Lagos

1138 Results / Page 40 of 127

Background

Lagos

Lagos Gorment Tell Employers to Check Workers Mental Health

Lagos State Gornment don tell employers make dem dey use Employee Assistance Programme to support workers mental health and improve safety for work. Dis one come as dem mark World Safety Day wey dey happen every April 28, as Lagos State Safety Commission release statement for Monday. Di Director-General of di Commission, Lanre Mojola, still congratulate workers, employers and safety people for di important day. Dem also tuk say even […]

todayApril 28, 2026 18

Lagos

Hamzat Thank Sanwo-Olu For Endorsing Im Push For 2027 Governorship Race

By: Esther Ayoola Lagos Deputy govo, Obafemi Hamzat don show appreciation to Babajide Sanwo-Olu afta e endorse am as preferred successor for 2027 governorship election for Lagos State Naija. Hamzat tuk dis one on Monday for him X handle, say di endorsement na big vote of confidence on his  leadership and service to Lagos people. Di deputy governor also promise say if dem give am chance, e go continue good […]

todayApril 27, 2026 27

Lagos

BREAKING: Sanwo-Olu Back Hamzat for Lagos Governorship Race

By: Esther Ayoola Lagos state govo, Babajide Sanwo-Olu like dis don join endorse im deputy, Kadri Hamzat, as All Progressives Congress candidate for 2027 governorship election for Lagos. Sanwo-Olu make di announcement for Lagos House, Marina, in presence of state executive council members, APC leaders, and all 57 local government and LCDA chairmen. Di governor say Hamzat get enough experience and deep knowledge to lead di state, na why e […]

todayApril 27, 2026 19

Lagos

LASTMA Give Report Say Na 69 Kpai, 246 Wunjure For Lagos Road Crash Q1 2026

By: Esther Ayoola Lagos State Traffic Management Authority tuk say na about 69 pipo don kpai like dis for road askident across Lagos between January and March 2026, while 246 others get wunjuries. LASTMA General Manager, Olalekan Bakare-Oki naim yarn dis one for interview with News tatafo on Sunday. Say drivers just dey drive wawa and naim dey cause all these askidents. E sti tuk say dem clear over 600 […]

todayApril 27, 2026 26

Lagos

How Lagos Gorment Enter 60MW Power Deal With 3 Electricity Company

By: Esther Ayoola Lagos State gorment, don do small megege movement sign Power Purchase Agreements with three companies, Fenchurch Power, Mainland Power and Viathan Group to generate about 60MW electricity for di state. Senior man govo, Babajide Sanwo-Olu naim lead di way, put dis one for statement on Sunday, say di agreement as part actions to improve power supply under Lagos Electricity Law 2024 and Nigerian Electricity Act. Di signing […]

todayApril 27, 2026 21

Lagos

Lagos Taskforce Gbab 50 Area Boys Across Di State

Say Lagos State Environmental and Special Offences Unit (Taskforce) arrest about 50 suspected hoodlums during statewide environmental sanitation enforcement for Lagos. Dem carry out di operation across many hotspots like Ikeja, Agege, Abule-Egba, Iyana-Ipaja, Ijora, Lekki–Ajah Expressway and others, say dem do dia touch lighting wella. Chairmo of di Taskforce, Adetayo Akerele, na im dey convasate dis mata, say dem monitor di exercise wella and ensure say vehicular movement and […]

todayApril 27, 2026 47

Lagos

Police Oga Disu Order Make Police Officers Show Respect to Citizens

Oga inspector General of Police, Olatunji Disu don charge officers of Nigeria Police Force, Akelebe, say make dem try to dey get respect for members of di public. DI IGP give di directive during one courtesy visit to Lagos Govo Office, Alausa, Ikeja for Lagos. For Disu, say beta policing dey depend on cooperation and trust between police and di public.

todayApril 27, 2026 25

Lagos

Gbajabiamila Back Hamzat for Lagos Governorship Race

Chief of Staff to wi oga Presido, Femi Gbajabiamila, don openly back Lagos deputy governor, Obafemi Hamzat, for Lagos governorship election 2027. Di Chief of Staff make di declaration after Hamzat and top APC leaders visit am for im Oniru residence for Lagos on Sunday. According to Gbajabiamila, say Hamzat get beta leadership, and e get full confidence say, baba Hamzat go carry Lagos go higher level.

todayApril 27, 2026 75

Lagos

Na 69 People Kpai For Lagos Road For First Quarter 2026 — LASTMA

Lagos State Traffic Management Authority talk say 69 people don die for road across di state for first quarter of 2026. Na di General Manager of LASTMA, Olalekan Bakare-Oki, drop di information during interview with News Agency of Nigeria (NAN) on Sunday for Lagos. Bakare-Oki still add say di authority clear more than 600 accident scenes within di period, and di authority also tuk say 246 oda people sustain different […]

todayApril 26, 2026 25

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds