National

1095 Results / Page 2 of 122

Background

National

Opposition Kick Against Tinubu Electoral Law, Say Make Dem Do Fresh Amendment

By: Esther Ayoola Opposition political parties don reject di 2026 Electoral Act wey President Bola Tinubu sign into law, say some parts of di law fit spoil free and fair election for 2027. For press briefing wey dem hold for Abuja on Thursday, leaders like Atiku Abubakar, Peter Obi and Rotimi Amaechi say National Assembly must remove wetin dem call “obnoxious provisions,” especially di clause wey allow manual transmission of […]

todayFebruary 27, 2026 4

National

Oluremi Tinubu Bag “Light of God” Title for Warri, Call For Unity

By: Esther Ayoola Naija First Lady, Oluremi Tinubu, don receive traditional title of Utukpa-Oritse (Ugbone) for Warri Kingdom as dem honour am for her public service and humanitarian work. Di ceremony hapun for her maternal home, Warri, Delta State, where di monarch, Ogiame Atuwatse III, welcome am and praise her effort for women empowerment and social welfare. For her speech, Mama Oluremi, say make Nigerians dey united and live as […]

todayFebruary 27, 2026 2

National

Ondo Police Gbab Six Allege Fake Pastors For Fake Miracles

By: Esther Ayoola Ondo State Police Command say dem don gbab six men dat dem sell miracle for Idanre LGA, dey pose as pastors, dey do fake miracles up and down. Police tuk, tuk, Jimoh Kazeem, say di arrests happen on February 16, 2026, afta tactical team and Community Safety Officers follow intelligence. Police say, di suspects, wey dem identify as Fadahunsi, Kolade, Tijani, Iyanuoluwa, Arijesulola and Ademola, dey do […]

todayFebruary 27, 2026 2

National

Makinde Say Na Competence, Loyalty Go Decide Im Successor For 2027

By: Esther Ayoola Baba govo of Oyo State, Seyi Makinde don share update say, na sabi man and loyalty to Oyo State go decide who go succeed am as govo for di 2027 elections, and by loyalty to im di governor. Di Govo make di statement for inside di 12th Omituntun Annual Ramadan Public Lecture wey shelle for Ibadan. Makinde yan plenty, show report card, say im gornment don pay […]

todayFebruary 27, 2026 1

National

Akure Police Commando Gbab 10 Suspected Kidnappers For Ondo State

By; Esther Ayoola Police for Ondo State don arrest 10 suspected kidnappers for Akure and recover ransom money wey dem collect from dia victims. Police tuk, tuk, Jimoh Abayomi, konfamate to tori pipo, from force headquarters, say di arrest na big breakthrough as dem dey continue crackdown on kidnapping and other violent crimes for di state. Say na joint operation between Anti-Kidnapping Section and PMF personnel from Force Headquarters carry […]

todayFebruary 25, 2026 5

National

Ogbomoso Askident Kpai Pregnant Woman, Five Final Year Student For Kwara

By: Esther Ayoola Six people, including one pregnant woman and five final-year nursing students, say ni kpai for one big car askident for Kwara side of Ilorin, Ogbomoso road. FRSC Kwara commandant, Rosemary Alo, konfam say di askident hapun for Ote area for Kwara. Alo say, Some of di victims kpai on di spot, while some others kpai for hospital. Say di five nursing students, na 500-level students wey dey […]

todayFebruary 25, 2026 6

National

APC Govos, Presidency Ginger Bodi For Grassroot Issues

By: Esther Ayoola All Progressives Congress Governors forum don go put bodi for grassroot doings to push di Renewed Hope Agenda of President Bola Ahmed Tinubu, say time don reach for dia reform to show workings. Untop di yarnings for di PGF Renewed Hope Ambassadors Summit 2026, Vice President Kashim Shettima ni carry di mata dey yarn, say time don pass wey dem go dey tell pipo to manage di […]

todayFebruary 25, 2026 3

National

Obi, ADC Drag APC Say Dem Use Hunger Finish Nigerians

By: Esther Ayoola Di 2023 labour parti presidential candidate, Peter Obi once again don drag di All Progressives Congress gornment afta gunmen, wey be suspected political thugs, attack some African Democratic Congress chieftains for house of John Odigie-Oyegun for Benin City, Edo State. Say, di attack hapun shortly afta di party leaders come back from ADC secretariat wia dem formally welcome Olumide Akpata join di party. Obi fry mouth untop […]

todayFebruary 25, 2026 3

National

FG Knock US Congress, Say No Be Religious Persecution for Naija

By: Esther Ayoola Wi Federal Gornment once again don react to US Congress tuk about alleged attack on Christians, say nobody dey support any kind religious persecution for Naija. On Monday, US House Committees on Appropriations and Foreign Affairs submit report to White House, recommend sanction over wetin dem call persecution of Christians for Naija. Reacting, Minister of Information, Mohammed Idris, say Naija never get any gornment policy wey target […]

todayFebruary 25, 2026 3

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app