Lagos

544 Results / Page 42 of 61

Background

Lagos

Driver Don Enter Cell As Two People Die For Lagos Road Crash

Two people don kpai for two separate road accidents wey happen for LASU-Igando road and Osborne Expressway for Lagos State. One of di accidents involve truck wey brake fail, lose control and jam pedestrian wey dey waka for roadside. According to LASTMA Public Affairs Director, Adebayo Taofiq, di accident happen for Simpson Street, Osborne Expressway, near Traffic Light Junction. Di truck wey dey speed wella get sudden brake failure, and […]

todayOctober 20, 2025 13

Lagos

Lagos Seal Proposed Cemetery Site After Surulere People Para

Lagos State govment don seal one proposed cemetery construction site for Bode Thomas area inside Surulere after residents of Natufe/Animashaun community protest say dem no want burial ground near dia houses. Di people vex say if dem build cemetery for dat area, e go pollute dia borehole water wey na wetin dem dey drink since dem no get pipe-borne water. Even as rain dey fall on Saturday, residents still come […]

todayOctober 20, 2025 14 1

Lagos

State Houses of Assembly Too Weak, Docile – Ikuforji, Former Lagos Speaker

Former Speaker of Lagos State House of Assembly, Adeyemi Ikuforiji don talk say Nigerians suppose hold state governors and local government chairmen responsible for governance, instead of always blaming di federal government. As e talk for him office for Lagos dis week, Ikuforiji point say state and LGs dey collect over 50% of federal allocation, yet citizens no dey hold dem to account. E say people get better access to […]

todayOctober 17, 2025 13

Lagos

Lagos Dey Redefine Agriculture As Engine For Growth, Sustainability – Sanwo-Olu

Govnor Babajide Olusola Sanwo-Olu don yan say him administration dey fully committed to turn agriculture into strong engine wey go bring growth, carry everybody along, and keep things sustainable. E talk dis one on Thursday for di 2025 World Food Day celebration wey happen for Police College, Ikeja. Di theme na “Hand in Hand for Better Foods and a Better Future.” Sanwo-Olu, wey Barrister Bimbola Salu-Hundeyin, di Secretary to di […]

todayOctober 17, 2025 14

Lagos

Commuters Dey Groan As Bad Road Don Cripple Movement For Lekki-Epe Corridor

People for Lagos Mainland dey suffer badly because roads don spoil, and now those wey dey live along Lekki–Epe Expressway dey join in di complain, dem dey waste hours inside traffic because road condition don kpeme. Even though plenty rich people and costly estates dey dat area, inner roads and main roads don remain battered. Commuters and residents dey lament say roads don bad reach level wey transport fare don […]

todayOctober 17, 2025 11

Lagos

Lagos Don Tell Residents Make Dem Collect Building Permit Before Dem Build Anything

Lagos State Government don beg residents make dem collect planning permit before dem go build any property. Dr. Oluyinka Olumide, Commissioner for Physical Planning and Urban Development, talk this one during public awareness programme wey dem hold Thursday for Ojo. Dem invite community leaders, residents, and stakeholders from areas like Ojo, Badagry, Iba, Oto‑Awori, Amuwo‑Odofin, Oriade and Olorunda. Olumide yarn say permit no na small thing, na law, e dey […]

todayOctober 17, 2025 12

Lagos

Train Crush Dispatch Rider To D£ath For Lagos (Photos)

One dispatch rider don k0mot de@th after train crush am for Lagos. The gbege happen today, October 16, for PWD Railway Level Crossing, Ikeja. Lagos State Traffic Management Authority (LASTMA) yan say dem still dey beg people to dey careful and follow traffic rules well. The rider, wey get motorcycle number plate AGL 179 QR, try cross railway line when train dey come close. The crash happen near road wey […]

todayOctober 17, 2025 11

Lagos

Moment KAI Officials Seize Pot And Food As Actress Sarah Martins Dey Cook For Poor People For Road Median For Lagos (Video)

One video don surface online wey show di moment Lagos Environmental Sanitation Corps (LAGESC), wey people sabi as KAI (Kick Against Indiscipline), confront Nollywood actress Sarah Martins as she dey cook for road median to share food give poor people. For di video, KAI officials storm di area, begin seize her cooking utensils and food items while she still dey sit down dey cook. Sarah Martins beg dem say na […]

todayOctober 17, 2025 20

Lagos

LASG Seal 11 Facilities For Environmental Wahala

Di Lagos State Environmental Protection Agency (LASEPA) don seal 11 different establishments for Ikorodu say dem no follow environmental rules, especially noise wahala and other dirty behaviours. For statement wey dem post on X on Thursday, LASEPA talk say di enforcement happen for key areas like Agodo Gas Line, Odogunyan Industrial Layout, Ita Oluwo Junction, Haruna, Ipakodo Road, and Ebute. Di places wey chop seal include bars, lounges, hotels, and […]

todayOctober 17, 2025 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app