Lagos

786 Results / Page 62 of 88

Background

Lagos

LASTMA Don See Fake Gun Under Costain Bridge, Discover Over 200 Criminal Hideouts

Di Lagos State Government don carry out one heavy enforcement waka wey scatter over 200 illegal shanties, chase squatters comot, and clear abandoned motors wey full Apapa Road, Ijora and Costain under bridge area. Di massive operation wey di Special Adviser to Governor on Transportation, Hon. Sola Giwa, lead involve different government agencies join body clean di place wey don turn hideout for bad people and rubbish everywhere. During di […]

todayNovember 3, 2025 9

Lagos

LASTMA Stop Major Fire Disaster As Gas Tanker Tumble For Chisco

One big tragedy almost happen for Lagos on Monday morning but LASTMA officers sharply block am after one gas tanker wey full with Compressed Natural Gas (CNG) tumble for Chisco road, inside Victoria Island area. Di white Howo truck reportedly lose control and fall for expressway, causing fear of explosion and fire wahala. As dem reach di scene, LASTMA officials quickly cordon di area, secure di tanker and stop any […]

todayNovember 3, 2025 8

Lagos

Lagos Go Launch Digital Platform To Approve Telecom Infrastructure By 2026

Lagos State Government don yan say dem go digitalize and automate di way dem dey give approval for telecommunication infrastructure project through one new platform wey dem call Telecommunication Infrastructure Regulatory System (TIRS) wey go launch by February 2026. Di General Manager of Lagos State Infrastructure Maintenance Regulatory Agency (LASIMRA), Prince Oyekanmi Elegushi, talk dis one for statement wey him sign. According to am, di new system go make sure […]

todayNovember 3, 2025 26

Lagos

Lagos Government And NCF Don Join Hand To Fight Plastic Pollution

Di Lagos State government don join hand with Nigerian Conservation Foundation (NCF), Chevron and Seven-Up Bottling Company to raise alarm say plastic pollution don turn big wahala wey dey threaten environment, marine life and people health. Di call happen for Yaba College of Technology during di 19th Walk for Nature wey dem theme be “Lagos, Let’s Beat Plastic Pollution.” Governor Babajide Sanwo-Olu, wey Special Adviser on Environment, Olakunle Rotimi-Akodu represent, […]

todayNovember 3, 2025 31 1

Lagos

Police Don Catch E-Hailing Driver For Lagos Over Sɛxual Misconduct

Police for Lagos don arrest one e-hailing driver, Adedayo Adegbola, wey dem accuse say e dey rob, beat and forcefully sleep with women passengers. Di suspect fall yakata after detectives from State Criminal Investigation Department (SCID), Panti, Lagos Police Command, track am down over plenty cases of r@pe, defilement, assault, and armed robbery against female passengers for different parts of di state. Lagos State Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, order […]

todayNovember 3, 2025 24 1

Lagos

How Lagos Wan Turn Dirty Wahala To $2.5 Billion Money-Making Circular Economy

Lagos State dey generate about 13 million metric tonnes of dirty every year, but experts don talk say di state fit turn dis waste wahala to $2.5 billion yearly business if dem fit recover at least 70% of recyclable materials. Every day, about 13,000 tonnes of waste dey pile up for di city, and if di reforms, partnership and awareness campaign wey don start succeed, Lagos fit soon turn from […]

todayNovember 3, 2025 28 5

Lagos

Festac People Don Cry Say Federal Government Don Abandon Their Roads

Residents of FESTAC Town for Lagos don vex say Federal Government don forget di major roads wey don spoil for dia area. Dem accuse FG say e never keep promise to fix di bad roads even after dem talk say workers and equipment don enter site. Under di group wey dem call Take Back FESTAC, di Chairman, Velentine Uduebo, yarn say na only local government dey try small small for […]

todayNovember 3, 2025 12

Lagos

22 Ships Wey Carry Petrol, Fish, and Food Don Land Lagos, Prices Fit Fall

Nigerians fit soon see petrol and food prices fall as 22 ships wey full with petroleum products, frozen fish, and other commodities don land Lagos ports. Nigerian Ports Authority (NPA) yarn for dia latest Shipping Position report say di ships dey discharge goods for Apapa, Tincan, and Lekki ports. Di vessels carry essential things like petrol, bulk gas, frozen fish, bulk sugar, ethanol, buckwheat, bulk urea, and wheat. NPA add […]

todayOctober 31, 2025 36 3

Lagos

Another Wahala For Otedola Bridge As Traffic Jam Don Start Again

Barely 24 hours after plenty truck crash happen for Kara Bridge wey cause heavy gridlock for Lagos-Ibadan Expressway, another road wahala happen on Friday. Dis time na 14-tyre truck and inter-state commercial bus wey jam for Otedola Bridge, inward Lagos Secretariat. Di Lagos State Traffic Management Authority, LASTMA, confirm di matter for statement wey dem release for dia official X page. LASTMA talk say di 14-tyre tipper truck wey dey […]

todayOctober 31, 2025 27

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds