foreign

36 Results / Page 3 of 4

Background

foreign

Palestine Economy Crash Sake Of Gaza War

By: Rilwan Agbomeji Palestinian Central Bureau of Statistics and Palestine Monetary Authority talk am for dia 2025 Palestinian Economic Monitor report wey dem release dis year for Ramallah. Dem say economy crash because Israel war for Gaza, tighter movement and trade restriction for West Bank, and money from inside and outside don dry, wey make govment no fit pay basic bills. According to di report, GDP for Gaza fall 84 […]

todayDecember 26, 2025 9

foreign

Bolsonaro Undergo Successful Hernia Surgery Afta Prison Transfer

By: Rilwan Agbomeji Former Brazil Presido, Jair Bolsonaro wey dey serve 27 years jail term for attempted coup don do hernia surgery and dem say e successful. Dem carry am comot prison on Wednesday go DF star hospital for Brasília, na im first time e dey out since November. Im wife Michelle talk say operation go well, no wahala, and dem dey wait make e wake from anaesthesia. Doctors talk […]

todayDecember 26, 2025 6

foreign

Pope Leo Xiv Beg Russia, Ukraine Make Dem End War

By: Rilwan Agbomeji Omo Pope Leo XIV carry mata dey clear Russia senior men and Ukraine senior men say make dem get sit down face-to-face talk how to end di war for Ukraine. Speaking for St Peter’s Square Christmas message oh, e pray specially for Ukraine people and call for unity and support for people wey dey suffer across Europe. Di Pope also talk say war no be beta tin […]

todayDecember 25, 2025 6

foreign

How Yemen Govment & Houthi Agree To Release Thousands Prisoners

By: Rilwan Agbomeji Yemen govment and Houthi group don agree to free plenty prisoners afta about two weeks of peace talk for Muscat, Oman. Dis na according to statement wey UN special envoy Hans Grundberg release. Houthi official Abdulqader al-Mortada talk for statement wey e post on x say dem agree to exchange 1,700 Houthi prisoners for 1,200 govment side, including Saudi and Sudan people.  

todayDecember 25, 2025 8

foreign

Two People Kpai As Israeli Drone Strike Eastern Lebanon

By: Rilwan Agbomeji Two people kpai on Thursday as Israeli drone strike hit one minibus for eastern Lebanon, even as ceasefire still dey in place. Lebanon State News Agency NNA talk say di drone hit di vehicle for Hosh al-Sayyed Ali road inside Hermel area. Di attack don raise fresh concern about who break di ceasefire and how di strike take happen. Israeli military spokesman, Avichay Adraee, claim for X […]

todayDecember 25, 2025 9

foreign

Libya Army Oga And Four Others Kpai For Plane Crash Wey Happen For Turkey

By: Rilwan Agbomeji Badness sup for Libya say dia oga of army , Lieutenant General Mohammed al-Haddad, and four senior officers don go kpai for plane crash for Turkey on Tuesday night. Di plane crash happen shortly afta e take off from Ankara, Turkish capital, officials for Turkey and Libya confirm. According to reports say Turkish security men later find di wreckage of di Falcon 50 aircraft for Haymana area […]

todayDecember 24, 2025 5

foreign

Russia Use Drone Take Attack Ukraine

By: Rilwan Agbomeji Zaporizhia oga talk say Russia don launch 704 air attack, including 17 air strike, for Zaporizhia area for di past 24 hours, wey don kill one person and injure three for December 24, 2025, for Ukraine. Ukraine officials talk say overnight drone attack don hit Moscow, wey even start industrial fire for Tula region wey dey south of Russian capital, as retaliation for wetin Russia don do. […]

todayDecember 24, 2025 9

foreign

Lionel Messi Sister Enter Hospital Afta Car Crash

By: Rilwan Agbomeji No be small thing ooo say Argentine superstar, Lionel Messi sister, Maria, get motor crash and like dis like dis, dem don dey drag her mata inside hospital for Miami. Report say all of a sudden she lose control, jam wall as at di time wey pipo rush reach there, she don already pass out Later aproko pipo report say she break her heel, wrist and get […]

todayDecember 23, 2025 10

foreign

Russia Attack Ukraine, Kill 1 Pikin And 3 Others

By: Rilwan Agbomeji  At least three people don kpai, including one four-year-old pikin, as Russia launch new attacks for Zhytomyr region and other parts of Ukraine. According to Ukraine Energy Ministry, Plenty pipo wunjure as Russia target energy facilities across di country. Emergency power cuts don start for some areas, including Kyiv and nearby regions, to manage di gbege.

todayDecember 23, 2025 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app