- By : Jolayemi Olajide
Borno State Gornment don calm public fear over repentant terrorists wey dem don rehabilitate and carry join normal pipo for di society.
Di state Commissioner for Women Affairs and Social Development, Zuwaira Gambo, naim dey tuk dis one during interview with news pipo.
According to am, one major part of di Borno rehabilitation na for di former fighters to swear with Qur’an before dem fully return to society.
She explain say anybody wey swear with di holy book and no keep to di oath know di serious spiritual implication, and gornment believe say dis dey help discourage dem from going back to violence.