Lagos

1135 Results / Page 4 of 127

Background

Lagos

Lagos Uni Workers Enter Indefinite Strike Over Unpaid Arrears

By: Mariam Ajayi Workers for Lagos State gornment owned universities don enter indefinite strike over wetin dem describe as gornment failure to fulfil agreements with di unions. Di workers, under Joint Action Committee, JAC, include ASUU, SSANU, NAAT and NASU, and di strike affect LASU, LASUED, LASUSTECH and LASUCOM. JAC Chairman, Prof. Ibraheem Bakare, say di unions don try dialogue but dem don exhaust all channels to resolve di matter, […]

todayOctober 2, 2026 14

Lagos

Hamzat Tuk Say E Go Stop Agbero Money Collection For Lagos

By: Mariam Ajayi APC Lagos gorfnorship candidate, Obafemi Hamzat, don promise to stop unauthorised money collection from agbero and roadside transport operators if elected governor. Hamzat make di promise during governorship candidates town hall meeting for Lagos, where im say transport operators suppose know exactly wetin dem dey pay. Im also propose State Economic Council wey go bring state and local governments together to streamline levies, so people wey don […]

todayOctober 2, 2026 18

Lagos

Lagos Gofment Finally Agree Say Lagos Dirty Nor Be Today Mata

By: Mariam Ajayi Lagos State Gornment don finnally confess say dirty take full lagos, dia mind dey shake,  say operational wahala dey ground. Na oga Commissioner Tokunbo Wahab yarn dis one as im dey reply the 2027 ADC gofnorship candidate, Gbadebo Rhodes-Vivour, wey bin criticize dem say everywia for Lagos dey smell like soakaway because of waste and flood. Rhodes-Vivour bin fire di lagos state gorment inside TV sit down […]

todayOctober 2, 2026 10

Lagos

Sanwo-Olu Tell Nigerians Make Dem Unite and Love Nigeria

Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu, don call on Nigerians to come together, love dia country and play dia part as Nigeria dey celebrate 66th Independence anniversary. Sanwo-Olu, wey be Chairman of South-West Governors’ Forum, tell Nigerians, especially Lagosians, make dem learn from di strength and determination of di pipu wey fight for Nigeria independence and help build better country. Di Govo tok dis one for Independence Day message wey im Special […]

todayOctober 1, 2026 11

Lagos

How Lagosians Take Fall Hand Rush Beer After Road Askident

Kwake, dem say, problem everywia, na yesterday for Ajegunle, wia one beer truck don go get askident with one dispatch rider and two vehicles for Abalti Barracks, as bottles of beer scatter for road and commuters rush to pick dem dey drink. LASTMA officials na so dem enter di area dey form defend, dey defend beer wetin nor gud. According by di LASTMA tok, tok, Adebayo Taofeeq, say the truck […]

todaySeptember 30, 2026 19

Lagos

Hamzat Promise More Focus On Tech, Education And Health

By: Mariam Ajayi Lagos State Deputy Gofnor, Dr Obafemi Hamzat, don promise to make technology, education, healthcare, youth development and support for businesses part of im agenda for di state. Hamzat, wey be APC governorship candidate for di 2027 election, say im vision na to create environment wey businesses fit grow and make government systems work better. E talk dis one on Monday for event wey 7-Fifteen Capital organise for […]

todaySeptember 29, 2026 16

Lagos

Fire Scarra Property Worth Millions for Apapa Customs Office

By: Mariam Ajayi Fire don scarra di Nigeria Customs Service Western Marine Command office for Apapa, Lagos, and destroy property worth millions of naira on Monday morning. Di fire wey start around 10:23 am, say na NEPA light burn enter di  conference room, con quick spread to other parts of di building before Lagos State fire service come help quench di fire. Di new Deputy Comptroller of Customs, Timothy Jonah, […]

todaySeptember 29, 2026 12

Lagos

Lagos CP Beg Pipo Make Dem Respect Police For Road

By: Mariam Ajayi Lagos State Commissioner of Police, CP Fatai Tijani, don call on Lagos pipo make dem stop to disrespect police wey dey road. Dis one na to secure lives and property, as him say if police no dey road, fear go take over everywhere. CP Tijani talk dis one on Monday, September 28, 2026, during press briefing with tori pipu for Lagos State Police Command headquarters for Ikeja, […]

todaySeptember 29, 2026 11

Lagos

Lagos Police Kramp 32 Suspects For Robbery, Other Crimes

By: Mariam Ajayi Oga Police Commissioner Tijani Fatai parade thirty-two suspects wey dem kramp for different criminal mata, like armed robbery, cultism, and killing of police officer. Senior man Commissioner, CP Tijani Fatai, naim by himself porporly dis mata give tori pipo today for dia headquarters Tijani say untop di police Rambo doings, dem  recover plenty things including guns, ammunition, stolen cars, and two million five hundred thousand naira cash. […]

todaySeptember 29, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds