obodo oyinbo

580 Results / Page 10 of 65

Background

obodo oyinbo

US Pull Some Troop Comot Nigeria After Joint Operation

By: Kofoworola Olayinka US and Nigerian forces don carry out joint military operations for Lake Chad Basin wey lead to di killing of Abu Bilal al-Minuki, wey US identify as senior Islamic State commander. Pentagon Africa Command spokesperson, Colonel Becky Heyse, say di joint operation show say temporary US military presence fit deliver strong security results. According to reports, Washington dey plan to reduce some of im military presence because […]

todayAugust 28, 2026 20

obodo oyinbo

Trump Don Comot Maduro From Power for Venezuela

By: Kofoworola Olayinka US Presido Donald Trump don send American forces enter Venezuela on January 3, 2026, where dem reportedly capture Presido Nicolas Maduro and im wife, Cilia Flores, before dem carry dem go America. Trump later tuk say US go oversee Venezuela political transition, while America also move to take control of how Venezuela crude oil go dey sell and how di money go dey handle. Di move mean […]

todayAugust 28, 2026 23

obodo oyinbo

Norway King Harald V Don Kpai at 89

By: Kofoworola Olayinka Norway King Harald V don kpai  at age 89 on Friday after more than 30 years for di throne, with im 53-year-old son, Crown Prince Haakon, automatically taking over as king. Britain King Charles III mourn di death, describing Harald as im dear cousin and a big figure wey guide Norway through plenty changes. NATO Secretary General Mark Rutte and European Commission President Ursula von der Leyen […]

todayAugust 28, 2026 19

obodo oyinbo

Irab Write Conditions Like NEPA Bill To Open Strait Of Hormuz

By: Mariam Ajayi Iran security chief, Mohsen Rezaei, don tuk say Tehran dey prepare long list of conditions before dem go open Strait of Hormuz. Qatar Prime Minister don travel go Tehran go beg Iran make dem calm down, but Iran no gree. Meanwider, US gorment pipo say Iran action na just initial gragra as American naval blockade still tight. Di mata don turn serious gbas-gbos between Iran and America, […]

todayAugust 28, 2026 18

obodo oyinbo

How Nepal Floods Kpai kpai Over 160 People As 403 People Missing

By: Yusuf Abuh At least 160 people don die and 403 others still missing after heavy floods and landslides hit northern Nepal near Tibet border on Wednesday, destroying whole communities. Nepali police say dem don recover 157 bodies, while Chinese state media report three deaths and 265 people missing for di Chinese side of di border. Nepal tourism ministry say 403 tourists, including 341 foreigners, don also go missing hours […]

todayAugust 27, 2026 18

obodo oyinbo

German Embassy Warn Nigerians Against Fake Visa Information

By: Kofoworola Olayinka German Embassy for Nigeria don warn Nigerians on Wednesday to avoid misinformation from visa pipu when dem dey seek information about visa applications. Di embassy issue di warning for official X account, urging Nigerians to get visa information directly from official sources instead of agents. Di mission say Nigerians fit share claims wey dem hear from visa agents for di comments, so di embassy fit address some […]

todayAugust 26, 2026 13

obodo oyinbo

Fire Kill 14 Babies For Pakistan Hospital Maternity Ward

By: Kofoworola Olayinka Fire don gut maternity ward for hospital for Islamabad, Pakistan, killing 14 babies. Authority say faulty air conditioner cause di fire wey start for third floor of Pakistan Institute of Medical Science. Witness say heavy smoke, broken glass and slow emergency response make di situation worse.

todayAugust 26, 2026 20

obodo oyinbo

Strait Of Hormuz Still Dey Closed As Iran, US Gbege Demselves

By: Mariam Ajayi According to di Deputy Foreign Minister, Kazem Gharibabadi say US must first return to im commitments before dem fully open di waterway. U sabi say, US President Donald Trump say all mines (dat navy bomb) for di international waters of di strait don clear and warn say any ship wey try plant new bomb ehn go dance osurugede dance, dem never shishonshi. Meanwhile, US State Department say […]

todayAugust 26, 2026 23

obodo oyinbo

Chase Illegal Migrants Comot – Abelardo de la Espriella Yarn

Colombia right-wing Presido, Abelardo de la Espriella, don order immigration crackdown, as e tell authorities make dem start to dey arrest foreign pipo wey enter di country without proper papers, and wey don commit crime, so dem fit deport dem. Abelardo wey enter office on August 7, after e campaign say e go deal with crime and drug-trafficking gangs. Immigration no be major part of im campaign, but for security […]

todayAugust 25, 2026 12

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds