Senator Ali Ndume wey dey represent Borno South under APC don vex put for ground as Boko Haram launch fresh attack for parts of im constituency. For statement wey e drop on Thursday, Ndume talk say di insurgents gruesomely kill four farmers wey dey work for dia farmland for Kwam village near Dille community for Askira-Uba LGA. Dem attack di victims as dem dey harvest crops, something wey Ndume say show how security don dey deteriorate for remote communities even after years of military operations. According to am, di killings no be isolated case, as Boko Haram don dey step up assault for different areas.
Ndume still highlight how Boko Haram burn Church and other infrastructures for Pemi last week, and on Wednesday dem invade Shikarkir community for Chibok LGA. Di senator para say security operatives no dey maintain steady presence for remote settlements, and na di reason why insurgents dey operate freely without resistance. E call di situation “deeply worrisome”, talk say di inability of security agencies to man di remote communities don make attacks increase without confrontation.