OBODO NAIJA

770 Results / Page 66 of 86

Background

OBODO NAIJA

Nigeria, World Bank Near $1.25bn Deal to Boost Reforms

By : Jolayemi Olajide Di Federal Gornment of Nigeria don begin tuks with World Bank for fresh $1.25bn loan wey go support economic reforms, job creation for Nigerians According to reports, di proposed loan wey dem call Nigeria Actions for Investment and Jobs Acceleration don reach final stage for approval process. Say If dem approve am, e go land just months before di 2027 general elections wey Independent National Electoral […]

todayMay 12, 2026 31

OBODO NAIJA

Sowore Backs Aisha Yesufu Senate Bid, Say Na Di Only Way To Save Nigeria

By : Jolayemi Olajide Activist and former presidential candidate, Omoyele Sowore don throw im support behind fellow activist Aisha Yesufu for her 2027 FCT senatorial ambition. Sowore talk dis on Monday during one interview with news pipo. According to am, politics na the biggest form of activism to save society, as e say people wey wan change the system must join political participation. Cue in sound

todayMay 12, 2026 27

OBODO NAIJA

JAC, FG Start Talks After SSANU, NASU Suspend dia Strike

By : Jolayemi Olajide Joint Action Committee wey include Senior Staff Association of Nigerian Universities and Non-Academic Staff Union of Educational and Associated Institutions wey bin start indefinite strike on April 30, don begin tuk with  Federal Gornment  over dia  renegotiation of 2009 agreement, allowance and welfare issues. On May 11, union leaders announce say dem don suspend di strike after dem receive assurance from gornment renegotiation committee. SSANU National […]

todayMay 12, 2026 18

OBODO NAIJA

INEC to Use 1.4 Million NYSC Members for 2027 Elections

By : Jolayemi Olajide Di Independent National Electoral Commission don announce say dem go deploy more than 1.4 million National Youth Service Corps members for the 2027 general elections across di obodo Nigeria. INEC Chairmo, Prof. Joash Amupitan, naim make dis announcement on Monday during one courtesy visit to NYSC headquarters for Abuja, wia e meet di NYSC Director-General, Brig.-Gen. Olakunle Nafiu. According to statement wey di Chief Press Secretary […]

todayMay 12, 2026 16

OBODO NAIJA

Governor Adeleke Remove Osun Monarch Say US Court Convict Am For Fraud

By : Jolayemi Olajide Osun state Govo, Ademola Adeleke don remove Oba Joseph Oloyede from office for Ife North Local Gornment say US court  convict am for tax fraud and money laundering case. Na di govo tuk, tuk,  Olawale Rasheed  naim dey convasate dis  one on  Monday say di decision follow Certified True Copy of Ohio court judgment wey konfam di conviction. E still explain say Osun State Executive Council […]

todayMay 12, 2026 18

OBODO NAIJA

Ooni Of Ife Tell Students to take advantage of NELFUND Loan

By : Jolayemi Olajide Di Ooni of Ife, Adeyeye Ogunwusi don advise students make dem take advantage of Nigerian Education Loan Fund to hellep pay dia school fees Im tuk  dis one for im palace for Ile-Ife on Monday when dem receive Executive Director of Finance and Administration of NELFUND, Dr Femi Akinfala. Ooni show concern say plenty eligible students for Osun State never still apply for di loan opportunity. […]

todayMay 12, 2026 22

OBODO NAIJA

Tinubu Appoint Retired Major General Famadewa As First-Ever Special Adviser On Homeland Security

By : Jolayemi Olajide Wi oga Presido President Bola Tinubu don give retired Major General Adeyinka Famadewa new position say make e work as Special Adviser on Homeland Security. Say dis na di first time Nigeria dey create dis kain position for federal level. Dem drop the announcement on Monday through office of SGF George Akume. Gornment talk say the new office go help security pipo to reason together, share […]

todayMay 11, 2026 49 2

OBODO NAIJA

WAEC bring new mean to stop student from using sukili during exams

By: Jolayemi Olajide WAEC don announce new way, wey dem wan take fight exam malpractice and make examination process faster and more transparent for candidates across obodo Naija. Di exam body don launch one “examination malpractice quarter” for im website, where candidates wey get issues related to misconduct fit check dia status directly without delay. Head of WAEC Nigeria National Office, Dr Amos Dangut, naim announce di update on Monday […]

todayMay 11, 2026 28

OBODO NAIJA

JAMB Set 150 Cut-Off Mark for Universities, Polytechnics Get 100

By : Jolayemi Olajide Di Joint Admissions and Matriculation Board (JAMB) don announce cut say 150 go remain di official cut-off mark for university admission for 2026/27 academic session. JAMB tuk dis one on Monday during dia policy meeting wey sup for Abuja, after vice-chancellors and heads of tertiary institutions vote and agree on di new admission scores. According to JAMB, colleges of nursing go also use 150 as minimum […]

todayMay 11, 2026 21

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds