Lagos

1136 Results / Page 16 of 127

Background

Lagos

Airport Police Grab 13 Suspects Wey Dey Loot Building

By: Esther Daniel Airport Police Command for Lagos don arrest 13 suspects wey allegedly go thief airport  building materials from construction site for Murtala Muhammed International Airport. Airport Police ASP Mohammed Adeola naim konfam dis on Friday. Adeola say na betalicious joinbodi doigns by joint Monitoring Task Force  dem take go gbab di suspects on July 30. Police recover expensive copper cables, iron components and oda building materials from di […]

todayJuly 31, 2026 17

Lagos

LAWMA Lock Shops For Ojuelegba Over Illegal Refuse Dumping

By: Yusuf Abuh Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don cut chain oh, like dis now hand don touch some shops and business places for Tejuosho-Ojuelegba area because say traders dey dump dirty anyhow. Dis one hapun on Thursday after several warnings and repeated failure by di affected traders to obey sanitation rules. LAWMA oga, Dr. Muyiwa Gbadegesin, say di action na to restore clean environment, protect public health and make […]

todayJuly 31, 2026 21

Lagos

Adedeji Omope Promise More Development For Bariga

Bariga LCDA Chairman, Adedeji Omope, don promise more infrastructure, youth empowerment and social programmes for residents. Omope make di promise as Bariga LCDA celebrate her first anniversary in office on Wednesday. During di celebration, more than 2,000 residents receive bags of rice to help reduce di effect of economic hardship. She thank residents for dia support and say di achievements come through teamwork between government and di pipo.

todayJuly 30, 2026 24

Lagos

Police Gbab Suspected Armed Robber for Lagos

Lagos State Police Command don arrest one 29-year-old man wey dem suspect say na armed robber during routine patrol on Wednesday for Igando area of Lagos. Police tuk, tuk person, SP Abimbola Adebisi, naim konfamate dis one say officers sight three men wey dey ride one motorcycle and dey behave funny and na so dem take follow dem up. She say as di suspects see police, dem try run, but […]

todayJuly 30, 2026 47 1

Lagos

Lagos Dey Plan Special Number Plates For Pipo Wey Get Disability

Lagos State Gornment don begin plan to introduce special vehicle number plates for people wey get disability, so movement fit easier and everybody fit enjoy equal access across di state. According to statement from di state gornment, Lagos State Office for Disability Affairs, LASODA, and Lagos State Motor Vehicle Administration Agency, MVAA, na dem dey work together to bring di plan to life. Di idea come after LASODA management visit […]

todayJuly 29, 2026 22

Lagos

Lagos Tighten Safety Rules for High-Rise Buildings

Lagos State Gornment don carry mata for head  dey hawk Lagos problem, say, di way building take collapse don too much, and like dis na to “protesion” every every for di obodo Lagos naim be di goal. Small tin, person go hear, one building don collapse, if nor be building na fire as dem ginger all lagosians to dey very careful with dia safety. Na di oga kpatakpata, Director-General of […]

todayJuly 29, 2026 25

Lagos

Lagos Gornment Open New Olusosun Road For Waste Management

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don commission di new 1.2-kilometre access road inside Ojota, to make waste management easier across di state. According to report dis new road go make possible for betaliocious waste management inside di obodo Nigeria. LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, naim sorosoke dis mata as im ma go inspect di road. Oga Gbadegesin sef con say dis road go make waste movement smooth for […]

todayJuly 29, 2026 23

Lagos

Lagos Varsity Workers Give Gornment 7 Days Or Strike Go Burst

By: Esther Daniel Workers union for Lagos State-owned universities don give Lagos State Gornment seven days to answer dia welfare demands or dem go start indefinite strike. Di Joint Action Committee drop di warning on Monday during press briefing for Lagos State University, as dem demand action on workers welfare issues. Di unions want gornment to show how dem go implement agreement wey affect university workers and release N50,000 palliative […]

todayJuly 28, 2026 25

Lagos

Sanwo-Olu Govt Launch Greenhouse Gas Registry to Fight Climate Change

By: Esther Daniel Lagos State Gornment done launch di Lagos State Greenhouse Gas Registry yesterday inside Lagos to fight climate change and cut carbon emissions. LASEPA General Manager Babatunde Ajayi tok during di event say di initiative go build climate-smart economy for di state. Dis move make Lagos di first sub-national government for Nigeria to create dis kain comprehensive climate data system. E insist say credible data na di main […]

todayJuly 28, 2026 20

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds