Blog masonry

Background

Lagos

Lagos New CP Tijani Show Report Card Say Command Gbab 47 Suspects

By: Rilwan Agbomeji Lagos State Commissioner of Police, CP Tijani Olayiwola Fatai, don show report card say di Command don arrest 47 suspects and recover guns, vehicles and other exhibits, Di police, yan dis one during a press briefing wey dem arrange for police headquarters for Ikeja for Lagos. Im say, dis update na from when he assume office, and na through intelligence- policing and support from residents dem take achieve di results. According to am, police carry out dis […]

todayApril 7, 2026 17

Sports

How Maguire Sign New Contract With Man Utd

By: Esther Ayoola Manchester United don renew contract of dia former captain Harry Maguire, so like dis im go dey Old Trafford for at least another season. Di 33-year-old England centre-back, wey join United from Leicester for £80 million back in 2019, sign new one-year deal with option to extend further. Maguire take to im social media, express im happiness, say di tin sweet am, dat Representing Manchester United na di ultimate honour.

todayApril 7, 2026 15

obodo oyinbo

UN To Vote On How To Open Hormuz Strait, Trump Give Iran Deadline

By: Esther Ayoola Say like dis UN Security Council go vote to address do mata of di middle east, on how dem go unblock di Strait of Hormuz. Say nobody go use force, even for defense, but di aim na to find solution. Dis vote go hapun few hours before Donald Trump 8:00 pm deadline for Iran to make deal or U.S go destroy im power plants and bridges. Bahrain, wey U.S and other Gulf oil countries dey support, naim […]

todayApril 7, 2026 13

National

Why Jos Youths Protest For Plateau Attack Victims

By: Esther Ayoola Say nor be small gbage, as Some youths for Jos North, Plateau State, block di burial ceremony of di Jos attack eviction wey bin dey sup for ECWA church. Wetin con cause di jogolo, dem say, security men arrest three boys wey allegedly bin dey defend di area from di jaguda boys wey come scatta area. Afta plenty protest, army release di three youths, and dem begin celebrate di news. Na only afta when dem release di […]

todayApril 7, 2026 12

National

Abuja Court Slam 20-Year Jail On Boko Haram Suspect

By: Esther Ayoola Justice Binta Nyako for Federal High Court, Abuja, don sentence some group for jaguda boys wey dem catch terrorism on Monday to jail, some dey get 10 years, some 20 years jail. Sharing di ogbonge update with tori pipo, DPP Rotimi Oyedepo tuk say one of dem, Hamatu Modu, na Boko Haram, wey dey supply di terrorist food. Defence lawyer Aliu Abubakar no fight di case, and Hamatu Modu gree say na true everything wey dem accuse […]

todayApril 7, 2026 16

National

Resident Doctors Suspend Strike As Gornment Promise To Pay Arrears

By: Esther Ayoola National Association of Resident Doctors (NARD) on Tuesday announce say dem don suspend dia planned strike afta dem meet with Federal Government of Naija for Abuja. NARD say, gornment don promise to pay outstanding salaries, hazard allowance, and improve doctors welfare, wey be di main reason why dem decide give dialogue another chance. Di suspension come afta emergency meeting of NARD National Executive Council, where dem review gornment assurances and see progress for negotiation. More go come […]

todayApril 7, 2026 13

National

Shettima Drop Assurance Again Say Naija No Go Fail

By: Esther Ayoola Vice Presido, Kashim Shettima don promise again oh say make Nigerians nor too worry body about security, say very soon all di gbege go be tins of di past. Oga Vice presido yarn dis one for di final day of di National Police Day parade for Abuja, saying dat reform plus unity go hellep push things forward. Shettima make am clear say everybody gat support police and other security pipo, say na cooperation dey make rice dey […]

todayApril 7, 2026 13

Lagos

Lagos Gorment Announce Road Diversion for Project Inauguration

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don announce say dem go close some main roads for parts of di state to allow commissioning of major projects on Wednesday and Thursday. Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, naim yarn dis one on Tuesday, say di temporary closures na for safety and to make sure di events run smoothly. On Wednesday, April 8, di Opebi-Mende Link Bridge go dey commissioned from 9 a.m. to 1 p.m., wey go affect traffic for Opebi-Allen, Ikeja, […]

todayApril 7, 2026 31

Lagos

Lagos Gorment Clear Mata Say Oga Presido Tinubu And Govo, Sanwo-Olu Nor Dey Fight

By: Esther Ayoola Di Lagos State Gornment don clear di air say, nor be true dat, Governor Babajide Sanwo-Olu and President Bola Tinubu dey fight. Di state Commissioner for Information, Gbenga Omotoso, yarn dis one, for one media sitdon tuk tuk on Tuesday, say all those gist na speculation. Omotoso tuk say, “How person go tuk say no future dey for him house? Di President sef be like father to Sanwo-Olu, so all those wahala tuk no get ground.”

todayApril 7, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds