Lagos

647 Results / Page 24 of 72

Background

Lagos

Two Pipo Kpai For Cult Wahala For Ajah, Lagos

By: Rilwan Agbomeji Unto wahala report for Lagos, say two people, wey dem never fit get name na kpai for  suspected cult warling warling for Ajah area, Lagos state. Kofam aproko gather say, di incident happen for Tuesday night. Dem talk say di attackers enter one crowded area near Ikota complex, come start to dey shoot anyhow. Di shooting make plenty people for community and market run for safety, cause […]

todayDecember 11, 2025 10

Lagos

Lagos Police Kramp Two Traffic Robbers

By: Esther Ayoola Unto securioty doings, like dis, lagos police comand  don kramp two suspected traffic robbers for same place wia one woman blow alarm say gang dey wori pipo for ojota-ketu road, just one day ago. Di women, bin package message send directly to di Lagos Police Public Relations Officer, via X, SP Abimbola Adebisi, She yarn say four boys rush her car for ojota bridge for broad daylight, […]

todayDecember 10, 2025 16

Lagos

Govo Sanwo-Olu Talk Why Im Swear For New University Council

By: Rilwan Agbomeji In order to secure di leaders of tomorrow wella wella, Lagos State Govo Babajide Sanwo-olu don officially inaugurate new shaka chairmo and members of Lagos State University governing council for Lagos House, Ikeja. Di event gather top state officials and university leaders to support better governance for higher education. Governor yarn say, Lasu dey important for shaping young people future and boosting state academic reputation, and e […]

todayDecember 10, 2025 9

Lagos

Lagos Gorment Tell Civil Servants To Follow Computer Law

By: Esther Ayoola Unto computer movement, di lagos state don remix di 2025 public service rules, say dem no wan civil service wey dey drag leg again for this modern world. Head of service, Bode Agoro, nai tanda gigigba  yesterday dey tell state  workers say di old 2015 law book don old to run mata for modern time, and dat e no fit handle today digital speed and global standards […]

todayDecember 10, 2025 9

Lagos

Three Die As Three Motor Jam Demselves For Lagos-Ibadan Expressway

By: Esther Ayoola Wahala nor dey finish, say another one don burst for Lagos Ibadan express way  wia three motor jam demselves, three people  kpai on the spot  and plenty others dey hospital dey take treatment. Lagos state traffic management authority (LASTMA) confamate give tori pipo say the accident spoil things for the area. The koko happen near secretariat, as people dey waka go Otedola bridge, traffic jam choke everywhere. […]

todayDecember 10, 2025 6

Lagos

Lagos Apc Shake Opposition With Talks Not To Disturb Tinubu

By: Rilwan Agbomeji Lagos branch of di All Progressives Congress (APC) dey vex carry matter for head dat make opposition no dey disturb president Bola Tinubu with “fake politicking and fake wahala” as 2027 dey waka  don near. APC lagos tuk tuk, seye oladejo,  ni dey yarn dis one dey  talk say dis time no be for confused coalitions or any political experiments. Di warning follow afta ADC yarn peter […]

todayDecember 9, 2025 8

Lagos

Lagos Govment Say No Structures Wey Dey Under High-Tension

By: Rilwan Agbomeji Lagos State government tire shirt oh say say dem go begin remove any building or structure wey people build under high-tension wire because e dey dangerous for residents. Na for inspection waka wey dem go do for Third Mainland Bridge area, Special Adviser Olajide Babatunde  yarn dis one as im see plenty shanty and illegal structures wey no suppose dey di 50-metre right-of-way, im belle even turn […]

todayDecember 9, 2025 11 2

Lagos

Lagos APC Shake Opposition With Talks Not To Disturb Tinubu

By: Esther Ayoola Lagos branch of the alll progressives congress (APC) dey vex carry matter for head that  make opposition no dey disturb president bola tinubu with “fake politicking and fake wahala” as 2027 dey waka  don near. APC Lagos tuk ,tuk, Seye Oladejo,  ni dey yan this one dey  talk say dis time no be for confused coalitions or any political experiments. Di warning follow after adc yan peter […]

todayDecember 9, 2025 7

Lagos

Accident Scatter Lagos Ogun Road

By: Esther Ayoola Better  two days never pass wey  two people kpie for Ososa, Ogun State, another badness don sup again for  early  mor mor on Monday, say  one truck driver and him passenger kpai instantly after their truck jam trailer from back. Lagos State Traffic Management Authority (LASMA) spokesperson Adebayo Taofiq confirm say di crash happen for midnight when di truck run enter di trailer wey dey front. Same […]

todayDecember 9, 2025 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app