By: Esther Ayoola
No be small thing o, as Lagos State Government don sama one-week warning, dem call ham final warning to estate developers wey dey operate without layout plans say make them do the needful.
Senior man, Commissioner for Physical Planning and Urban Development, Dr. Oluyinka Olumide, dey champion the talk say any developer wey no put body for this message go collect beta sanction.
Oga commissioner dey yarn this one as im ma lead on-the-spot sensitisation across Eti-Osa corridor on Tuesday.
Olumide add ham talk that, many estates still dey break planning rules despite plenty plenty notices wey be say dem don give them and tha this time around anybody wey dem catch go hear win for government.