Lagos

1066 Results / Page 7 of 119

Background

Lagos

Fire Burn Houses For Yaba, No Life Lost

By: Olabisi Olatunji Lagos State Gornment say no life lost after fire destroy cluster of makeshift houses for Abule-Oja, Yaba, on Wednesday. Di fire happen for Abudu Street by UNILAG Road before emergency agencies quickly respond. Firefighters and security operatives work together to stop di fire from spreading to nearby buildings. Lagos State Fire and Rescue Service, Federal Fire Service, UNILAG Fire Service, Police and LNSC join fight di inferno.

todayAugust 5, 2026 12

Lagos

ASUU Say Professors Salary Don Fall Below Secondary School Principals for Lagos

By: Esther Daniel ASUU on Wednesday for Lagos accuse Lagos State Gornment say senior professors for state owned universities dey earn less dan secondary school principals, as di union say dem never implement 2025 FG ASUU agreement wey suppose improve lecturers welfare. Di union branches from LASU, LASUSTECH and LASUED make di allegation during emergency press conference for ASUU Secretariat, LASU Ojo, because lecturers dey face poor salary, high tax […]

todayAugust 5, 2026 10

Lagos

Senate Deny Say Dem Sponsor Bill Wey Go Fine People Wey Dey Preach For Bus

By: Esther  Daniel Di Senate don deny reports say Senate Leader Opeyemi Bamidele and spokesman Yemi Adaramodu sponsor di bill wey propose ₦50,000 fine for people wey preach, trade or hawk inside commercial buses. Yemi Adaramodu tok dis one during interview as public debate over di FRSC Amendment Bill 2026 continue. Di bill still retain di ₦50,000 fine after Senate pass am as part of plan to strengthen road safety […]

todayAugust 5, 2026 9

Lagos

Lagos Water Project Don Move, New Pump Equipment Land for Iju, Adiyan

By: Esther Daniel Lagos water matter don receive fresh ginger as State Gornment on Tuesday take deliver new pumping equipment to upgrade Iju and Adiyan Waterworks. Environment Commissioner Tokunbo Wahab confirm di development through im X handle, say di equipment na part of Gofnor Sanwo-Olu administration plan to strengthen water infrastructure. Di new machines go replace old pumping systems and help improve clean water supply for millions of Lagos residents. […]

todayAugust 4, 2026 10

Lagos

Oriade LCDA Don Bubble, Olojede Celebrate One Year with Better Package

By: Esther Daniel Better things don land for Oriade LCDA as Chairman Rasaq Olojede on Monday celebrate one year for office by launching free medical outreach and skills training for residents. Di council boss share free glasses, drugs and tailoring tools give youths and women, say di programme na to improve people life and help more residents stand on dia own. Olojede promise residents say more development projects and people-focused […]

todayAugust 4, 2026 14

Lagos

Lagos Police Bust Fake Drug Warehouse

Lagos State Police Command say dem don bust two warehouses  wia pipo dey repackage fake drugs, and arrest two suspects. Police Commissioner Fatai Tijani naim package dis mata one on Monday during press tuk, tuk doings inside Violent Crime Response Unit, Ijora Olopa, Lagos. Di two suspects, Eze Okwudilichukwu, 52, and Chukwudi Mba, 42, naim dem catch dem for one warehouse along Otto Causeway, Otto, Lagos, where police say dem […]

todayAugust 4, 2026 10

Lagos

Frank Edoho Call Lagos House Property Armed Robbery On Monday

By: Yusuf Abuh Popular media personality Frank Edoho blast Lagos house sellers during one show broadcast on Monday because dem dey sell house too cost. Edoho talk dis matter inside Lagos on Monday through di video show to ask who get money buy house as naira dey fall. Di veteran host complain for Lagos on Monday during di talk show because dem dey sell one house for Osapa $1.5 million […]

todayAugust 3, 2026 11

Lagos

Apc Oga Dem Link Up To Plan How Dem Go Win Election For Osun State

By: Yusuf Abuh APC governorship candidate Bola Oyebamiji don drop update say South-West party leaders don meet inside Lagos State House, Marina on Monday evening to plan how dem go win di August 15 Osun governorship election. Oyebamiji drop dis update for im  X page on Monday night to show how APC plan to align all dia campaign strategy before di election date. Na Lagos state govo, Babajide Sanwo-Olu and […]

todayAugust 3, 2026 15

Lagos

LAWMA Don Lock Shop! Dirty Business Owners For Lagos Don Enter One Chance

By: Esther Daniel No be small Kasala for Ikotun, Igando and Alimosho as LAWMA storm di area on Saturday say hand touch some  market pipo dia, na so dem lock shops and businesses wetin nor good sake of say dem nor clean dia stores environment. All wetin di environment pipo dey tell dem, e be like say dem deaf. Di enforcement team from LAWMA Project WISE West enter area lock […]

todayAugust 3, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds