OBODO NAIJA

EFCC Declare Former Minister Sadiya Farouq Wanted

todayMay 9, 2026 10

Background
share close

EFCC don declare former Humanitarian Affairs Minister, Sadiya Farouq, wanted over allegation say she divert government money, abuse her office, and join hand for criminal conspiracy.

Di anti-corruption agency put di notice for dia website on Saturday, tell members of di public say anybody wey know where she dey make dem alert EFCC sharp-sharp.

According to di commission, anybody wey get useful information fit report for any EFCC office for Ibadan, Uyo, Sokoto, Maiduguri, Benin, Makurdi, Kaduna, Ilorin, Enugu, Kano, Lagos, Gombe, Port Harcourt, or Abuja.

Dem also drop phone number 08093322644 and email info@efcc.gov.ng, plus say people fit report to any nearest police station.

Sadiya Farouq serve as Minister of Humanitarian Affairs, Disaster Management and Social Development under former President Muhammadu Buhari from 2019 till 2023.

Written by: Rilwan Agbomeji

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds