Lagos

1142 Results / Page 28 of 127

Background

Lagos

Lagos Barbar Pursue Guiness World Record

Say like dis Guinness world record, dey monitor one 24-year-old hairstylist, Ikechukwu Damilola wey dem dey call “Transformation King,” wey wan break world record, say im don reach 90 hours out of 120-hour to break Guinness World Record hairdressing marathon for Lagos. Di attempt dey happen for Oto-Awori Local Council Development Area for Ijanikin and GWR officials dey monitor am. Chairmo of di LCDA, Mr. Kareem Abiodun, talk say di […]

todayJune 15, 2026 17

Lagos

NDLEA Kramp Brazil Businessman

Operatives of National Drug Law Enforcement Agency don arrest a 41-year-old Nigerian businessman, Abugu Ikechukwu, for Lagos airport say dem gbab am with liquid cocaine inside shirts and towels. According to NDLEA tuk, tuk, Femi Babafemi, Di man, just land for Murtala Muhammed International Airport from Brazil via Ethiopia, wan bin dodge enter Nigeria, not knowing say mehn dey at alert for di airport. Babafemi say dia test confirm di […]

todayJune 15, 2026 12 12

Lagos

Lagos Police To Arrest Cars

Lagos State Police Command don announce say dem go start statewide jogolo against motors wey get covered, fake, defaced or no plate number to improve security and reduce crime. Police tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi, talk say di order come from Inspector-General of Police, Olatunji Disu, and e go start on Monday, June 15, 2026, under CP Tijani Fatai supervision. To tell u how di mata serious reach, commissioner of […]

todayJune 15, 2026 25 1

Lagos

Falz, Femi Falana Join Protest For Lagos

Nigerian rapper, Folarin Falana ,AKA Falz di bad guy, sef join protesters for Ikeja Underbridge, Lagos, on Friday to demand action against rising insecurity, economic hardship and bad governance across di country. Di protest, wey im join alongside im papa, human rights lawyer Femi Falana, and other activists, organise, pin point say enough don dey enough and dat Democracy Without Security na zero Falz drop some bars during di protest, […]

todayJune 12, 2026 43

Lagos

Csos And Youth Enter Street Say Cost of Living Wan Kpai Di Living

By: Shalom Ovie Plenti civil society groups, trade unions, and youth omo don go mout Ikeja Under Bridge for Lagos dey shout wi nor go gree, wi nor go gree, dat insecurity, and cost of living wan kpai di living. Di pipo pack demsef out to call on Federal Gornment say make dem consider di common man, say hunger dey di country.Dos wey dey protest, cry out say di way […]

todayJune 12, 2026 18

Lagos

Lagos Clean Up With International Mehn

Clean lagos, clean lagos, u dey feel say na play play, yesterday, lagos environmental pipo cary some senior mehn, show dem shegge, tell dem to clean. Dis na mehn wey dey in charge of international exchange, an dem  carry di senior exchange pipo go clean lagos Marina, to mark World Environment Day 2026. Di programme hapun in collabo with Lagos State Waste Management Authority and Recyclers Association of Nigeria to […]

todayJune 12, 2026 18

Lagos

Sanwo-Olu Show New Team To Run Lagos Gorment

By : Shalom Ovie Lagos Govo, Babajide Sanwo-Olu don present Deputy Govo, Obafemi Hamzat and senior lady Princess Damilola James as di team wey go carry Lagos gofnorship ticket. Di govo tok for news statement say di pair get di experience, vision and capacity to continue di development wey Lagos don enjoy over di years. According to am, di ticket represent di strength, diversity and bright future of Lagos State. […]

todayJune 11, 2026 30

Lagos

APC Aspirants clear Obasa name say Nor be im Sponsor Lagos Protest

By: Shalom Ovie Some All Progessives Congress aspirants for Lagos don explain how Speaker Mudashiru Obasa hand nor dey inside di protest over di party primaries. According to di protesters, say na based on say many election ground nor package di wey e suppose be naim make, di election scatta Di group also reject claim say Obasa give N2 billion to support di demonstration. Dem insist say angry party members […]

todayJune 11, 2026 21

Lagos

IKOSI-KETU Pipo Cry Out Over Cost of Living

Normally na di duty of every gorment of a country to balance tins, for citizen to survive, however e be like water don pass garri for obodo Nigeria. Complain here and there, unto di rising cost of living, konfam news tatafo, Esther Ayoola enter di street of Lagos, to tell us, how Lagos dey cope with di new cost of living.

todayJune 11, 2026 16

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds