Blog masonry

Background

Sports

We Ready Die for Pitch, Ajibade for Egypt Game

By: Yusuf Abuh Super Falcons captain Rasheedat Ajibade tok say Nigeria players dey enter dia last group game with beta peper body for di WAFCON after dem beat Zambia and lose 3-2 to Malawi. Ajibade make di statement after Nigeria beat Zambia 1-0 for Morocco to keep dia title defence alive.   Skippo, say if Egypt, nor take dia time, dem nor go see body go house, cause na dis game dem fit get chance to qualify for dis years […]

todayAugust 5, 2026 19

obodo oyinbo

How Iran-Oman Hormuz Tuks Take Dey Give New Hope

By: Yusuf Abuh Finally e be like mehn mehn don give demselves brain oh, dat like dis now, Iran gornment don konfam say dia diplomatic tuks with Oman to reopen di Strait of Hormuz dey make brain. Even United States Secretary of State Marco Rubio konfam di progress for news and Treasury Secretary Scott Bessent con press tuks say agreement fit hapun today or tomorrow. Di tuks come after world leaders kneel down beg both US and Iran to borrow […]

todayAugust 5, 2026 10

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Open ₦178.12bn Kaduna–Birnin Gwari Road, Fulfil Campaign Promise

By: Yusuf Abuh Wi oga Presido Bola Tinubu don officially flag off di reconstruction of di 122-kilometre Kaduna–Birnin Gwari Road through Gofnor Uba Sani, say now wey im dey deliver im 2022 campaign promise, nobody dey tuk oh. Tinubu tok say na based on im coconut head im take package dis project, dat security pipo warn am about di Birnin Gwari, say kidnappers oh, im say no, my pipo dere now. Say na so im put call to di Federal […]

todayAugust 5, 2026 19

OBODO NAIJA

Police Konfam Say Dem Dey Touch Light AIG Moshood Jimoh for Corruption

By: Yusuf Abuh   Nigeria Police Force don open dia yamchop confess say, dem dey touchlight Assistant Inspector-General of Police for Zone 2, AIG Moshood Jimoh, to see whether senior man kahkah for church. You know wetin dey cause dis one, na social media activist Martins Otse, di one wey you sabi as VeryDarkMan naim go put dark accusate for di young man head say im dey corrupt. Police say no, dis case wey VeryDarkMan dey tuk waka enter rent […]

todayAugust 5, 2026 20

south west

Osun APC Blast Adeleke, Say Him Dey Find Excuse Before Election

By: Esther Daniel Osun State APC don fire back at Gofnor Ademola Adeleke, say all di allegation wey him make against Presido Bola Tinubu and Minister of Marine and Blue Economy, Adegboyega Oyetola, na empty talk and excuse before August 15 governorship election. For statement wey party Media Director Kola Olabisi release on Tuesday, APC tok say Adeleke claim say Tinubu and Oyetola dey persecute am politically no get head or tail. Di party dey react to wetin di Gofnor […]

todayAugust 4, 2026 17

obodo oyinbo

17 Migrants Die As Boat Drift 15 Days For Sea

By: Esther Daniel Two North African migrants don survive after dem spend about 15 days dey drift for Mediterranean Sea as dem dey try reach Spain Balearic Islands. Rescue team save dem early Tuesday morning about 13 nautical miles from Mallorca. Di two men dey battle dehydration and serious hunger, so rescue workers rush dem go hospital for treatment. According to wetin di survivors tell rescuers, na 19 pipo bin dey inside di boat when di journey start, but 17 […]

todayAugust 4, 2026 21

obodo oyinbo

Ukraine Strike Hit Three Wildberries Warehouses For Russia

By: Esther Daniel Ukraine don launch overnight attack on Monday wey hit two Wildberries warehouses, while anoda site wey dem believe say get link with Russia biggest online shopping company also suffer damage near Moscow. For di past few weeks, Ukraine don dey target Wildberries facilities, wey plenty pipo dey call "Russia Amazon," as part of dia attacks. Local officials tok say at least five pipo die and 10 oda pipo injure for one industrial site about 69 kilometres from […]

todayAugust 4, 2026 10

obodo oyinbo

Man Hide Mama Body Inside Freezer for Almost 3 Years, Land Jail

By: Esther Daniel Strange story don shock people as 60-year-old Christopher Phillips collect two years and four months jail term after e hide im mama body inside chest freezer for almost three years. Court hear say Phillips keep di body of im 89-year-old mother, Sylvia Phillips, for dia family house after she die for March 2023, while e continue to collect her pension and other benefits. Di man tell court say e no ready to let im mama go because […]

todayAugust 4, 2026 15

Sports

Nigerian Basketball Star Enter Trouble Over Rape Allegation

By: Esther Daniel Wahala don land as Nigerian basketball player Daniel Tobiloba Adegboyega don enter police hand for United States over alleged rape matter, and Jacksonville State don suspend am from dia team. Court papers show say di 21-year-old player dey for Calhoun County Jail as e dey wait for court hearing after police accuse am of forcing sexual act on one person. Di alleged incident reportedly happen on Wednesday, while immigration authorities also place hold on Adegboyega as investigation […]

todayAugust 4, 2026 19

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds