obodo oyinbo

135 Results / Page 1 of 15

Background

obodo oyinbo

US and Venezuela Join Hand Again to Fix Dia Economy

Di United States and Venezuela don agree to repair dia diplomatic relationship According to U.S. State Department on Thursday, saying dem want hellep bring stability, after long tensions. Di statement dey come from Washington, U.S., and say both sides go work together say pipo from both kontries don see shege President Donald Trump for U.S. and Venezuelan leaders say di new ties dey important, and dem say, dis step fit […]

todayMarch 6, 2026 8

obodo oyinbo

U.S Presido Trump Say Iran Dey Feel Di Heat

US Presido, Donald Trump  say Iran don dey feel di heat oh,  reach say, Iran no get air force again. Trump put for im Truth social say, i tuk am, an dem don dey see workings for Iran. Meanwhile for Iran, Secretary Ali Larijani dey rake say Iran soldiers dey ready if US come ground fight, dem fit kill and capture plenty Americans. Since Saturday, US and Israeli attacks don […]

todayMarch 6, 2026 4

obodo oyinbo

Iran Fire Missiles Enter Tel Aviv, Cause Big Damage

Iran don fire cluster missiles reach Tel Aviv for new attack wey hit central Israel,  damage everywia. TV Channel 12 for Israel report say some missile pieces land for di city and areas around am. According to eye wey see, wey nor reach collect slap, for eyes, say properties wey destroy yakpa Say, Since February 28, Iran don dey fire missiles and drones enter Israel and Gulf countries wey get […]

todayMarch 6, 2026 6

obodo oyinbo

First Rescue Flights Carry Stranded Israelis Back To Tel Aviv

First two flights wey carry Israelis wey dey stranded for abroad because of Middle East war don land for Tel Aviv on Thursday, after airspace close when United States and Israel launch strike against Iran. Di  flights land for Ben Gurion Airport, wey still remain closed for commercial flight operations, as first flight wey El Al Airlines operate come from Athens, while second flight wey Israir Airlines operate come from […]

todayMarch 5, 2026 4

obodo oyinbo

Iran Hit US Oil Tanker For Gulf – Reports

Iran state TV don yarn say dem fire missile on one United States oil tanker for Persian Gulf on Thursday, and di vessel dey catch fire for sea. Di Islamic Revolutionary Guard Corps talk say di strike happen for Northern Gulf, but independent sources never confirm di attack as tension still dey rise for di region. Di Guards still boast say dem don take full control of di Strait of […]

todayMarch 5, 2026 5

obodo oyinbo

Mojtaba Khamenei Fit Take Over As Iran Supreme Leader

Say pikin of late Iranian leader Ali Khamenei, Mojtaba Khamenei, dey among di main people wey fit become new oga for Iran. Ahmad Khatami, one member of di Assembly of Experts, na im dey relate di mata to Iranian state media on Wednesday, say dem hope to vote “at di earliest opportunity” to choose di new leader. Other contenders include Alireza Arafi, Mohsen Araki, and Hassan Khomeini, wey fit also […]

todayMarch 5, 2026 8

obodo oyinbo

Iran Drone Hit UK Base For Cyprus, Germany Warn Say NATO Fit Collect Too

Germany foreign minister Johann Wadephul  say attack fit hit NATO country after Iranian drone go hit British air base for Akrotiri, Cyprus. Im tell tori pipo, say, two oda drones sti try attack but dem  intercept dem. According to report, UK don dey do defensive military work for Middle East against Iran to protect dia forces. Wadephul explain to Deutschlandfunk say Germany soldiers fit defend demself, if dem come under […]

todayMarch 3, 2026 2

obodo oyinbo

IMN Protest For Lagos Condemn US, Israel Strike

Members of di South-West leadership of di Islamic Movement for Nigeria don hold peaceful protest for Lagos. Dem dey condemn United States and Israel for killing Iran Supreme Leader, Ayatollah Ali Khamenei. Dem also talk say im wife, Mansoureh Khojasteh Bagherzadeh, sti kpai from wunjuries wey she suffer for di recent attacks for Tehran, say di waka nor make brain at all. Reports talk say Khamenei sef die on Saturday, […]

todayMarch 3, 2026 3

obodo oyinbo

Iran Guards Konfam Missile Attack On Netanyahu Office

Iran Revolutionary Guards don konfamate say dem fire missile to office of Israel Prime Minister Benjamin Netanyahu and headquarters of Israel air force commander. For statement wey Fars news agency carry, dem say na Kheibar missiles na im dem use for the attack. Meanwhile, Iran President Masoud Pezeshkian don appoint Revolutionary Guards General Majid Ebnelreza as acting defense minister. Dis one happen afta im former defense minister die for Israeli-US […]

todayMarch 2, 2026 2

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app