Blog no sidebar

Background

OBODO NAIJA

US Hammer Nigeria With 12.5% Tariff! Say Labour Law Enforcement No Strong Enough

By: Yusuf Abuh Di Office of di United States Trade Representative don announce say America don place 12.5 per cent tariff on goods wey Nigeria dey export enter di US, according to statement wey dem release on Thursday. Washington tok say dem take dis decision after Section 301 investigation because Nigeria no dey effectively enforce laws wey ban goods made with forced labour, as part of new trade policy wey […]

todayJuly 24, 2026 26

OBODO NAIJA

Social Media Giants Don Enter Senate Radar! Lawmakers Want Force Dem Open Office For Nigeria

By: Yusuf Abuh Di Senate don push one new bill to force big foreign social media companies open physical offices for Nigeria, as lawmakers debate di proposal for Abuja on Thursday. Senator Ned Nwoko sponsor di bill to amend di Nigeria Data Protection Act, saying e go make social media companies answer better to Nigerian laws and authorities. Lawmakers and stakeholders wey attend di discussion for Abuja on Thursday throw […]

todayJuly 24, 2026 17

Konfam 89.5 FM #10

Konfam 89.5 Fm Make History: From New Station To One Of Lagos Top 10 Radio Stations For Just One Year

Konfam 89.5 FM don officially join di list of di biggest radio stations for Lagos as di latest MPS Radio Ratings show say di station jump beta akpala enter Top 10, just in di space of one year. For Lagos wey get more than 75 licensed radio stations, no be small thing for any station to enter di list of di best broadcasters. Plenty stations dey spend many years before […]

todayJuly 24, 2026 188 31 3

OBODO NAIJA

Peter Obi Want Make Dem Touchlight Enugu Air Runway Askident

Peter Obi don show joy after Enugu Air plane run comot from runway as e dey land for Benin Airport, and e thank God say all 68 passengers and crew members come out safe without any injury or death. For statement wey e post for X on Friday, Obi praise di pilot, cabin crew and airport emergency workers for dia fast and professional work wey hellep stop bigger gbege. E […]

todayJuly 24, 2026 14

OBODO NAIJA

US Congressman Want Make Nigeria Release Nnamdi Kanu

One United States Congressman, John James, don renew im call make Nigerian gornment release leader of di banned Indigenous People of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu. James make di appeal while e dey speak for di US House of Representatives on Thursday, as e tok say Kanu continued detention fit be part of religious persecution against Christians for Nigeria. Di lawmaker from Michigan refer to H.Res. 1321, one resolution wey e […]

todayJuly 24, 2026 19

obodo oyinbo

Trump Yarn Say Iran Money Go Pay for Hormuz Ship Gbege

United States Presido, Donald Trump don tok say any damage wey happen to ships and cargo for Strait of Hormuz ehnnn, na frozen Iran money go pay for am. For post wey e make on Truth Social on Thursday, Trump tok say na Iranian money wey America hold go take settle any damage. Trump still tok say America don carry out 13 nights of strikes on Iran, and say e […]

todayJuly 24, 2026 20

president Bola Tinubu

OBODO NAIJA

Presido Tinubu Expand Army Reach 12 Divisions

Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don approve make Nigerian Army increase from eight divisions reach 12 divisions, and make dem recruit 28,000 new soldiers. For statement wey Bayo Onanuga sign on Thursday, e tok say four new divisional headquarters go dey for Makurdi, Ilorin, Jalingo and Benin City. According to wi presdio, dis plan go hellep security agents respond to any threats sharp sharp and to make border security […]

todayJuly 24, 2026 21

Sports

Joshua Promoter Tok Say Fury Fight Go Happen

By: Yusuf Abuh Promoter of Anthony Joshua, Eddie Hearn, don dismiss wetin Tyson Fury tok say dia long-awaited fight fit no hapun again. Fury go face Poland boxer Mariusz Wach for Thailand on Friday, while Joshua go enter ring against Albania boxer Kristian Prenga for Saudi Arabia on Saturday, and both fights na preparation before dia expected big showdown. Di two British heavyweight boxers never fight each other before, even […]

todayJuly 24, 2026 21

obodo oyinbo

How Ukraine Drone Attack Scatta Russia Big Warehouse

By: Yusuf Abuh Ukraine drone attack don cause fire for one big warehouse wey belong to Wildberries, Russia biggest online shopping company, near Saint Petersburg early Friday morning. Di attack make thick smoke cover part of di city as people see grey smoke dey rise for sky. Ukraine don increase long-distance drone attacks on Russia energy, military and logistics places in recent weeks. Saint Petersburg dey more dan 800 kilometres […]

todayJuly 24, 2026 15

OBODO NAIJA

House of Reps Pass State Police Bill

By: Yusuf Abuh House of Representatives on Thursday for Abuja don approve di State Police Constitution Amendment Bill. But dis one na after beta jogolo from some members of di minority caucus wey dey protest say di bill need beta okporlor eyes to look am wella. However, Deputy Speaker and Chairman of House Committee on Constitution Review, Benjamin Kalu, sti press hand for di bill, say di bill na one […]

todayJuly 24, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds