Lagos

784 Results / Page 27 of 88

Background

Lagos

Bible Society Beg FG Not To Kill Indigenous Languages

By: Esther Ayoola Naija Bible Society don put dia voice for di ban of indigenous language use for our schools, say make wi Federal Gornment rethink, dat e go kill our own cultural tongue. Oga Bible society, CEO, Pastor Samuel Sanusi, na dey yarn dis one for tori tori sitting with aproko pipo for Lagos, say plenty Nigerian languages don dey die because of di move by wi federal gorment. […]

todayJanuary 26, 2026 12

Lagos

Drunk Driver Land Hospital After E Jam Truck For Lagos

By: Esther Ayoola One yet to be identified driver don go drive wawa go jam truck for Ebute-Ero, Apongbon, Lagos, and like dis, im  don land for hospital. Lagos State Traffic Management Authority tuk tuk, Adebayo Taofiq, konfamate dis mata,  say e be like di  driver  drink wetin nor good. Taofiq press tuks dat, Investigation show say e bin dey speed when e run enter di truck wey dey on […]

todayJanuary 26, 2026 8

Lagos

Why Dirty Full Lagos Streets, LAWMA Blame Population

By: Esther Ayoola Say Dorti don full everywia for streets for Lagos, business areas, making pipo to fear for dia lives. According to Lagos Waste Management Authority, LAWMA say di mata no be only about truck or workers, but also pipo behaviour and how residents dey handle dia waste. LAWMA boss, Dr Muyiwa Gbadegesin, Lagos get about 27 million pipo and each person dey produce about half kilo of waste […]

todayJanuary 26, 2026 8

Lagos

Lagos Gorment Put Pledge To Fix Drainage

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don repeat tuk,say dem go continue to improve and strengthen drainage system for across di state. Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, yarn dis one, when e tuk to journalists afta e go inspect different drainage projects wey dey on. Oga environmental commissioner say di heavy rain wey fall for dis new year don show say climate change and global warming get […]

todayJanuary 26, 2026 8

Lagos

FG Ban Discos From Charging For Meters, Threaten Sanctions

By: Esther Ayoola Federal Gornment don ban all electricity distribution companies (DisCos) and installers from collecting any payment for meters. Minister of Power, Adebayo Adelabu, yarn dis to tori pipo during inspection of newly imported smart meters at APM Terminals, Apapa, Lagos. Adelabu explain say di meters, wey be part of World Bank–funded Distribution Sector Recovery Programme (DISREP), must be installed free for all consumers, and anyone wey demand money […]

todayJanuary 23, 2026 13

Lagos

Police Deploy Officers To Ikeja Schools Afta Threat Message

By: Esther Ayoola Lagos State Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, don order permanent deployment of police to Grange School and Greensprings School for Ikeja, afta threat of attack. Dis move dey  follow WhatsApp messages wey unknown Jaguda boys send, threaten security of di schools. U sabi says konfam been report say make aproko pipo stop to dey spread fake news. In response to di threat even though di police don […]

todayJanuary 23, 2026 9

Lagos

One Kpai, As Multiple Crashes Block Otedola Bridge

By: Esther Ayoola One person don go Kpai afta trailers jam Jam demsleves  for Otedola Bridge, Lagos, early mor mor on  Friday, and say e cause serious traffic jam along Lagos–Ibadan Expressway. According to di Lagos State Traffic management Agency tuk tuk person,  Adebayo Taofiq, di main askident involve two heavy-duty trailers, one wey carry sand, the other one carry granite,  ni jam demsleves igboaii. Say Di driver of wey […]

todayJanuary 23, 2026 4

Lagos

Lagos Police Blow Hot, Clear School Bombing Tori

By: Esther Ayoola Lagos State Police Commissioner, CP Olohundare Jimoh through di command tuk, tuk, SP Abimbola Adebisi don sama beta warning to all Aproko pipo for Lagos to  stop di  spread fake news. Dis warning follow news comot, afta aproko pipo begin spread rumor say, jaguda boys dey plan bomb two private schools for Ikeja. Adebisi explain, say Di Human Resources Manager and Chief Security Officer of di schools […]

todayJanuary 23, 2026 5 1

Lagos

Early Mor Mor Fire Burn Ajegunle Clothes Market

By: Esther Ayoola Say one Early mor mor fire don destroy one-storey shopping complex, wey dey Ajegunle Boundary, Lagos, wia business pipo dey sell clothes. No life loss for di fire except for for plenty money, di Lagos State Emergency Management Agency, LASEMA ni dey konfamate dis tori. LASEMA Permanent Secretary, Olufemi Oke-Osanyintolu, explain say dem receive distress call around 2:40 a.m. and reach di scene by 3:22 a.m., but […]

todayJanuary 23, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds