Lagos

1066 Results / Page 8 of 119

Background

Lagos

Suspected Cult Boys Kpai Security Guard for Yaba

By: Yusuf Abuh Suspected cult boys don kpai one security guard  allegedly wey dem identify as Godwin for Abule Ijesha area of Yaba, Lagos, and dis one sef sup on Saturday. According to eye witness di attackers come with motor, meet am near where e dey work, shoot am for head and later use axe attack am. And dis one cause serious serious panic for di community. However, as at […]

todayAugust 3, 2026 11

Lagos

Lagos Police Jam Big Fish! Alleged ₦1 Billion Motor Scam Oga Finally Fall

By : Joalyemi Olajide Di Lagos State Police Command don finally catch di alleged oga of one motor scam syndicate wey police say use magomago way collect 29 vehicles worth over ₦1 billion after e dey dodge arrest for long. Police tok say na confessional statements from arrested gang members and thorough investigation expose di suspect as di alleged brain behind di massive vehicle fraud before officers finally jam am. […]

todayAugust 1, 2026 15

Lagos

Airport Police Grab 13 Suspects Wey Dey Loot Building

By: Esther Daniel Airport Police Command for Lagos don arrest 13 suspects wey allegedly go thief airport  building materials from construction site for Murtala Muhammed International Airport. Airport Police ASP Mohammed Adeola naim konfam dis on Friday. Adeola say na betalicious joinbodi doigns by joint Monitoring Task Force  dem take go gbab di suspects on July 30. Police recover expensive copper cables, iron components and oda building materials from di […]

todayJuly 31, 2026 17

Lagos

LAWMA Lock Shops For Ojuelegba Over Illegal Refuse Dumping

By: Yusuf Abuh Lagos Waste Management Authority (LAWMA) don cut chain oh, like dis now hand don touch some shops and business places for Tejuosho-Ojuelegba area because say traders dey dump dirty anyhow. Dis one hapun on Thursday after several warnings and repeated failure by di affected traders to obey sanitation rules. LAWMA oga, Dr. Muyiwa Gbadegesin, say di action na to restore clean environment, protect public health and make […]

todayJuly 31, 2026 10

Lagos

Adedeji Omope Promise More Development For Bariga

Bariga LCDA Chairman, Adedeji Omope, don promise more infrastructure, youth empowerment and social programmes for residents. Omope make di promise as Bariga LCDA celebrate her first anniversary in office on Wednesday. During di celebration, more than 2,000 residents receive bags of rice to help reduce di effect of economic hardship. She thank residents for dia support and say di achievements come through teamwork between government and di pipo.

todayJuly 30, 2026 17

Lagos

Police Gbab Suspected Armed Robber for Lagos

Lagos State Police Command don arrest one 29-year-old man wey dem suspect say na armed robber during routine patrol on Wednesday for Igando area of Lagos. Police tuk, tuk person, SP Abimbola Adebisi, naim konfamate dis one say officers sight three men wey dey ride one motorcycle and dey behave funny and na so dem take follow dem up. She say as di suspects see police, dem try run, but […]

todayJuly 30, 2026 40 1

Lagos

Lagos Dey Plan Special Number Plates For Pipo Wey Get Disability

Lagos State Gornment don begin plan to introduce special vehicle number plates for people wey get disability, so movement fit easier and everybody fit enjoy equal access across di state. According to statement from di state gornment, Lagos State Office for Disability Affairs, LASODA, and Lagos State Motor Vehicle Administration Agency, MVAA, na dem dey work together to bring di plan to life. Di idea come after LASODA management visit […]

todayJuly 29, 2026 14

Lagos

Lagos Tighten Safety Rules for High-Rise Buildings

Lagos State Gornment don carry mata for head  dey hawk Lagos problem, say, di way building take collapse don too much, and like dis na to “protesion” every every for di obodo Lagos naim be di goal. Small tin, person go hear, one building don collapse, if nor be building na fire as dem ginger all lagosians to dey very careful with dia safety. Na di oga kpatakpata, Director-General of […]

todayJuly 29, 2026 15

Lagos

Lagos Gornment Open New Olusosun Road For Waste Management

By: Yusuf Abuh Lagos State Gornment don commission di new 1.2-kilometre access road inside Ojota, to make waste management easier across di state. According to report dis new road go make possible for betaliocious waste management inside di obodo Nigeria. LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, naim sorosoke dis mata as im ma go inspect di road. Oga Gbadegesin sef con say dis road go make waste movement smooth for […]

todayJuly 29, 2026 15

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds