Blog sidebar

Background

obodo oyinbo

Pope Leo Honour Late Pope Francis For 1st Death Anniversary

By: Esther Ayoola For Vatican City, Pope Leo XIV don mark oneyear afta di death of Pope Francis on Tuesday, as he call on Catholic faithful worldwide to continue the mission of mercy and brotherhood wey Francis stand for. Pope Leo, for message wey im post on X (formerly Twitter), say, dem sti carry Pope Francis words and actions for heart. He add say di Church go continue to preach […]

todayApril 21, 2026 11

Lagos

Lagos Lawmaker Promise More Projects As Road Work Continue For Oshodi

By: Esther Ayoola For Oshodi/Isolo Constituency I for Lagos State, House of Assembly member Hon. Stephen Ogundipe on Monday don go promise residents say more development projects. Di senior man make dis announcement as im go inspect ongoing road works for di area. Ogundipe use im mouth tuk say im check four roads Oluwasanmi, Baba Ode, Deji Adeoye, and Alhaji Sokoya streets, and body sweet am for di quality of […]

todayApril 21, 2026 17

Lagos

Jandor Tuk Why Lagos Governorship Race Dey Open, Say Hamzat Never Declare

By: Esther Ayoola Lagos 2023 governorship candidate of di pipos democratic party, Abdulazeez Adediran, AKA Jandor, don go pour cold water for Lagos Politics say Deputy Govo, Obafemi Hamzat, never declare say e wan contest 2027 governorship election. Jandor yarn dis one for TV sitdon tuk on monday E say Hamzat get plenty experience as deputy governor, but for now, no clear sign say e don enter race. According to […]

todayApril 21, 2026 11

Lagos

INTERPOL Catch Runaway Lagos Bizman Over Alleged Double Kpaing

By: Esther Ayoola Police for Lagos don do ogbonge waka gbab one businessman, Hammed Tajudeen Akanbi, wey dem accuse of kpaing Prince Ademola Akinloye and Sheriff Ishola Salami for separate attacks. AIG Olohundare Moshood Jimoh naim yarn dis one for press briefing on Monday for Zone 2 headquarters, Onikan. According to di AIG, na INTERPOL track and arrest Akanbi on April 15 for one hotel for Cotonou, Benin Republic, afta […]

todayApril 21, 2026 9

Lagos

How Speeding Tanker Jam And Kpai Dispatch Rider For Alapere

By: Esther Ayoola Say one serious road askident wey hapun for Motorways Inward Estate area for Alapere, Lagos State, don kpai one dispatch rider. According to Lagos State Traffic Management oga, Adebayo Taofiq, di askident involve empty NIPCO Tanker and di rider. Taofiq say di tanker driver bin dey speed when e jam di moving dispatch rider, and di rider kpai on di spot. LASTMA officials quickly rush go di […]

todayApril 21, 2026 10

National

PDP South-West Hail Seyi Makinde, Say Im Na Strong Man For Naija Democracy

By: Esther Ayoola Di Pipos Democratic Party South-West leaders don praise Seyi Makinde, say im na senior man behind Naija multi-party democracy. Dem yarn dis one on Monday for press conference wey dem hold for Ibadan. Party’s Zonal Publicity Secretary, Chief Sanya Atofarati, naim carry im mouth take explain dis mata for di press conference Im say, Oga Makinde don show true character through im policies and actions, and dat […]

todayApril 21, 2026 9

National

APC Release 2027 Election timetable, Presidential Ticket For ₦100m, and Govo ₦50m

By: Esther Ayoola Say like dis All progressives Congrees APC don release dia timetable and schedule of activities for di 2027 general elections. Dis na according to statement wey di party National Publicity Secretary, Felix Morka tuk  wey im joinbodi sign with National Organising Secretary, Sulaiman Argungu on Monday for Abuja. Part of di schedule na how dem go run screening, appeal process and party primary elections for different positions, […]

todayApril 21, 2026 14

National

Wike Declare Say PDP Door Sti Open For Returnee

By: Esther Ayoola Minister of FCT, Nyesom Wike, on Monday for PDP 108th National Executive Committee (NEC) meeting, say door sti open for dia pipo wey run comot di Pipos Democratic Party to return. Wike give di message as e dey address party leaders and members, and e advise di Abdulrahman Mohammed-led National Working Committee to continue reconciliation work. Im say na through forgiveness, dialogue, and unity, PDP fit rebuild […]

todayApril 21, 2026 9

National

Oluyede Tell Troops Not To Relax For Naija Bandits

By: Esther Ayoola Chief of Defence Staff, Olufemi Oluyede, don tell troops of Operation Fansan Yamma make dem continue serious fight against bandits and criminals for North-West. Im yarn dis one when he visit dia headquarters for Gusau inside Zamfara State, where e check how ready di soldiers be and discuss security wahala for di area. According to Oluyede, say Naija must be saved by all means, no excuse.

todayApril 21, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds