Lagos

879 Results / Page 17 of 98

Background

Lagos

Lagos Police Command Kramp 3 Suspected Robbers, Recover Bike, Phones and Weapons

By: Esther Ayoola Lagos State Police Command say dom don do small Rambo arrest three suspected armed robbers for Car Wash Bus-Stop, for Idimu area. According to Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, di operatives on routine patrol naim stop and search di suspects when dem see dem on motorcycle and dem recover machete, army camouflage cloth, four phones, power bank, small cash and Bajaj motorcycle wey dem dey use […]

todayApril 10, 2026 21

Lagos

President Tinubu And Folarin Hold Late Night Meeting For Ikoyi

By: Esther Ayoola Wi Oga Presido, Bola Tinubu don go run small praol with APC chieftain for Oyo State, Teslim Folarin, for him private residence for Ikoyi, Lagos. Folarin naim later dey konfamate dis mata for Facebook page, though im nor really tuk wetin dem discuss for di meeting. People dey reason say di reason for the meeting na because APC dey plan ahead for 2027 Oyo State governorship election […]

todayApril 10, 2026 22

Lagos

How Tanker Block Lagos-Ibadan Expressway Jam On Friday Morning

By: Esther Ayoola Say nor be small hold up for Lagos-Ibadan Expressway on Friday morning, as motors no fit move from Longbridge to Magboro and na so no dey come. According to report, na around 7:30am dis problem start afta one fuel tanker block road near Magboro bridge. Na so pipo dey complain, say e be like say everywhere just stand sti, especially for those wey dey go out of […]

todayApril 10, 2026 10

Lagos

Immigration Boss Suspend Lagos-Seme Border Commanders Say Dem Do Yahoo

By: Esther Ayoola Di Comptroller-General of Nigeria Immigration Service, Kemi Nandap, don shake table remove di commanding officers for Lagos-Seme border corridor, afta online report say di officers do extortion. She tuk say di action na to allow proper investigation and to make sure say all officers wey involve go face disciplinary action. According to NIS tuk, tuk on Friday, Akinsola Akinlabi, di service condemn di alleged bad conduct, say […]

todayApril 10, 2026 13

Lagos

Ogun Bike Snatching Turn Deadly As Rider Lose Life

By: Esther Ayoola Ogun State Police command don do Rambo doings arrest one 27-year-old man, Chidi Ebere, wey bin dey try snatch motorbike from rider and ending up kpaing di drive. According to di Police tuk, tuk, Babaseyi Oluseyi, statement, say di man first enter di bike like passenger for Igbesa area, before e attack di rider. During di struggle, di rider, Sunday Ogbu, try defend himself but di suspect […]

todayApril 10, 2026 11

Lagos

Fulani/Arewa Leaders For Lagos Quash Suspension Rumor Of Dia Chairmo

By: Esther Ayoola Arewa and Fulani leaders don gather stakeholders address dia leadership issues say dem nor suspend Alhji Sa’adu Yusuf Dandare-Gulma as chairmo. Fulani leader for Lagos, Alhaji Mohammad Abubakar, naim dey yan dis mata for dia stakeholders meeting wey dem run on Thursday, say, di suspension story na false and he officially cancel am, insist say Dandare-Gulma sti be chairmo. Other leaders like Mai Kano Lawal and Alhaji […]

todayApril 10, 2026 10

Lagos

President Tinubu Commission Big Tolu Schools Complex For Ajegunle, Lagos

By: Esther Ayoola Wi oga Presido Bola Ahmed Tinubu don inaugurate di remodelled Tolu Schools Complex for Ajegunle, Lagos State. Say, di complex wey dey Ajegunle get 31 secondary schools, 5 primary schools, plus vocational centres, science labs, ICT and robotics hubs. Represented by Senate Presido Godswill Akpabio, oga presido tuk how dis school take be good achievement, say na one of di biggest school collection for Sub-Saharan Africa.

todayApril 10, 2026 12

Lagos

Governor Sanwo-olu Go Commission 36 Schools For Tolu Complex

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu, go commission di Tolu Schools Complex for Ajegunle area of di state on Thursday. Di Tolu Schools Complex dey get 36 public schools, 31 secondary and 5 primary schools wey dey for Ajegunle inside Ajeromi-Ifelodun Local Government Area of Lagos State. Di Tolu Schools Complex get standard football pitch with race tracks, multipurpose sport court for outdoor games, fire service station, health centre, water harvester, […]

todayApril 9, 2026 20

Lagos

Governor  Sanwo-Olu Insists New Opebi-Ojota Bridge Go Cut Traffic For Lagos 

Lagos State govo, Babajide Sanwo-Olu, say like dis Lagosians suppose to dey dance kokoma, dat  new Opebi-Ojota Link Bridge go hellep reduce traffic wahala for residents. E yarn dis one on Wednesday during di commissioning of di bridge and other projects like di Bola Ahmed Tinubu Administrative Complex and Lagos State GIS. According to am, di bridge go make movement easier, reduce pressure for road, and improve how traffic go […]

todayApril 9, 2026 17

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds