Lagos

988 Results / Page 41 of 110

Background

Lagos

NLC, FOBTOB Lock NAFDAC Office For Isolo, Protest Di Ban Of Sachet Alcohol

By: Esther Ayoola Members of di Naija Labour Congress (NLC) and di Food, Beverage and Tobacco Senior Staff Association (FOBTOB) don sti go block di office of di National Agency for Food and Drug Administration and Control (NAFDAC) for Isolo, Lagos,  dey shout say “No work for us, no work for you,”. Say di protest cause serious wahala as NAFDAC staff no fit enter the Lagos office until police from […]

todayFebruary 27, 2026 15

Lagos

Customs Join Bodi Wit Navy To Secure Apapa Port

By: Esther Ayoola Apapa Area Command of Naija Customs like dis, don join body wit Nigerian Navy to make port security strong and trade smooth. Customs Area Controller, Comptroller Emmanuel Oshoba, ni go visit Rear Admiral Abubakar Mustapha, di Flag Officer Commanding Western Naval Command, dey  share dis beta collabo. Oshoba say di visit na part of di three policy palava of Consolidation, Collaboration, and Innovation wey di Comptroller-General of […]

todayFebruary 27, 2026 9

Lagos

Lagos Assembly To Stop Further Demolitions For Makoko, Shogunle

By: Esther Ayoola Lagos State House of Assembly don komfam say dem no go allow any more demolitions for Makoko and Shogunle. On Thursday, during committee meeting with community leaders, Speaker Mudashiru Obasa, through Majority Leader Noheem Adams, fry mouth wetin on wetin dem wan do now, say each community go form 10-person committee to work with gornment. Di Lawmakers say dem go finish settlement with di communities within two […]

todayFebruary 27, 2026 12

Lagos

NASS Insist Say, Dem Must Check Wetin Cause Fire For Lagos International Airport

By: Esther Ayoola Members of wi National Assembly don open mata, say dem dey wait, dem dey make Federal Airports Authority of Naija (FAAN) finish im investigation into di fire wey happen for Murtala Muhammed International Airport, Lagos on Monday. Say afta dat, dem go check dia own, to know wetin really cause di fire. U sabi, FAAN Chairmo, Abdullahi Ganduje, commend di airport management for how dem handle di […]

todayFebruary 27, 2026 16

Lagos

Olatunji Disu Enter Office As Acting IGP  

Olatunji Disu don enter office as new acting IGP for Nigeria Police Force, as e begin carry big security responsibility for country. Disu take over on Wednesday, become di new police oga wey go dey control security operations for obodo Nigeria. E talk say e go push for serious policing to help fight jaguda doings for inside Nigerian. People dey watch sharp sharp to see how im leadership go change […]

todayFebruary 26, 2026 12

Lagos

Sanwo-Olu Hail Disu As E Become Acting IGP

Lagos state govo, Babajide Sanwo-Olu don hail Olatunji Disu as President Bola Tinubu appoint am Acting IGP for Nigeria Police Force. Sanwo-Olu talk say Disu deserve di work because im don serve police with strong mind, professionalism, and over 30 years oga-level experience. E still yarn say Disu be seasoned officer wey don show leadership for different serious police assignments before and e sure say Disu go perform well for […]

todayFebruary 26, 2026 15

Lagos

President Tinubu Appoint Tunji Disu As Acting Police IGP Afta Egbetokun Resign

By: Esther Ayoola Wi President Bola Tinubu don appoint Assistant Inspector-General of Police Tunji Disu as Acting Inspector-General of Police afta Kayode Egbetokun resign from di position. For statement wey presidential tuk,tuk Bayo Onanuga release on Tuesday night, di President say di appointment take effect immediately because of security challenges for di country. Dem say according to Police Act 2020, Tinubu go soon call meeting for Naija Police Council to […]

todayFebruary 25, 2026 21

Lagos

Lagos CAN Name Dia New Secretariat Afta Oluremi Tinubu for Alausa

By: Esther Ayoola Lagos State branch of Christian Association of Nigeria don rename dia permanent secretariat afta Oluremi Tinubu, almost 30 years afta dem open di place. U sabi say di building wey dem dey name “Senator Oluremi Tinubu CAN Lagos State Secretariat” for Alausa, Ikeja, na Daniel Okoh, di national president of CAN, na im officially open am. Okoh praise Lagos CAN members for dia ogbonge doings and unity […]

todayFebruary 25, 2026 16

Lagos

Govo Sanwo Olu Make President Tinubu Get Happy Ending

By: Esther Ayoola Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don yarn update, say oga presido, Bola Tinubu dey happy, as Lagos dey plan to set up Lagos International Financial Centre (LIFC). Sanwo-Olu yarn dis one for statement wey govo media tuk tuk, Gboyega Akosile sign on Monday. Say di di training na Lagos International Financial Centre organize am, TheCityUK run am, and UK government fund am. Sanwo-Olu say LIFC no be […]

todayFebruary 24, 2026 13

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds