Blog sidebar

Background

OBODO NAIJA

NAF Helicopter Land For Farm After Kidnapper Operation

By: Kofoworola Olayinka Nigerian Air Force, NAF, don explain say one of dia helicopters wey land for farmland for Makurdi, Benue State, dey return from operation against suspected kidnappers along Enugu-Benue boundary. NAF spokesman, Air Commodore Ehimen Ejodame, say di helicopter provide close air support to ground troops during operation for Ogbadigbo area, wey help disrupt activities of di suspected kidnappers. Ejodame say di pilot later make precautionary landing about […]

todayOctober 8, 2026 8

Sports

Shooting Stars Fans Vex, Say Make Coach Salisu Yusuf Comot

By: Kofoworola Olayinka Di Oluyole Warriors don win only one game for dia last six league matches. Dis kind result  make dia fans vex wetin nor good. As di match finish, fans for di stadium begin shout, Salisu must go! Dem continue di chant as dem show say dem no happy with wetin di team dey do. Shooting Stars go meet Kun Khalifat for dia next league game. Di Oluyole […]

todayOctober 8, 2026 9

obodo oyinbo

Trump Tuk Say Iran War Go End Soon

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don tuk say di war between US and Iran fit end soon. E tuk dis one for a campaign rally for San Antonio, Texas on Wednesday. Trump say Steve Witkoff, wey be US tok tok pesin wen dey follow iran pipo dem tok, dey work on how dem fit stop di war. E say Witkoff dey do well for di tuk Trump also […]

todayOctober 8, 2026 7

National

Uzodimma Praise Security pipu As 20 Corps Members don Free

By: Kofoworola Olayinka Imo State Gofnor, Senator Hope Uzodimma, don clap hand for security pipu as dem sharparly  rescue di 20 corpers wey kidnappers carry for Onitsha-Owerri Road. Di gofnor say e happy say police, army and oda security pipu join hand make dem rescue di corps members safely. E praise dem for dia hard work and love for di country. Uzodimma also praise Oyo and Imo State Gornment for […]

todayOctober 8, 2026 10

OBODO NAIJA

20 NYSC Members Wey Kidnapers Carry Don Get Dia Freedom

By: Mariam Ajayi Twenty NYSC members wey kidnappers carry for Imo State don regain dia freedom after seven days for captivity. Police Force Public Relations Officer, CSP Anietie Iniedu, konfamate dia release on Wednesday, say dem rescue di victims safely. Police, Army, DSS and oda security agencies join hand for di rescue, as authorities don take di victims go hospital for medical check-up and treatment.

todayOctober 8, 2026 6

Lagos

ADC Candidate Clear Community NEPA Bill For Residents

By: Mariam Ajayi ADC candidate for Eti-Osa Constituency II, Ayodele Adio, don clear  NEPA bills wey pipo owe for one community wey no get light tey tey. Adio make di move during im visit with community leaders and NEPA officials on Wednesday, as residents celebrate when power return to di community. But residents later complain say light don go off again after one alleged instruction to NEPA to disconnect am, […]

todayOctober 8, 2026 10

obodo oyinbo

Japan Helep Yemen And Djibouti with $10m Emergency Funds

By: Mariam Ajayi Japan don become snior helpers fo middle east, dem don approve $10 million emergency aid for Yemen and Djibouti based on di war wey don scarra dis two both countries. According by di  Japanese embassy, Japan gornment approve di money on Tuesday. Yemen go get $8 million from World Food Programme, International Committee of di Red Cross and International Organization for Migration, while Djibouti go get $2 […]

todayOctober 7, 2026 14

OBODO NAIJA

Umahi Comot Some Barriers For First Niger Bridge

By: Mariam Ajayi Works Minister, Dave Umahi, start to dey comot some concrete barriers wey dem put for First Niger Bridge to divide di narrow road into two lanes. Di barriers cause plenty kasala last week as road users and engineers say dem fit make traffic worse and make emergency movement hard for di bridge. Di Works Ministry bin say di barriers na to control traffic and stop reckless overtaking […]

todayOctober 7, 2026 11

OBODO NAIJA

Donald Duke Say INEC Gats Assure Free And Fair 2027 Election

By: Mariam Ajayi Senior man, People Redemption Party, presidential candidate, Donald Duke, say fear dey di land for dis 2027 election mata, INEC gats convince Nigerians say di 2027 election go free and fair. Duke fire dis mata for news tok norbi small, say di way dem take run di 2023 presidential election don open Nigerians eyes waah for ground. Wey dem fire am question wetin change, di former Cross […]

todayOctober 7, 2026 8

Lagos

Passenger Kpai Inside Kenya Airways Plane Wey Dey Come Lagos

By: Mariam Ajayi One Kenya Airways plane wey bin dey come Lagos from Nairobi, say from no wia, person just kpeme for plane as hin near Lagos. Nobody sabi wetin kill di man. According by infomate wey di airline tok tok person, Michael Achimugu, bring out, di passenger just stop to respond about 20 minutes before di plane land and dem try first aid, kpokrikpor, di man don go, otilor. […]

todayOctober 7, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds