Blog no sidebar

Background

Business

Nigeria Don Become AFRIPERF Headquarters

By: Rilwan Agbomeji Di African Petroleum Regulators Forum don give Nigeria big promotion as dem pick di country as official headquarters, and elect NUPRC oga, Engr. Gbenga Komolafe, as di new Chairman. Di announcement land during dia first executive meeting wey dem hold online on December 2, 2025.Plus, NUPRC senior official Eyoanwan Ndiyo-Aiyetan don also climb go top as secretary of di Forum.

todayDecember 3, 2025 13

obodo oyinbo

Somalis No Suppose Dey US – Trump

By: Rilwan Agbomeji US President, Donald Trump don scatter ground for White House cabinet meeting for Tuesday as e burst out say e no want Somali immigrants for America at all, even rub insult on top Somalia head, yarn say di country “barely dey” and people for there just run up and down  dey kpai dia sef. Na dis same time US immigration officials dey cook one heavy raid wey […]

todayDecember 3, 2025 20

Sports

Make Fulham Forget Man City Beating — Iwobi

By: Rilwan Agbomeji Fulham winger, Alex Iwobi don fire up im boys afta dem loose 5-4 giv Manchester City for dia own house for Tuesday. Fulham Boys no come sell groundnut ooo as dem match City fire-for-fire, push dem sotay e remain small make dem thief one point comot Pep hand. Na Iwobi even light di fire as e tear net with one mad goal afta second half pass small, […]

todayDecember 3, 2025 9

Entertainment

2Baba Eye Comot Water As Marriage Gbege Grip Am For Neck

By: Rilwan Agbomeji Na wah oh! Nigerian music star, Innocent Idibia wey everybody sabi as 2Baba, don finally  open mouth talk wetin dey im mind for first time since di hot gbege with im wife, Natasha Osawaru burst everywhere for internet. For im IG tori on Wednesday, 2Baba tok say e need help, omo di message short but e carry weight wey hit body like trailer. E no finish there […]

todayDecember 3, 2025 21

Business

CPPE Urge FG to Tackle Cost of Living Through Agric, Manufacturing Boost

By: Esther Ayoola The Centre for the Promotion of Private Enterprise (CPPE) don sama message give wi Federal Government say make dem try put body for agriculture and manufacturing business say failure to do so go cos Niger economy betalicious problem. CPPE Director, Muda Yusuf talk say if goment no take strong action to fix wahala inside agriculture, manufacturing and trade, the country fit still struggle to turn economic growth […]

todayDecember 3, 2025 10

Lagos

Fire Burst Near RRS Base, Third Mainland Bridge Motorists Diverted

By: Esther Ayoola Nor be small mata oh for third mainland bridge, lagos, say fire  scatter bodey near rapid response squad (rrs) base for Adekunle, wey dey go Iyana oworo According to the Lagos State Traffic Management Authority as dem take sukili for social media X. say the fire le gidigan and that e cause better go slow for the area. Eyewitnesses talk say the smoke choke the area as the […]

todayDecember 3, 2025 7

Lagos

Lagos Tricycle Driver Jailed 10 Years for Killing Colleague with Stone

By: Esther Ayoola Lagos High Court wey wey put body for Tafawa Balewa Square don sentence one 42-year-old keke driver, Godswill Akpan, to 10 years jail after him kpai kpai im colleague, Baba Ali Bukar, say im give am beta 500 hundred for chest with stone. Justice Yetunde Adesanya find say the prosecution don prove without doubt say Akpan na him action cause Bukar death. Akpan first show for court […]

todayDecember 3, 2025 6

Lagos

Lagos Tell Lekki–Epe Road Workers Make Dem Quit Site Dec 4, Return January

By: Esther Ayoola The Lagos State Government don order contractors handling Eti-Osa/Lekki/Epe Expressway say make dem comot from site on Thursday, 4th December 2025, and return in January 2026. The announcement come from State Commissioner for Transportation, Oluwaseun Osiyemi, as e ma carry torch light go point area unto how the road mata go be for Epe. Government talk say the move na to make traffic waka freely during the […]

todayDecember 3, 2025 6

Lagos

Lagos Govt Gives One-Week Final Warning To Unapproved Estate Developers

By: Esther Ayoola No be small thing o, as  Lagos State Government don sama one-week  warning, dem call ham final warning to estate developers wey dey operate without layout plans say make them do the needful. Senior  man, Commissioner for Physical Planning and Urban Development, Dr. Oluyinka Olumide, dey champion the talk say any developer wey no put body for this message go collect beta sanction. Oga commissioner dey yarn […]

todayDecember 3, 2025 7

National

Sowore Face Court Over Anti-Tinubu Post, Comot On Self-Recognition

By: Rilwan Agbomeji Na big gbege shele for Abuja on Tuesday as Omoyele Sowore, land Federal High Court, dey face DSS on top wetin im yarn for post on social media say President Bola Ahmed Tinubu na “criminal.” Di mata serious as DSS drag am for five counts of criminal defamation, and even Meta (Facebook) plus X Corporation (Twitter) join di hot gbege as co-defendants. DSS yarn say Sowore dey […]

todayDecember 3, 2025 7

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app