Lagos

643 Results / Page 2 of 72

Background

Lagos

FG Declare Serious War Against Small Sachet Alcohol

Say Federal Gornment don start campaign to stop alcohol wey dey for small sachets and bottles wey no reach 200ml. Di ban wey start from January 1, 2026, go stop production, sale, and distribution of sachet and small bottles alcohol. Untop tuk tuk with tori pipo for Abuja, NAFDAC DG, Professor Mojisola Adeyeye, say dem don do plenty consultation and di ban na because many minors dey drink alcohol.

todayMarch 4, 2026 8

Lagos

How Lagos Assembly Take Approve LASUSTECH Land Compensation

Lagos State House of Assembly don approve Committee on Rules and Business recommendation wey concern land wahala between Eyingbala family and LASUSTECH, Ikorodu. Majority Leader and Chairman of di Committee, Noheem Adams, tell House yesterday say di Eyingbala pipo na be di original owners of di land wey dey inside LASUSTECH premises, and dat gornment suppose give dem 50 hectares as compensation. Di decision follow long-standing petition wey di family […]

todayMarch 3, 2026 6

Lagos

Governor Sanwo-Olu Promise Package For State Retirees

Governor Babajide Sanwo-Olu say Lagos State gornment go continue to respect retirees and treat dem with dignity, fairness, and equality. Im tuk dis one during a courtesy visit by PTAD Executive Secretary, Tolulope Odunaiya, for Lagos House, Marina. Sanwo-Olu also explain oh, say dem don do reforms for pension system to reflect di reality of today so dat retirees go benefit wella. E add say, im gornment dey serious to […]

todayMarch 3, 2026 4

Lagos

Lagos To Host 3rd Edition Of City Art Day

Lagos Gallery Weekend (LGW) don announce say dem go hold di 3rd edition of dia city-wide art show from March 5 reach 8, 2026, for Lagos, wey go spotlight di creative energy of di city. Director of LGW, Sunshine Alaibe, clear dis mata inside tuk tuk sitting for Ikoyi, say di theme dis year na “Art for All,” to make art accessible to everybody. Say pipo fit see beautiful art […]

todayMarch 2, 2026 3

Lagos

Lagos Gorment To Shut Ogunnusi Road For Rebuilding

Lagos State Gornment, say dem wan begin Phase I of di reconstruction of Ogunnusi Road from Ojodu Berger to Mobil Filling Station Junction for Ikeja and don arrange plans to manage traffic. Say di Phase I na 4.5 kilometre stretch, and dat di work go last from March 6, 2026 reach February 6, 2027, and no vehicle go fit enter di work zone. Motorists wey dey go Ijaye or Agege […]

todayMarch 2, 2026 4

Lagos

Police Commissioner Explain How Join bodi Go Hellep Stop Insecurity

Key joinbodi pipo don do meeting call for stronger way to prevent fight fight and bring beta security to Lagos state. Di meeting wey di Lagos State Police Commissioner,  CP Olohundare Moshood dey  present for register, explain policing, na so big names of di security mata put body for di meeting for Alausa Ikeja. Afta di meeting, oga police Commissioner tuk im mind oh wetin nor good, say na corperation […]

todayMarch 2, 2026 2

Lagos

NLC, FOBTOB Lock NAFDAC Office For Isolo, Protest Di Ban Of Sachet Alcohol

By: Esther Ayoola Members of di Naija Labour Congress (NLC) and di Food, Beverage and Tobacco Senior Staff Association (FOBTOB) don sti go block di office of di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) for Isolo, Lagos,  dey shout say “No work for us, no work for you,”. Say di protest cause serious wahala as NAFDAC staff no fit enter the Lagos office until police from […]

todayFebruary 27, 2026 1

Lagos

Customs Join Bodi Wit Navy To Secure Apapa Port

By: Esther Ayoola Apapa Area Command of Naija Customs like dis, don join body wit Nigerian Navy to make port security strong and trade smooth. Customs Area Controller, Comptroller Emmanuel Oshoba, ni go visit Rear Admiral Abubakar Mustapha, di Flag Officer Commanding Western Naval Command, dey  share dis beta collabo. Oshoba say di visit na part of di three policy palava of Consolidation, Collaboration, and Innovation wey di Comptroller-General of […]

todayFebruary 27, 2026 1

Lagos

Lagos Assembly To Stop Further Demolitions For Makoko, Shogunle

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly don komfam say dem no go allow any more demolitions for Makoko and Shogunle. On Thursday, during committee meeting with community leaders, Speaker Mudashiru Obasa, through Majority Leader Noheem Adams, fry mouth wetin on wetin dem wan do now, say each community go form 10-person committee to work with gornment. Di Lawmakers say dem go finish settlement with di communities within two […]

todayFebruary 27, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app