Blog no sidebar

Background

Lagos

Lagos Court Jail Man 6 Months Say Im Sell Marijuana

By: Esther Ayoola A Federal High Court for Lagos don convict 35-year-old man, Deji Adesanya, dey sentence am to six months jail say im dey sell hard drugs, cannabis sativa, wey mehn dey call marijuana. Justice Akintayo Aluko give di sentence afta Adesanya confess by imself say im dey guilty for di one-count charge wey NDLEA carry come court. NDLEA tuk say dem catch am on November 22, 2025, for […]

todayJanuary 7, 2026 5

National

Police Confamate Release of Six Vigilantes Wey Army Arrest For Edo

By: Esther Ayoola Kwara State Police Command show workings confamate say dem don receive and later release six vigilante members wey Nigerian Army arrest earlier for Edo State. Police tuk say soldiers stop di vigilantes for Auchi–Ikpeshi Road for Akoko-Edo LGA for early December 2025 as dem dey travel inside motor wey belong to Ifelodun Local Government for Kwara State. According to police statement wey come out on Tuesday 6th […]

todayJanuary 7, 2026 12

National

Atiku No Go Step Down, Drag Tinubu

By: Esther Ayoola Former Vice Presido Atiku Abubakar don tuk say e no go step down for African Democratic Congress (ADC) presidential race. E still accuse President Bola Tinubu say dey try put hand for opposition matter. Atiku, through im media adviser Paul Ibe, call Nigerians make dem no allow All Progressives Congress (APC) scare or weaken opposition. Dis tuk come as people dey speculate say Atiku dey under pressure […]

todayJanuary 7, 2026 18

National

NiMET Share Update Say Haze, Sun And Thunder Go Hit Nigeria This Week

By: Esther Ayoola Di Nigerian Meteorological Agency (NiMet) don yarn say from Wednesday reach Friday, plenty haze and sunshine go dey across Nigeria. NiMet tuk dis on Tuesday for Abuja. For north, sky go dey sunny and hazy every day, while for south, sky go dey sunny with small clouds. NIMet also tuk say small chances of thunderstorm and light rain fit happen for Bayelsa, Rivers, Akwa Ibom, and Cross […]

todayJanuary 7, 2026 5

National

FG Sukili N1.98tn For Electricity Subsidy

By: Esther Ayoola Based on wetin di Nigerian Electricity Regulatory Commission (NERC) report tuk, di Federal Government don spend N1.98tn for electricity subsidy from October 2024 reach September 2025. For di fourth quarter of 2024, dem spend N471.69bn, first quarter of 2025 na N536.4bn, second quarter N514.35bn, and third quarter N458.75bn. NERC tuk say dis subsidy na because electricity tariffs never reach cost-reflective level, so gornment gatz cover di gap. […]

todayJanuary 7, 2026 4

Lagos

Lagos Taskforce Arrest 32 ‘Omotaku’ Weh Dey Block Roads

By: Esther Ayoola Lagos State Taskforce don arrest 32 street children wey dem dey call Omotaku, say dem dey cause wahala for area, dey block road across Island and Mainland, for areas like Apongbon, Fadeyi, Jibowu, Yaba, Lagos Island, Ojuelegba, and Surulere, According to Taskforce tuk, tuk yarnings on Tuesday, Raheem Gbadeyan, dem catch di children because dem dey stop trucks, tankers, and private cars anyhow, dey smoke hard drugs, […]

todayJanuary 7, 2026 15

Sports

NFF Calm Fear Say Fight Nor Dey Eagles AFCON Camp

By Ebi Oboko Nigeria Football Federation don play down tori say wahala dey for Super Eagles camp for 2025 AFCON for Morocco after small clash happen between Victor Osimhen and Ademola Lookman for pitch. The incident happen during Nigeria 4–0 win against Mozambique for Fez Stadium, as Osimhen score two goals while Lookman and Akor Adams add one goal each. Despite the big win, people notice when Osimhen and Lookman […]

todayJanuary 7, 2026 8 1

foreign

Saudi Coalition Fire Bomb for Yemen South

By Ebi Oboko Saudi Arabia-led coalition day never break, early mor mor confamate say, dem don fire bomb scarra Dhale, Yemen, on Wednesday. Say Southern Transitional Council (STC) leader Aidarous al-Zubaidi even jump comot plane wey im suppose use fly, use leg pick race for di mata, and dat up till now nobody know wia im enter. Coalition add say e don gather plenty soldiers, tanks, gun, and munitions for […]

todayJanuary 7, 2026 7 1

National

Jonathan Put Pledge to Join PDP Fight for 2027 Election

By Ebi Oboko Wi Former Presido, Goodluck Jonathan don knack hand for chest say e go dey more active for Peoples Democratic Party matter for 2027 election. Na PDP National Chairman, Tanimu Turaki (SAN) share dis update after private meeting with di  former presido on tuesday. Turaki waka go Jonathan Maitama office with all National Working Committee, some former governors, party founding fathers, and few selected state chairmo say dem […]

todayJanuary 7, 2026 20 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds