National

1095 Results / Page 5 of 122

Background

National

Ogun Police Cut Chain For Tiktoker Say She Deceive Members Of Di Public

By: Esther Ayoola Ogun State Police command don plan to arrest one female TikTok user wey dem sabi as Mirabel afta investigation proof she lie say person rape her. Nor be amebo say, Mirabel tuk for one viral phone chat with social media influencer, VeryDarkMan (VDM) of how one man rape her. Say na only she implicate herself, tell VDM for audio call say, di claim na lie, For di […]

todayFebruary 20, 2026 2

National

Muslims And Christians Enter Prayer Mood As Ramadan, Lent Start

By: Esther Ayoola Millions of Muslims and Christians for di world don start dia special spiritual time today. Muslims don ready for Ramadan, wey dem go fast from morning till night, pray more, and do plenty charity. Christians wey dey observe Lent, go also dey pray, do penance, and control demself till Easter. Saudi Arabia sef don konfamate dis doings, say dem don see di new moon, so Ramadan 1447 […]

todayFebruary 18, 2026 10

National

How Drama Promax Take Sup For Nass Over E-Transmission For 2027 Elections

By: Esther Ayoola Drama burst for National Assembly of Naija on Tuesday as lawmakers approve electronic transmission of election results but sti keep manual collation as backup ahead of 2027 elections. A move wey bring serious argument for both Senate and House of rep. For Senate, about 15 lawmakers led by Enyinnaya Abaribe protest against di clause wey say manual Form EC8A fit serve as main result, if electronic transmission […]

todayFebruary 18, 2026 9 2

National

Manufacturers Block NAFDAC Office, Kick Against Sachet Alcohol Ban

By: Esther Ayoola Say like dis manufacturers of spirit drink, wey dey under Food, Beverage and Tobacco Senior Staff Association dey protest, say dem nor go gree oh, for NAFDAC office, Oshodi-Apapa expressway, block di gate enter, say make NAFDAC open dia offices. Dem say NAFDAC seal dia factories because of di ban on sachet alcohol drinks and PET bottles wey small pass 200ml. Di workers carry placard wey write […]

todayFebruary 18, 2026 3

National

Medipool And FG Join Body To Boost Local Medicine Production For Naija

By: Esther Ayoola Federal Gornment don sign Memorandum of Understanding (MoU) with ogbonge Medipool to make local drug manufacturing for Naija grow. Oga coordinating minister of Health, Professor, Ali Pate don describe dis partnership correct access to ogbonge medicine, reducing importation of medicine. Pate say e go also support beta healthcare and boost production of important local drugs.

todayFebruary 17, 2026 5

National

WAEC Release Second CB Result

By: Esther Ayoola WAEC don release di 2025 Second Series CB-WASSCE results for private candidates, According to a statement by Acting Head of Public Affairs, Moyosola Adesina,  on Monday for Lagos, say  Candidates fit check dia results online for www.waecdirect.org before dem fit collect digital certificate for www.waec.org. To get hard copy certificate, candidates suppose apply online through WAEC e-Certman portal at https://certrequest.waec.ng/, as WAEC advise make dem act quick. […]

todayFebruary 17, 2026 6

National

Gbajabiamila Press Yans Dat Education Na Mission For Renewed Hope Agenda

By: Esther Ayoola Chief of Staff to oga Presido, Femi Gbajabiamila, don repeat tuks, say education na key part of President Bola Tinubu Renewed Hope Agenda. Im yarn dis one for Abuja during 2026 International Day for Education Conference wey Speaker Tajudeen Abbas organise. Gbajabiamila say if Naija wan compete well for global knowledge economy, e must invest serious for education and carry young people along.

todayFebruary 17, 2026 2

National

FG, APC Govos Dash Kano Fire Victims ₦8bn To Start Life Again

By: Esther Ayoola Federal Gornment don approve ₦5 billion to support pipo wey lose property for di Kano Singer Market fire disaster. Vice Presido, Kashim Shettima tuk am during him sympathy visit to di market. Shettima say di money sef eh,  go hellep victims rebuild dia businesses and bring back normal trading activities. Also marking present, Di All Progressives Governors Forum, led by Imo State Governor Hope Uzodimma, also add […]

todayFebruary 17, 2026 3

National

President Tinubu Express Shock As Governor Fintiri Show Workings For Adamawa

By: Esther Ayoola Oga Presido, Bola Tinubu don enter area for Adamawa state cut cap for govo Ahmadu Fintiri  say na real “renewed hope” development  im dey do for di state. President Tinubu enter Yola for first state visit yesterday and say im eyes first blur as im see  di kind of big infrastructure and fine governor office. Baba Seyi use di opportunate take beg Nigerians oh, say as country […]

todayFebruary 17, 2026 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app