obodo oyinbo

59 Results / Page 1 of 7

Background

obodo oyinbo

Japan Court Give Life Jail sentence To Abe Killer Tetsuya Yamagami

By: Esther Ayoola Japan court don sentence di killer of former Prime Minister Shinzo Abe, wey dem dey call Tetsuya Yamagami, to life in prison. Yamagami bin admit say e shoot Abe for 2022, di mata sef ehn shock di whole Japan. Prosecutor dem tuk say dis crime na “unprecedented” and e get serious effect for society. Yamagami lawyer bin beg make court give am just 20-year maximum punishment, as […]

todayJanuary 21, 2026 5

obodo oyinbo

Beijing Ginjer Afghanistan To Protect Chinese Citizens After Kabul Bomb Blast

By: Esther Ayoola China don send SMS on Tuesday to Afghanistan say, make dem protect Chinese citizens afta bomb blast for Chinese Noodle restaurant for central Kabul, kill seven people. China say dem nor wan hear anytin, protect Chinese citizens ni be di message China Foreign Ministry tuk tuk, Guo Jiakun, tuk say dem don call di Afghan gornment make dem treat dose wey wunjor well and tighten security for […]

todayJanuary 20, 2026 12 16

obodo oyinbo

President Trump Invite Putin To Join Im ‘Board of Peace’ Movement

By: Esther Ayoola Oooh, US presido, Donald Trump dey find trouble sha, say im don invite Russian Presido Vladimir Putin make e join im “board of peace” wey go try solve all di shootie shootie wey dey go on for di world and hellep manage Gaza war. Dis invitation sef dey come, when Russia sti dey war with Ukraine, di mata sef don tey, nearly four years. Trump dey try […]

todayJanuary 20, 2026 9 15

obodo oyinbo

Gun Battle For Syria Afta Army and SDF Sign Ceasefire

By: Esther Ayoola Syria army and Kurdish-led Syrian Democratic Forces, SDF, do small gun battle today, just one day afta dem sign ceasefire to stop weeks of serious fighting wey don chase plenty people commot for dia houses. President Ahmed al-Sharaa say e go meet SDF oga, Mazloum Abdi, on Monday afta bad weather stop am from come meeting before. Even with ceasefire, tension never calm as shooting still dey […]

todayJanuary 19, 2026 5 15

obodo oyinbo

Spain Train Crash Kpai At Least 39 As Rescue Continue

By: Esther Ayoola Say nor be small askident for spain, day Plenty pipo from Huelva, Cartaya, Lepe, and Aljaraque  ni dey miss ontop di mata dat on train crash. Jose Manuel Moreno wey dey in charge of Citizen Security for Huelva even tuk say, im never sti sabi how many pipo don kapi but according to report say at 39 Konfam dead so far as recue dey continue on Monday. […]

todayJanuary 19, 2026 5

obodo oyinbo

Syrian Government, SDF Agree Ceasefire

By: Esther Ayoola Syrian government share update, say dem don reach agreement with Kurdish-led  Syrian Democratic Forces, SDF,  say make dem stop to kill dia self. Dis agreement  dey come  days afta plenty fight, fight between di Syrian gornment and di SDF for  northeastern Syria. According to report, SDF go comot from area wey dey west side of River Euphrates. Syrian Presido Ahmed al-Sharaa tuk on Sunday say, gornment go […]

todayJanuary 19, 2026 4 6

obodo oyinbo

Trump Promise To Send Soldiers Go Minnesota To Stop Protest

By: Esther Ayoola US Presido, Donald Trump don cut chain, say e fit use one old law wey dem dey call Insurrection Act to send U.S. military go Minnesota, if state officials no stop di protest wahala for Minneapolis. Di law fit allow military for inside America to help restore order. Dis warning dey come as protests heat up afta federal Immigration and Customs Enforcement (ICE) officers shoot people during […]

todayJanuary 16, 2026 14

obodo oyinbo

Museveni Lead Uganda President Election From first results with 76 percent

By: Esther Ayoola Oga Presido of Uganda, Yoweri Museveni like dis don dey dust im opponents, dey lead Uganda election result as counting of votes dey on. According to Electoral Commission of Uganda, afta dem count almost half of di polling units, Museveni get about 76 percent of di vote, while im main challenger, Bobi Wine, get around 20 percent. Like dis di gbege nor be here, say Bobi Wine […]

todayJanuary 16, 2026 3

obodo oyinbo

Iran Go Fast Track Trials Afta Trump Threat

By: Esther Ayoola Iran gornment vow to fast-track trial for people wey dem arrest during big protests, Iranian Judiciary Chief Gholamhossein Mohseni Ejei tuk on Wednesday. Di promise come afta US President Donald Trump warn say dem go face “very strong action” if Iran go ahead with hangings. Rights groups say crackdown fit don kill thousands as protesters challenge Iran clerical leadership, but government insist dem don regain control. Ejei […]

todayJanuary 14, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app