OBODO NAIJA

770 Results / Page 80 of 86

Background

OBODO NAIJA

VP  Shettima Welcome Dauda Lawal Join All Progressives Congress

Vice Presido, Kashim Shettima on Wednesday for Abuja don go receive Zamfara State Governor Dauda Lawal and im supporters into All Progressives Congress (APC) on behalf of  oga Presido, Bola Tinubu. Oga vice Presido yarn every every for di ceremony, say Tinubu dey work seriously through security agencies to end di insecurity for di obodo naija. Shettima explain say Lawal joining APC, e go hellep beta collabo and support efforts […]

todayMarch 25, 2026 35 1

OBODO NAIJA

14 Brigade Go Do Shooting Drill For Abia

14 Brigade Nigerian Army don tell farmers and people wey dey near 14 Brigade Range Area make dem no fear if dem hear gun shots from Monday, March 23 go reach Wednesday, March 25, 2026. Di Brigade talk say dem go do first Range Classification exercise to improve how soldiers dey handle weapons, shooting skills, and marksmanship. According to statement wey Captain Mazinho Attah sign, di exercise go happen for […]

todayMarch 22, 2026 32

OBODO NAIJA

Tinubu Set Plan Wey Go Reduce Fuel Wahala For Nigerians

Oga Presido, Bola Ahmed Tinubu don yarn say fuel price don dey too high for Nigerians, and don start plans to reduce di sufferness wey citizens dey face. Dis one dey inside statement wey Hamisu Muhammad Gumel, Chief Press Secretary to Jigawa governor, release give media tori pipo. Di Governor talk dis one during Eid-el-Fitr celebration for Dutse, after e receive Emir of Dutse and other traditional oga dem for […]

todayMarch 22, 2026 35

OBODO NAIJA

Police Grab Three Jaguda Boys For Anambra

Anambra State Police Command don arrest three suspected armed robbers and cultists, and recover different weapons, ammunition, plus one stolen petrol tanker for separate operations across di state. For statement wey dem release on Sunday, police PRO, Tochukwu Ikenga, talk say operatives of Rapid Response Squad, Awkuzu, carry out di arrest on March 21, 2026, around 1:46pm. Ikenga say police act on correct intel before dem storm one suspected criminal […]

todayMarch 22, 2026 29

OBODO NAIJA

Delta Gorment Order Probe On Top Ozoro Festival Wahala

Delta State Government don condemn report wey talk say some women suffer harassment and sexual assault during Ozoro Festival, dem say di act na barbaric and no acceptable at all. Commissioner for Works (Rural Roads) and Public Information, Charles Aniagwu, don call on security agencies make dem quickly investigate di matter and arrest those wey dey involved. E still assure residents say government go continue to protect di rights and […]

todayMarch 21, 2026 25

OBODO NAIJA

President Tinubu Explain Why Im Sign Di New Electoral Act

Wi Oga Presido Bola Tinubu don describe imself as “die-hard democrat” as e urge Nigerian politicians make dem respect democratic values and obey rule of law no matter di cost. Tinubu talk dis one on Wednesday for interfaith breakfast wey happen for State House with executives of All Progressives Congress (APC), members of di National Working Committee and Inter-Party Advisory Council (IPAC). According to di president, im and some other […]

todayMarch 12, 2026 40

OBODO NAIJA

Interior And Information Ministries Join To Promote New Government Reforms.

Federal Ministry of Interior don join hand with Federal Ministry of Information and National Orientation to make sure say Nigerians understand di new gornment reforms on passport service, border security, identity management and national safety. Dis discussion hapun when Minister of Information and National Orientation, Mohammed Idris, carry high-level delegation visit di Ministry of Interior for Abuja, where Minister of Interior, Olubunmi Tunji-Ojo welcome am. Tunji-Ojo  say, strong communication between […]

todayMarch 11, 2026 34

OBODO NAIJA

FG Launch Ogbonge Project To Boost Food Security

Wi Federal Gornment don launch new project wey dem call Sustainable Power and Irrigation for Nigeria, SPIN, to hellep steady farming and food production. Di project get support from World Bank with about $500 million financing to improve farming and boost food security. Minister of Water Resources and Sanitation, Joseph Utsev,  na im carry dis mata dey tuk for di flag of for Abuja, say di project go strengthen food […]

todayMarch 11, 2026 25

OBODO NAIJA

INEC, Air Force Join Hands For Safe And Smooth 2027 Election

Chairmo of  di Independent National Electoral Commission, INEC, Professor Joash Amupitan, say di commission go need continue to work together with Nigerian Air Force to make sure say election for 2027 and future ones dey free, safe and well organized. Amupitan tuk dis one when Chief of di Air Staff, Air Marshal Sunday Aneke, visit di commission headquarters for Abuja with im delegation. According to am, di visit na to […]

todayMarch 11, 2026 33

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds