dem nor fit replace, even though say im na goal scorer. Carragher believe say Liverpool go still fit scout new player to continue […]

todayApril 7, 2026 14

Sports

CAF Presido, Motsepe Dey Enter Dakar AFCON 2025 Settlement

By: Esther Ayoola CAF Presido, Patrice Motsepe, according to Kenyan media Tuko, dey plan enter Dakar, Senegal on Tuesday following Senegal 2025 AFCON gbege. CAF Appeals Board give Morocco 3-0 win because Senegal comot for pitch to protest during di final. Senegal Football Federation say dem nor go gree and don carry di mata go Court of Arbitration of Sports for Laussane, wey fit take 12 months to settle. Say Motsepe dey make di move to see how dem fit […]

todayApril 7, 2026 11

Sports

Barcelona Eye Victor Osimhen As Atlético Hold Julián Álvarez Tight

By: Esther Ayoola Barcelona don start dey look Victor Osimhen as pa say Atlético wan stress dem for Julián Álvarez deal. According to transfer experts, dem bin first want Álvarez for dis summer transfer window, but Atlético dey hold dia player kakaraka. Now, Barcelona dey reason both Álvarez and Osimhen as possible way dem fit replace veteran forward Robert Lewandowski. Álvarez dey cost around €200m, wey fit make am one of di most expensive transfer, just small behind Neymar wey […]

todayApril 7, 2026 12

obodo oyinbo

10 Pipo Kpai For Gaza As Hamas Clash With Israel-Backed Militia

By: Esther Ayoola At least, ten pipo don kpai for Gaza, afta Israeli air strikes and fight between Hamas and Israel-backed militia. According to local hospital source, di fight hapun Monday, near Maghazi refugee camp, when Hamas pipo attack militia wey go do checkpoint for dia area. Al-Aqsa hospital for Deir al-Balah naim receive di bodies, and many other pipo wunjur, some dey critical condition. Local witnesses tuk say di clash start because of tension between Hamas and militia, but […]

todayApril 7, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Give Iran Deadline, Make Deal Or Risk ‘One Night’ Strike

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump don drop some micro soft words for White House on Monday say e fit finish Iran “for one night” if dem no make deal before im deadline. Say di deadline na 8pm Washington DC time on Tuesday (12am GMT Wednesday). Addressing state media, Trump say e believe some reasonable leaders for Iran dey negotiate for “good faith,” but e no sure how di mata go end. E say di reason na to make […]

todayApril 7, 2026 11

Lagos

Tinubu Set To Open Ojota-Opebi Bridge, Other Big Projects For Lagos

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu, wan visit Lagos dis week to commission some big projects, including di Ojota-Opebi link bridge. Governor Babajide Sanwo-Olu through im media aide naim dey announce dis update, say baba Seyi go commission Ojota-Opebi link bridge and other projects. Di Govo aide sti say, oga presido go visit different projects for Ojota, Opebi, Alausa, Ajegunle and Abijo, as part of di working visit. Say di two-day visit go start Wednesday, April 8, […]

todayApril 7, 2026 17

Lagos

LASTMA Deploy 500 Officers For Lagos Roads Ahead Of President Tinubu Visit

By: Esther Ayoola Lagos state Gornment don deploy 500 extra LASTMA officers for key roads and project corridors for Lagos ahead of President Tinubu visit. Oga General Manager of LASTMA, Olalekan Bakare, naim dey yarn on Monday during press briefing. Say, di officers go manage vehicles for major highways and routes wey relate to President itinerary, and dem go dey stationed for strategic areas throughout di visit. Bakare-Oki explain say di deployment na part of coordinated plan with federal and […]

todayApril 7, 2026 15

Lagos

Sanwo-Olu Free 43 Inmates As Lagos Dey Fight Overcrowding For Prisons

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don approve di release of 43 inmates from correctional centres across Lagos State on Monday, to hellep reduce overcrowding. Attorney-General and Commissioner for Justice, Lawal Pedro, say di release sef don show Gornment commitment to justice, fairness, and proper rehabilitation for inmates. Di inmates wey sti get prison sentence normally,  say dem carefully check dia character according to legal and administrative rules, and before di release Pedro also tuk say Lagos dey […]

todayApril 7, 2026 15

Lagos

LASEMA Raise Alarm Afta Electrical Fire Hits Lagos Buildings

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency (LASEMA) don warn residents make dem dey careful with electrical things and report any emergency through di toll-free lines. Di warning follow two fire wahala wey hapun for different parts of Lagos on Sunday because of electrical surges. Head of Public Affairs, Afolabi Olawale, naim dey Konfam say, one fire happen for FESTAC Town Phase 2, where single-storey building catch fire afta conduct wire spark. E tuk say quick action by LASEMA […]

todayApril 7, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds