Tanzania Go Make Match Hard For Super Eagles – Onazi
By: Rilwan Agbomeji Former Naija Midfielder, Ogenyi Onazi don warn say Tanzania go make life hard for Super Eagles for dia AFCON 2025 Group C match on Tuesday for Morocco. Onazi yarn for TV siddon talk say players gatz prepare well if dem wan collect full three points. Super Eagles dey favourite to top di group wey get Tunisia and Uganda join body.