Lagos

1135 Results / Page 8 of 127

Background

Lagos

Sanwo-Olu Declare Small State of Emergency On Top Dorti Mata for Lagos

By: Ayobami Dada Lagos State Govo, Babajide Sanwo-Olu, don declare wetin e call “small state of emergency” for waste management across Lagos. Sanwo-Olu declare dis one as e dey inspect Olusosun dumpsite for Ojota, where Deputy Govo, Dr Obafemi Hamzat, and Commissioner for Environment and Water Resources, Tokunbo Wahab, follow am go. Di inspection na to find out di problem wey dey affect work for di dumpsite and hin kon […]

todaySeptember 10, 2026 10

Lagos

LAWMA Tell Lagos People: No Buy for Roadside

By: Kofoworola Olayinka LAWMA don warn Lagos residents say anybody wey buy goods from illegal roadside traders fit face arrest and prosecution, as enforcement go start next week. LAWMA Managing Director, Dr. Muyiwa Gbadegesin, give di warning on Tuesday for di authority headquarters for Lagos, saying di move na to stop illegal trading, waste dumping and blockage of public spaces. E say residents wey buy from traders for roads, medians, […]

todaySeptember 9, 2026 17

Lagos

APC Gather Religious Leaders Fire Prayers for Baba Presido

By: Mariam Ajayi Election don reach everybody mind dey shakebalabala, nor be small prayer wey di All Progressives Progress  Congress fire yesterday Onikan stadium for Lagos, say any opposition wey Say Bola  Tinubu  and Kadri Obafemi Hamzat nor go win di 2027 election, say make dem comot body joor. Senior mehn Pastors, Imams, and traditional worshippers naim put body for di mata. Gofnor Babajide Sanwo-Olu, party chairmo Cornelius Ojelabi, plus […]

todaySeptember 9, 2026 13

Lagos

Lagos Upgrade Five Police Divisions for Domestic Violence Cases

By: Ayobami Dada Lagos State Gornment don upgrade five police divisions for Isheri, Idimu, Meiran, Ijesha and Iju into Family Support Units to improve response to domestic and sexual violence cases. Di DSVA and Lagos Police Command carry out di upgrade, while 24 officers receive special training from September 3 to 4, 2026, for LCCI Centre, Alausa, on how to investigate and handle SGBV cases.

todaySeptember 8, 2026 11

Lagos

Lagos Charge Over 100 Suspects for Oshodi

By: Ayobami Dada Lagos State Gornment take over 100 suspects for Special Offences Mobile Court, Bolade, Oshodi, on Friday, September 4, 2026, over alleged public peace breach and unlawful use of government property. State lawyer Oluwabusola Omotunde tell di court say security operatives arrest dem between 2 a.m. and 4 a.m. for Victoria Island, Lekki and Ajah corridor because of di alleged offences.

todaySeptember 8, 2026 14

Lagos

Lagos Police Vex, Gbab 4 Suspects Wey Kpai Abroad Returnee

By: Yusuf Abuh Lagos police command dey vex oh, like dis dem arrest four suspent base on Lagos island jungle justice. Lagos Police Command don lock four suspects inside cell after jungle justice beating wey dem take kpai kpai one abroad-returnee, Basit Kolade. Lagos Police tuk, tuk, Abimbola Adebisi, naim dey sorosoke di ogbonge update say dis wahala badness hapun along Freeman Street as Basit and e wife dey drive […]

todaySeptember 8, 2026 13

Lagos

Lagos Area Boss Kpai Man Wey Just Return From Obodo Oyinbo

By: Mariam Ajayi Some area jaguda boys  beat persin, him name na Basit, di man kpeme, say di man wan bin do hit and run. Di victim, wey just bounce back to Naija from obodo oyinbo and get wedding to do in two weeks, bin yam one resident for Patey area before boys chase am catch. Eye-witness, Afolabi Lawal, explain say di angry area boys use bottle and heavy stick […]

todaySeptember 7, 2026 16

Lagos

Lagos Gov Aide Knock Buchi Over Lagos Tok

By: Mariam Ajayi Lagos Gorfnor media aide, Gboyega Akosile, don knock content creator Solomon Buchi over im comment about foreigners visiting Lagos. Akosile make di response on X on Friday, saying Buchi dey show bitterness towards Lagos instead of using di opportunity to promote other parts of Nigeria. Akosile say di nightlife and cosmetic surgery culture wey Buchi criticise na part of wetin still dey make Lagos nightlife attractive to […]

todaySeptember 4, 2026 10

Lagos

Sanwo-Olu Beat Chest Say Nigerians Dey Feel Jagaban

By: Mariam Ajayi Sanwo-Olu don hail Tinubu as man of the pipo, say some pipo dey look am with suspicious eyes. Senior man talk this one on Thursday for the 7th Freedom Online Annual Lecture wey hold for Ikeja, Lagos. E use the August 15 Osun election wey opposition Governor Ademola Adeleke win take give example, say Tinubu dey work day and night to bring better democracy to Nigeria.

todaySeptember 4, 2026 11

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds