Blog sidebar

Background

National

Kanu Write Letter Give Trump, Beg Am To Look Into Killing Wahala For South-East

Ahead of im important hearing today, di detained leader of di Indigenous People of Biafra (IPOB), Nnamdi Kanu, don write letter go di United States President, Donald Trump, dey beg make im start independent probe into di “killings of Christians and Igbo people” wey dey happen for di South-East. Di letter wey dated November 6, 2025, and pass through im lawyer, Aloy Ejimakor, go di U.S. Embassy for Abuja, talk […]

todayNovember 7, 2025 6

Sports

Ajax Don Sack Coach John Heitinga

Dutch football giant Ajax don sack dia coach John Heitinga after poor performance wey don leave dem for bottom of di Champions League table. Di club talk for statement say dem dey find new head coach, while Fred Grim go take over Heitinga’s work for now. Heitinga wey sign two-year contract for May, no fit turn things around for di four-time European champions, so Ajax don confirm say dem go […]

todayNovember 7, 2025 3

Lagos

Lagos Don Show 540 Metre Road Project For Alimosho

Lagos State Government don flag-off di construction of 540-metre road for Alhaji Jimoh Drive/Baptist Church Street for Iba Local Council Development Area as part of dia plan to improve rural and suburban infrastructure across di state. Special Adviser to di Governor on Rural Development, Dr. Nurudeen Yekinni Agbaje, talk say di project na proof say Governor Babajide Sanwo-Olu dey committed to inclusive growth and balanced development for all communities. Di […]

todayNovember 7, 2025 7

National

Court Don Fix Date For Nnamdi Kanu Terrorism Judgment

Di Federal High Court wey dey Abuja don fix November 20 to deliver judgment for di terrorism trial of Nnamdi Kanu, di leader of di proscribed Indigenous People of Biafra (IPOB). Justice James Omotosho announce di date on Friday after Kanu insist say e no go defend himself under wetin e call a “repealed law.” Di judge talk say di court don already give am enough chance under Section 36 […]

todayNovember 7, 2025 3

International

Five Drug Lords Bag 21yrs Jail Over Gabon, Australia Drugs

Five members of international drug cartel don bag total of 21 years jail after NDLEA catch dem with 68.9kg cocaine and tramadol wey dem wan smuggle go Gabon and Australia through Murtala Muhammed International Airport, Ikeja, Lagos. Di suspects, Olasupo Michael Oladimeji, Muaezee Ademola Ogunbiyi and Sola Adegoke, be leaders of one of di drug cartels wey NDLEA nab on August 26, 2025, as dem dey export 17.9kg cocaine hide […]

todayNovember 7, 2025 7

Entertainment

Regina Cry – Make I Dey Show My Sadness And Pain To Una?

Actress Regina Daniels don respond to Nigerians wey dey mock her over her marital wahala. For one video wey she post for her page, Regina talk say e dey okay if people wan laugh at her and talk say when she dey flaunt Ned Nwoko money, nobody dey enjoy am with her. For di video, Regina yan say nobody dey ever flaunt dia sadness because people go dey mock dem. […]

todayNovember 7, 2025 17 41

International

Elon Musk Don Bag $1 Trillion Pay As Tesla Dive Into AI, Robots

Tesla shareholders don gree give Elon Musk di biggest pay package wey world don ever see, $1 trillion deal wey go tie him reward to di company new move into artificial intelligence and robotics. Di approval happen for Tesla annual meeting for Austin, Texas, where over 75% of shareholders vote make e happen. Di pay package go allow Musk unlock stock wey fit reach $1 trillion if him meet heavy […]

todayNovember 7, 2025 9 1

Sports

£800,000 Don Vanish From Bissouma Account

Premier League star, Yves Bissouma, don lose over £800,000 after dem done thief am money from im VIP Coutts bank account. Di £30million Spurs midfielder money wahala start from September 2022 reach June 2024. Maurice Gomes, 31, bin first arrested after Bissouma report am over one year ago. Metropolitan police confirm say Gomes face two counts of fraud by false representation since October, wey fit carry 10 years jail for […]

todayNovember 7, 2025 7

National

FEC Don Okay Concession Of Port Harcourt International Airport, Approve Presidential Task Force For ‘Detty December’

FEC don rise from im meeting for Thursday, approve say dem go give Port Harcourt International Airport to private investors make dem manage am beta and improve service delivery. Dem also approve long-awaited contract for engineering infrastructure for Maitama 2 District for FCT, Abuja. Aviation Minister, Festus Keyamo, talk say di concession no go make any aviation worker lose him job, as government still dey protect workers rights while dey […]

todayNovember 7, 2025 5

Sports

NSC Talk Say Sports Dey Play Big Role For Job Creation

The Chairman of di National Sports Commission (NSC), Shehu Dikko, don yan di strategic role wey sports dey play as catalyst for youth empowerment, job creation, national unity, deepening security and international collaboration, while e still reafirm say di Commission dey push ongoing efforts to build globally competitive and sustainable sports system for Nigeria under di current government. Dikko yan dis one for di inaugural CNN Global Perspectives: On Africa […]

todayNovember 7, 2025 6 100

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app