foreign

36 Results / Page 2 of 4

Background

foreign

Saudi Coalition Fire Bomb for Yemen South

By Ebi Oboko Saudi Arabia-led coalition day never break, early mor mor confamate say, dem don fire bomb scarra Dhale, Yemen, on Wednesday. Say Southern Transitional Council (STC) leader Aidarous al-Zubaidi even jump comot plane wey im suppose use fly, use leg pick race for di mata, and dat up till now nobody know wia im enter. Coalition add say e don gather plenty soldiers, tanks, gun, and munitions for […]

todayJanuary 7, 2026 4 1

foreign

Maduro Cry Kidnap, as US Drag Am Go Court

By Ebi Oboko Venezuela Presido, Maduro, 63, don go tell one US court for New York say dem kidnap am comot Venezuela, and say e no guilty, as e still dey claim say e be president. Im wife, Cilia Flores, too talk say she no do anything bad, as both of dem appear for court. US commandos carry dem early Saturday, and later President Donald Trump announce say America don […]

todayJanuary 6, 2026 8 10

foreign

Big Fire kpai 40+ for Swiss Ski Resort Bar

By Ebi Oboko Nor be small tin for Switzerland, say Swiss ski resort Crans-Montana, say nor nor small hell fire burn for dia, kill about 40 people and wunjor more than 100 for bar wey people dey celebrate New Year. The Fire start for Le Constellation bar around 1:30am, when plenty people dey inside. Police tuk say, wetin cause the fire, nbodi knw yet, and fire spread very fast. Swiss […]

todayJanuary 2, 2026 11

foreign

How Many Kontri Trump Bomb For 2025?

By: Rilwan Agbomeji US Presido Donald Trump don confirm say America strike one docking facility for Venezuela dis week. Trump yarn dis one for Florida as e meet Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu, say di attack na di first US military action for Venezuelan land for 2025. According to Trump, di place na where boats wey dem believe dey carry drugs dey load, and di strike cause big explosion for […]

todayDecember 31, 2025 7

foreign

Putin Give First 2026 New Year Speech

By: Rilwan Agbomeji Russian Presido, Vladimir Putin, don knack hand for chest say Russia must win di war for Ukraine and call on im pipo make dem support soldiers. Im sukili dis one put for im New Year’s Eve speech for Kamchatka, di first region wey enter 2026 Im encourage im soldiers and and call on Russians to show support

todayDecember 31, 2025 11

foreign

Iran Tell U.S, Try Us Again, You Go Regret Am

By: Rilwan Agbomeji Iran don finally respond to Donald Trump say dem go give am hot, hot, back to sender, if  America or anybody try attack dem again. Dis one come afta US presido Donald Trump threaten say America fit strike Iran if dem try rebuild nuclear or missile programme. Iran presido Masoud Pezeshkian clear tori pipo for office, say any aggression go bring serious regret, as Iran no gree […]

todayDecember 30, 2025 7

foreign

US Don Promise Ukraine 15-Year Security Cover, Zelenskyy Yarn

By: Rilwan Agbomeji US offer Ukraine 15-year security guarantee as part of peace plan, Ukrainian President Zelenskyy talk on Monday. Zelenskyy yarn say e go prefer make di guarantee last 50 years to stop Russia from any further attack. US President Donald Trump host am for Florida on Sunday, talk say Ukraine and Russia dey closer to peace than before. Negotiations still dey, with wahala like who go withdraw where […]

todayDecember 29, 2025 6

foreign

Trump To Meet Netanyahu For Florida To Align Gaza Ceasefire Talks

By: Rilwan Agbomeji US Presido Donald Trump wan enter meeting with Israeli Prime Minister Benjamin Netanyahu for Mar-a-Lago, Florida, today, to popori one or two on how dem go take address di Gaza ceasefire. Dis meeting come as US dey push Trump 20-point peace plan, even as Israel dey break di peace agreement almost every day. Meanwhile, Israel don increase attacks for West Bank, Lebanon and Syria, and some officials […]

todayDecember 29, 2025 10

foreign

US, Israel Clash As White House Push Phase Two Gaza Ceasefire Plan

By: Rilwan Agbomeji Say like dis, like dis, White House wan move pass phase one of Gaza ceasefire for January, but Israeli PM Benjamin Netanyahu dey resist, and im resistance dey cause serious wahala. US dey plan make Palestinian technocratic government run Gaza daily affairs, as part of phase two of peace plan. Dem still dey prepare multinational peace council and international security force to manage Gaza work and security. […]

todayDecember 26, 2025 10

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app