Blog sidebar

Background

Sports

NPFL Match Day 31: Katsina, Kano, Remo, Rangers Record Win

For Sunday matas, the NPFL nor dey slack at for match day 31  as top teams  fight for points. Katsina United FC beat Shooting Stars FC 1-0, while Kano Pillars FC show power with 2-0 win over Enyimba International FC. Remo Stars FC carry 3-1-win comot for Kwara United FC, and Enugu Rangers FC waka go 2-0 against El-Kanemi Warriors FC. Some games like Warri Wolves FC vs Bendel Insurance […]

todayMarch 23, 2026 6

Sports

Lookman Score Historic Goal, But Real Madrid Still Shock Atletico 3-2

Ademola Lookman don make history as e become first Nigerian wey score for Madrid derby, but e goal no sti hellep as 10-man Real Madrid turn game around to win 3-2 against Atletico Madrid for La Liga on Sunday. Lookman don score two goals dis season for im debut campaign in Spanish top flight. Di win give Real Madrid (69 points) reduce Barcelona (73 points) lead to just four points […]

todayMarch 23, 2026 4

Sports

Man City Beat Arsenal 2-0 To Carry League Cup

Manchester City don win dia first trophy for dis English season as Nico O’Reilly score two goals for di second half to hellep dem beat Arsenal 2-0 for di League Cup final. Arsenal wey be Premier League leaders come as favourites, but power pass favourite for Wembley stadium. Di first half no too get action, but O’Reilly first goal come after Arsenal goalkeeper Kepa Arrizabalaga fumble. Four minutes later, O’Reilly […]

todayMarch 23, 2026 4

obodo oyinbo

Israel Attack Bridges, Enter Lebanon For Long Fight

By: Esther Ayoola Israel army commander Lieutenant General Eyal Zamir on Sunday for southern Lebanon announce say Israel don begin big ground operation against Hezbollah because dem wan stop di Iran‑backed group wey dey fire rockets and violate Israel borders. Oga Zamir say dem don destroy some bridges near di Litani River wey Israel claim Hezbollah dey use cross for attack, and dem plan to advance ground operations and air […]

todayMarch 23, 2026 5

National

IGP Olatunji Disu Make Move To Reduce Police Tactical Teams

By: Esther Ayoola Police oga for Naija, Olatunji Disu, on Sunday for Abuja don order make dem reduce tactical teams across di country. According to police tuk tuk, Anthony Placid, say di IGP say zonal and state commands no go get pass five teams, while area commands and divisions go get only three teams. Im explain say dis decision come based on di plenty tactical units wahala and dat some […]

todayMarch 23, 2026 7

National

Wike Branch Of Di PDP Tell Members To Ignore Wetin Parti BOT Tuk

By: Esther Ayoola Di Federal Capital Territory (FCT) Minister, Nyesom Wike-backed National Caretaker Working Committee (NCWC) of di Peoples Democratic Party (PDP), don ask party members make dem no mind any wahala or misleading tori wey dey about di party leadership. Di NCWC National Publicity Secretary, Jungudo Mohammed, tuk dis one for Abuja on Sunday as dem dey yarn about wetin dey hapun for di party leadership and di coming […]

todayMarch 23, 2026 5

National

Peter Obi Call Nasir El-Rufai Arrest Political Bad Belle

By: Esther Ayoola Di 2023 Labour Party (LP) presidential candidate, Peter Obi, don drop other bombshell say di arrest and detention of former-Kaduna State Govo Nasir El-Rufai say e no make brain and dat na political persecution. Obi tuk dis one for Sunday when e dey meet African Democratic Congress (ADC) stakeholders for Kaduna. E say, di way ICPC dey hold El-Rufai dey worrisome, and na concern to democracy and […]

todayMarch 23, 2026 6

National

First Lady Oluremi Address Di Ozoro Festival Isuues

By: Esther Ayoola Wife of Oga Presido, Senator Oluremi Tinubu, don condemn di way Jaguda boys take abuse some women and girls during di Alue-Do cultural festival for Ozoro, Isoko North LGA, Delta State on Sunday. She put for statement, say di viral video show di girls suffer barbaric and degrading treatment for wetin suppose be normal community celebration. Senator Oluremi hail di police wey don make some arrests and […]

todayMarch 23, 2026 6

National

Makinde, Bala, Obi, Kwankwaso Hold Secret Meeting For 2027 Election

By: Esther Ayoola Opposition Govos, Seyi Makinde and Bala Mohammed on Sunday don buy waka meet with Seriake Dickson for Bauchi as tuks on PDP leader jam rock. Afta di meeting, Makinde and Dickson waka go see former kano state govo, Rabiu Kwankwaso and Peter Obi, wia dem do small political waka One source wey dey close to Kwankwaso, wey no wan make dem call im name, tuk say di […]

todayMarch 23, 2026 4

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app