insert_link National President Tinubu Clear Nigerian Aprokos To Stop Fake News By: Esther Ayoola Wi oga presido, Bola Tinubu, unto doings don tell Nigerians make dem try to dey talk truth all the time and stop to spread fake news. He talk this through information Minister Mohammed Idris during the launch of the “my nigeria, my responsibility” program for inside the obodo Nigeria. Idris say, Nigerians must promote correct information and show the world the countri progress, peace, and national values. todayDecember 9, 2025 7
insert_link National Remi Tinubu Hail Titilola Adeleke As She Mark 60 Years By: Esther Ayoola For Abuja, after all the drama for Osun state between the dancing senator and first lady, Oluremi Tinubu, madam first lady don wire birth messgae give Adeleke wife, Titilola Adeleke, as she clock 60. Na for statement wey dem wrap like moimoi drop for her x page, mama Remi hail madam Adeleke for the serious work wey she dey do to uplift Osun people through the renewed […] todayDecember 9, 2025 6
insert_link National Tinubu Wire Letter Give Senate Say Im Wan Send Army Go Benin Republic By: Alice Iduh Wi oga Presido Bola Tinubu don write Senate say, make dem allow am send Naija soldiers go Republic of Benin as di country ask for help after coup wahala wey bust on sunday. Oga Senate Presido, Godswill Akpabio, read di letter for plenary, and Tinubu talk say na section 5(5) of di 1999 Constitution give am power to seek dis kind approval. Tinubu yarn say Benin beg […] todayDecember 9, 2025 6
insert_link 1 National Ecowas Declare Emergency For West Africa Sake Of Security Wahala By: Alice Iduh Di Economic Community of West African States, ECOWAS, Ecowas don provoke oh, declare state of emergency for all West Africa say region political and security wahala don tire dem. Na di Commission Presido, Omar Touray, dey yan dis one on Tuesday for Abuja during di 55th Mediation and Security Council meeting. Touray tell im ministers and diplomats say recent gbege show say dem need serious thinking about […] todayDecember 9, 2025 22 1
insert_link National Atiku Yarn Matas Say Late Yar’adua Still Dey Inspire Naija By: Rilwan Agbomeji Wi former vice-presido Atiku Abubakar betterlicious don thruway salute give wi late general, Shehu Musa Yar’adua, say im still dey inspire politics for Naija. Im dey yanyanpu dis one for Abuja for inside union gathering, Atiku yarn say Yar’adua na correct mentor, brother-in-arms, and moral compass wey dey guide people even till now. Di former vice presido say, Yar’adua legacy dey motivate Nigerians wey still dey believe […] todayDecember 9, 2025 4
insert_link National FG To Pay ₦185b Gas Debt, Promise Better Light By: Esther Ayoola Federal Government say dem don take big step to shake life back into Nigeria gas sector and make power supply stable after President Bola Tinubu gree say dem go pay ₦185 billion wey government don owe gas producers . Minister of State Petroleum Resources (Gas), Ekperikpe Ekpo, yarn dis one on Tuesday say, the move wey National Economic Council (NEC) under VP Kashim Shettima back, na one […] todayDecember 9, 2025 3
insert_link National Niger State Pipo Beg For School After 315 Students Abuction By: Esther Ayoola One parent of di catholic school wey bandits abduct 315 students for agwara, niger state, don beg authorities make dem no shut down di school despite di kpai wahala last month. Bishop bulus yohanna, catholic bishop for kontagora diocese and can boss for niger, yarn dis one tuesday for tv sit down talk. Di plea come just one day after governor umar bago receive 100 rescued students […] todayDecember 9, 2025 2
insert_link National Reps Tell NNCPL To Drop 2021 Audit Papers Dec 15 For Audit By: Rilwan Agbomeji House of Reps Public Accounts Committee don claer marras dat make di nnpcl drop all di missing documents of company and show face for Abuja before December 15, 2025, over 2021 spending audit wahala. Chairman Bamidele Salam vex for Monday sitting as e blast NNPCL for always dodging summons and refusing to bring di papers wey dem ask for. E talk say di kain disrespect wey di […] todayDecember 9, 2025 7
insert_link National India Deport 32 Naija Suspects Say Dem Go Sell Weed For Obodo Oyinbo By: Esther Ayoola Kwake yoyoo, awhoo, say Indian authorities don bundle 32 Nigerians comot for their country says dem join body for one deadly transnational drug cartel. According to Reports, investigators trace di whole operation reach one Naija kingpin wey dem dey call “Nick,” wey don waka disappear and dey wanted for plenty drug cases. Elite Anti-Narcotics Group officers still join bodi tuk their own that, all di Nigerians wey […] todayDecember 9, 2025 4