obodo oyinbo

Trump Yarn Say Iran Money Go Pay for Hormuz Ship Gbege

todayJuly 24, 2026 3

Background
share close

United States Presido, Donald Trump don tok say any damage wey happen to ships and cargo for Strait of Hormuz ehnnn, na frozen Iran money go pay for am.

For post wey e make on Truth Social on Thursday, Trump tok say na Iranian money wey America hold go take settle any damage.

Trump still tok say America don carry out 13 nights of strikes on Iran, and say e dey consider one bigger military attack pass ever before.

Iran Foreign Affairs Minister, Abbas Araghchi, reject di statement on Friday morning, say to seize another country money to pay for future claims wey no relate na dangerous move.

Even though nobody know di exact amount of frozen Iran money, some estimates show say e fit reach around 100 billion US dollars.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds