Lagos

643 Results / Page 9 of 72

Background

Lagos

Lagos Gorment Promise Makoko Community Beta Life

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don repeat tuk, say dem go still upgrade Makoko community for Lagos Mainland, and dat, dem nor get plan to scatter pipo community. Say, Dem don put $2 million as dia own share for di project, and dem dey wait for another $8 million from United Nations to start work. Special Adviser to Governor on eGIS and Urban Renewal, Dr Babatunde Olajide, ni dey […]

todayFebruary 3, 2026 3

Lagos

Lagos Govt Carry Mobile Court Enter Road, Teach Pipo Traffic

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment don carry Special Offences (Mobile) Court waka go different parts of di state to sensitize people on traffic and environmental laws. Di programme wey hapun Friday for Lagos Safety Arena and areas like Oshodi, Iyana Ipaja, Ojota and Ikorodu na to teach people make dem obey law. Dem focus on one-way driving, misuse of BRT lane and blocking public spaces. State Attorney-General, Lawal Pedro […]

todayFebruary 3, 2026 7

Lagos

Lagos Emergency Share Report Say Na 173 Pipo Kpai From 1,156 Emergency For 2025

By: Esther Ayoola Lagos State Emergency Management Agency don drop update say na 173 people ni kpai from 1,156 emergencies wey hapun for 2025. Road crash wey hapun pass 394 cases, followed by tanker and truck wahala of about 249, and fire out break reach 204. February na di month wey get di most palava with 122 cases, while Alimosho local government top di chart with 180 emergencies. According to […]

todayFebruary 3, 2026 4

Lagos

Lagos Muslims Push For More Inclusion For Gorment

By: Esther Ayoola Muslim Community of Lagos State, MCLS, don raise concern say, di way gorment take dey sideline Muslims for political appointments and governance for di state, say e nor dey sweet dem for belle. Di group tuk dis one for last Saturday during dia first General Assembly wey dem hold for Lagos State Secretariat Mosque Hall, Alausa, Ikeja. MCLS lament say Muslims dey excluded especially for education sector, […]

todayFebruary 2, 2026 5

Lagos

Nigerian Army Celebrate Corp Service Support Day For Lagos Barracks

By: Esther Ayoola Nigerian Army don wire ogbonge warning, say make Nigerians comot body from drug abuse and other bad behaviour, as Combat Service Support Corps celebrate WASA 2025 for Barracks, Sabo Yaba, Lagos. Di event gather officers, soldiers, families and visitors, with fine cultural dance from Yoruba, Hausa and Igbo people, even arrange konfam award give dia correct soldiers, inter-corps tug of war, and gift to 20 widows of […]

todayFebruary 2, 2026 3

Lagos

Lagos NMA Chair Call For Beta Backing For Primary Healthcare

By: Esther Ayoola Chairmo of Nigerian Medical Association, Lagos State branch, Dr Babajide Saheed, dey call for beta funding for primary healthcare, say, at least e suppose be 60 to 70 per cent of gornment budget. He yan dis on Monday during during one media sitdon tuk tuk, saying primary healthcare na key for accessible, preventive, and community-based medical services. Dr Saheed say without strong investment for primary healthcare, efforts […]

todayFebruary 2, 2026 3

Lagos

Lagos Gorment Drag Truck, Tanker Drivers To Stop Driving Wawawa

By: Esther Ayoola Lagos State Gornment like dis dey beg truck, tanker drivers to stop driving wawawa, say make dem try to follow traffic laws and speed limits. Special Adviser to Govo Babajide Sanwo-Olu on Transportation, Sola Giwa ni dey yan dis one on Sunday for Lagos afta one CNG truck cause askident for Apakun Bridge, inward Oshodi. Di crash involve di heavy-duty truck and one private car, and na […]

todayFebruary 2, 2026 4

Lagos

Lagos House Of Assembly To Meet Makoko Leaders Over Demolition Wahala

By: Esther Ayoola Di Lagos State House of Assembly don call community leaders wey demolition touch for Makoko and other waterfront areas for meeting. Clerk of di House, Olalekan Onafeko, ni drop di update for statement, say di meeting na response to petition wey di communities submit about dia eviction. E say di meeting go hold by 10:00 a.m. on Tuesday, February 3, 2026, for Assembly Complex, Alausa, Ikeja. Di […]

todayFebruary 2, 2026 5

Lagos

Fela Kuti Become First African To Get Grammy Lifetime Award Afta Him Death

By: Esther Ayoola Legendary Afrobeat boss Fela Anikulapo-Kuti wan make history to become di first African wey Grammy go give Lifetime Achievement Award  30 years afta kpeme. According to reports, Recording Academy go honour di “King of Afrobeat” for 2026 Grammy Special Merit Awards on January 31 for Los Angeles. Di news don cause beta jubilation for Nigeria and outside. Di Grammy pipo say Fela music still dey inspire big […]

todayJanuary 30, 2026 8

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app