By: Esther Ayoola
Lagos state gonment decide say dem wan enter di new year clean, say dem don start to clear plenty rubbish wey pile up for Lagos–Badagry expressway to reduce waste pollution for di state.
Commissioner for environment and water resources, Tokunbo Wahab, share dis update for X post on Sunday, say kontri man and women need stay healthy, say like dis dem don carry kapila and survel enter area dey park dorty.
Im say di complain from people dat dorty too much for public places for Lagos nor allow dem hear word, say di mata almost deft governor Babajide Sanwo-olu.
Say na so dem enter street, Wahab tuk say di clearing start from volks and don reach Agric bus stop, as government dey increase effort to clean di road and stop environmental wahala.