Blog sidebar

Background

Sports

Guardiola Put Backing For Nico O’reilly To Win Young Player Award

By: Esther Ayoola Manchester City coach Pep Guardiola don praise young midfielder Nico O’Reilly for im strong performances so far and say e deserve Premier League Young Player of di Season award. Guardiola tuk dis one afta Man City beat Arsenal 2-1 on Saturday, as e highlight how O’Reilly assist Erling Haaland for second half goal wey hellep dem win di match. According to post wey journalist Fabrizio Romano share […]

todayApril 20, 2026 9

National

FRSC Tell Drivers To Slow Down For Rainy Season To Avoid Crash

By: Esther Ayoola Federal Road Safety Corps (FRSC) for Ogun don send advise to drivers to reduce speed and dey careful when dem dey approach potholes for highway to avoid askident during rainy season. Ogun Sector Commander, Oludare Ogunjobi, naim dey tuk am on Monday for Ota while e dey speak with tori pipo. E explain say wet road dey slippery and speed fit make driver lose control easily, especially […]

todayApril 20, 2026 9

National

FG Explain Themselves Say No Hidden Spending, No Money Diversion

By: Esther Ayoola Federal Gornment don reject report wey say dem dey hide money or divert federal revenue. Minister of State for Finance, Taiwo Oyedele, iron mata wetin nor good inside statement for Abuja on Sunday, say pipo dey wrong to follow di World Bank Naija Development Update. E explain say all di money wey dey comot from Federation Account Allocation Committee (FAAC) na normal and legal things like statutory […]

todayApril 20, 2026 15

Sports

Odegaard Tuk up hope, Say Arsenal Still Fit Win EPL

By: Esther Ayoola Arsenal captain Martin Ødegaard say im still get hope say di Gunners fit win di Premier League title dis season, even after dem lose 2-1 to Manchester City for Etihad Stadium on Sunday. Di result reduce di gap to just three points, as Manchester City sti get one match wey dem never play yet. Ødegaard tuk to Sky Sports say Arsenal no get choice but to focus […]

todayApril 20, 2026 10

Sports

Naija Athletes Burst Outdoor Season with Records, PBs and Big Wins For US

By: Esther Ayoola Say like dis, Nigerian athletes dey show workings for outdoor season, recording wins, personal bests and even national record for sprint, jumps and throws events. Chinecherem Nnamdi win men javelin for Tom Jones Memorial for Florida wit big personal best of 84.68m wey break im own national record and push am go seventh for Africa all-time list. Kanyinsola Ajayi run 100m invitational for Auburn meet clock 9.90s […]

todayApril 20, 2026 13

Sports

Rangers Beat Enyimba 2-1, Worsen Dia Relegation Fight

By: Esther Ayoola Rangers International FC of Enugu don make Enyimba International FC relegation battle worse beating dem 2-1 for NPFL Week 35 match wey happen for Nnamdi Azikiwe Stadium, Enugu, behind closed doors. First half no get goal as both teams struggle to convert dem chances. Enyimba first score for 48th minute through Wonah Williams, but Rangers equalize for 61st minute as Chiedozie Iwundu slot am in during goalmouth […]

todayApril 20, 2026 10

obodo oyinbo

Ukraine Police Boss Resign Say Im Officers Run From Gun Battle For Kyiv

By: Esther Ayoola Head of Ukraine patrol police, Yevhen Zhukov, don resign afta two of im officers face serious criticism say dem run comot during deadly shooting for Kyiv. Di attack hapun on Saturday for Holosiivskyi area, wia one-man open fire for street, kill 6 people and injure 14 others before e take some people hostage for supermarket. Police later engage am for gun battle and dem kpai di attacker. […]

todayApril 20, 2026 11

obodo oyinbo

US Navy Seize Iranian Ship For Gulf, Iran Vow To Retaliate

By: Esther Ayoola US Presido and Im Navy don go intercept one Iranian cargo ship wey dem dey call Touska for Gulf, as part of dia blockade dey cause serious gbege. Trump explain for im Truth Social say di ship no respond when dem warn am make e stop, naim make dem seize am. Iran dey vex for di other side, say na violation of ceasefire and dem go retaliate, […]

todayApril 20, 2026 10

National

JAMB Release 1.2 Million UTME Result Again

By: Esther Ayoola JAMB don announce di release of result for candidates wey write 2026 UTME on Friday 17 April and Saturday 18 April. According to dia tuk, tuk, Fabian Benjamin, over 1,264,940 results for those two days don ready for candidates to check. Dem also tuk say dis one, say e dey follow di earlier batch wey dem release for people wey write exam on Thursday 16 April. Candidates […]

todayApril 20, 2026 6

National

SSANU Reject 30% Salary Raise, Threaten Strike For Federal Schools

By: Esther Ayoola Say wi Federal gorment bin approve 30% pay increase for non-academic staff for federal universities, polytechnics and colleges of education, but like dis, SSANU don reject di 30% increase. Nor be amebo say di Minister of Education, Dr Tunji Alausa, put for one letter wey e write on March 30, 2026, say di raise go come as Consolidated Non-Teaching Tools Allowance to reduce salary wahala and settle […]

todayApril 20, 2026 9

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds