Blog no sidebar

Background

National

Atiku Pray For Anthony Joshua Afta Road Accident

By: Rilwan Agbomeji Former PDP presidential candidate, Atiku Abubakar, don send message of sympathy to British-Nigerian boxer Anthony Joshua afta road accident happen for Makun, Ogun State, on Monday. Atiku talk dis one through im official X handle, say e pain am well well and e dey pray make Joshua recover sharp sharp. According to am, Anthony Joshua still be symbol of strength and resilience, and e sure say e […]

todayDecember 29, 2025 11

National

Defence Minister Musa Explain Experience Say God Save Im Face

By: Esther Ayoola Defence Minister, Gen. Christopher Musa (rtd), don comout explain wetin im experience as military head, say people conspire against am and think say dem don win, but na God intervene and lift am up. E tuk dis one during church service for Conquerors Global Assembly for Abuja, where e go with im wife on Sunday. Musa explain say e decide share di testimony to thank God and […]

todayDecember 29, 2025 4

National

Resident Doctors Tell FG The Truth, Promise Fresh Strike

By: Esther Ayoola Naija resident doctors (NARD) don send SMS give wi federal gorment say dem go stop work if  FG never respect agreement wey dem sign. NARD secretary-general, Dr. Shuaibu Ibrahim, post urgent message for X on Sunday, beg senior doctors make dem hold first giving wi federal gorment 29 days from today. NARD tuk say na FG and ministry of health be di wahala, and if dem no […]

todayDecember 29, 2025 6

National

Peter Obi Ready Kaya To Join ADC

By: Esther Ayoola Presidential hopeful Peter Obi, according to report go soon officially join African Democratic Congress (ADC). According to one principal official of Labour Party for Abuja, ahead of 2027 general election, Obi go formally declare im move on December 31 for Enugu, wey be South-East political capital, after im supporters don start arrangement for di rally. According to di source, ADC ask Obi about three weeks ago make […]

todayDecember 29, 2025 7

obodo oyinbo

Russian Attack Wunjor Three For Kharkiv, Ukraine

By: Esther Ayoola Nor be small tin, say Russian send bomb to Sloviansk for eastern Ukraine kill at least one person dead and five others wunjor. According to Donetsk region military oga, di attack happen for area wey ukraine government still dey control for di war-torn region. Dis one dey come for wia, US president Donald Trump and Ukraine leader Volodymyr Zelenskyy tuk say peace deal don dey make sense […]

todayDecember 29, 2025 3

Sports

Lagos Boxing Hall Of Fame Train Boxing Talent

By: Esther Ayoola Lagos boxing hall of fame don show workings again, say dem go use monthly tournament, take build young fighters for world stage. For di 2025 edition, Faruk Ajibuwon, African youth games gold medalist, grab best boxer of di year and pocket ₦1 million, tie governor belt for wast, after im beat Osun’ state Malik Onifade for men’s 50kg. U sabi say, LBHF don produce big names like […]

todayDecember 29, 2025 4

National

FCT Minister Wike Say Im Nor Promise Tinubu PDP

By: Esther Ayoola Di honourable minister of di Federal Capital Territory don bring out im weapons of mouth destruction sama governor Seyi Makinde of Oyo state wetin nor good, say im lie for national TV Wike drop all di lines wey im fit drop for TV sitdon tuk with tori pipo on Monday, say, im nor promise president Tinubu say im go hold di Pipos Democratic Party down for am […]

todayDecember 29, 2025 5

National

Obi Explain Why Im Wan Contest 2027 Elections

By: Esther Ayoola Di labour party 2023 presidential candidate and former Anambra state governor, Peter Obi,  don clear men doubt  say e go run for 2027 presidential election. E make di announcement on Sunday night, during live X space session wey @obidientupdate host, e explain everything about him political future. Mens and better yanriyans gather for di X space, enter meeting with obi. Obi use di chance tuk about Nigeria […]

todayDecember 29, 2025 6

Lagos

Lagos Gorment Clear Lagos–Badagry Expressway For New Year Celebration

By: Esther Ayoola Lagos state gonment decide say dem wan enter di new year clean,  say dem don start to clear plenty rubbish wey  pile up for Lagos–Badagry expressway to reduce waste pollution for di state. Commissioner for environment and water resources, Tokunbo Wahab,  share dis update for X  post on Sunday, say kontri man and women need stay healthy,  say like dis dem don carry kapila and survel enter […]

todayDecember 29, 2025 8

obodo oyinbo

Russia Yan Say Dem Grab Dibrova for Donetsk

By: Esther Ayoola Russian Army yarn say dem don “free” one village for eastern Ukraine, come afta dem don claim ground gains for past few days, even as peace talks dey go on. Ministry of Defence drop short statement say Dibrova village for Donetsk don enter dia hand. Ukrainian military never yarn anything so far, dem still dey hold mouth on di matter. Na so tension dey rise for Donetsk, […]

todayDecember 29, 2025 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app