Nor be small voyolence everywia for dis 2027 election mata, Presidential candidate of Naija Democratic Congress, Peter Obi don drag senior man Presido, Bola Tinubu, leg come out again oh, say e nor dey fear God.
Which mean say Baba Seyi nor fit enter all 36 state to campaign for hin second term, but e get energy travel comot Naija for over 260 days, say na only 36 days e nor fit take campaign.
Obi dey fire dis arrow as hin ma go Abakiliki, Ebonyi state go campaign.
U sabi say dis tok sef dey come after Tinubu mention say him fit no enter all di 36 states go campaign, as governance need hin full attention.
Obi say na lie, na based on say senior man presido nor get energy naim make am tok like dat.