OBODO NAIJA

770 Results / Page 67 of 86

Background

OBODO NAIJA

President Tinubu Land Kenya Ahead Africa-France Summit for Nairobi

By: Jolayemi Olajide Wi oga Presido,  Bola Tinubu, AKA baba seyi don arrive Nairobi, Kenya, ahead of the Africa-France Summit wey go start later on Monday. State House media office tok say di Airbus A330-200 wey carry Tinubu land for Jomo Kenyatta International Airport around 12:15 a.m. local time after him leave France for di second leg of im three-country tour. During him visit to France, Tinubu meet global investors […]

todayMay 11, 2026 27 3

OBODO NAIJA

11 Pipo Kpai as Motor Fall From Eruku Bridge for Ogun Expressway

By : Joalyemi Olajide Say nor be small badness up along Lagos-Abeokuta Expressway for Ogun State, at least 11 pipo kpai after one Toyota vehicle fall from Eruku Bridge According to Ogun State FRSC tuk, tuk person, Afolabi Odunsi, di gold Toyota throw bakky from di bridge, though officials never fully Konfam wetin cause the accident. He explain say all 11 occupants inside the motor, 10 adult men and one […]

todayMay 11, 2026 28 3

OBODO NAIJA

FG Introduce Compulsory Drug Tests for Secondary School Students

By : Jolayemi Olajide Federal Gornment don introduce new movement to fight drug and substance abuse for secondary schools across Nigeria. According to a statement by Minister of Education, Tunji Alausa, Under the new policy, all new students wey gain admission into secondary school go undergo compulsory drug test before dem fit fully enter school. Gornment also tuk say any student wey continue to test positive after treatment and rehabilitation […]

todayMay 11, 2026 24

OBODO NAIJA

Gunmen Kpai UNIBEN Student for Campus Gate After Exam

By : Jolayemi Olajide A yet-to-be-identified part-time political science student of di University of Benin (UNIBEN) don reportedly kpai after im collect bullet inside im car  for  main gate, Ugbowo campus. According to video wey surface online, dem kpai di student shortly after im finish semester exam, though authorities never fully Konfam that part of the story. UNIBEN management don distance students and staff from di incident, saying di shooting […]

todayMay 11, 2026 20

OBODO NAIJA

EFCC Declare Former Minister Sadiya Farouq Wanted

EFCC don declare former Humanitarian Affairs Minister, Sadiya Farouq, wanted over allegation say she divert government money, abuse her office, and join hand for criminal conspiracy. Di anti-corruption agency put di notice for dia website on Saturday, tell members of di public say anybody wey know where she dey make dem alert EFCC sharp-sharp. According to di commission, anybody wey get useful information fit report for any EFCC office for […]

todayMay 9, 2026 27

OBODO NAIJA

Police Gbab 2 Jaduga Boys For Kwara, Recover AK-47 Gun

Police operatives for Kwara State don arrest two men wey dem suspect say na members of one kidnapping gang, and recover guns plus bullets for one operation for Ilorin. Di Commissioner of Police for di state, Adekimi Ojo, drop dis one for statement wey police tuk tuk person, Adetoun Ejire-Adeyemi, release on Saturday. According to di statement, na officers from di Intelligence Response Team wey dey under di state command […]

todayMay 9, 2026 27

OBODO NAIJA

Minister of Tegbe clear matas say im nor Promise to Fix Light In 3 Months

By : Jolayemi Olajide Power Minister-designate, Joseph Olasunkanmi Tegbe, don deny reports wey claim say e promise to fix Nigeria power grid within three months. E yarn dis one through im tuk tuk,  Adeola Adelabu, say di reports no represent wetin e truly tuk during im Senate screening on May 6, 2026. For statement wey dem post on X on Thursday, the minister explain say,  e only mention say gornment […]

todayMay 8, 2026 30

OBODO NAIJA

Fani-Kayode Explain Why Im Reject Germany Posting as Ambassador

By : Jolayemi Olajide Former Aviation Minister, Femi Fani-Kayode, konfamate say wi oga Presido, Bola Tinubu don appoint as Nigeria Ambassador- to South Africa. Di former Aviation Minister convasate dis one on Thursday for im X handle. According to am, dem first post am go Germany, but later di Ministry of Foreign Affairs con receive request letter changing the duty post. He explain say di reason na based on im […]

todayMay 7, 2026 26

OBODO NAIJA

Make Una Set Up Crisis Response For SA – Presido Tinubu

Bola Ahmed Tinubu don give urgent order say all Nigerian missions for South Africa must set up emergency crisis unit sharp-sharp to protect Nigerians wey dey face threat. Dis one dey for inside statement wey di Foreign Affairs Minister drop on Thursday. According to Foreign Affairs Minister, Bianca Odumegwu-Ojukwu, she say wetin dey happen for South Africa pass ordinary xenophobia, say e don turn full “Afriphobia.” She still tuk say […]

todayMay 7, 2026 22

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds