obodo oyinbo

510 Results / Page 10 of 57

Background

obodo oyinbo

Traore warn say nobody fit challenge im power for Burkina Faso

By : Jolayemi Olajide Burkina Faso military leader Ibrahim Traore don warn say nobody fit lead di country apart from am, as e dismiss rumour of power struggle inside di junta on Thursday for Ouahigouya. Traore tok dis for news statement say "two capons nor fit dey for di same boat. According to Traore, any person wey im go catch do nonsense go face di music. Rumours of infighting start […]

todayJuly 22, 2026 13

obodo oyinbo

North Korea Stand Gidigba With Russia Over Ukraine War

  By : Jolayemi Olajide North Korea don konfam say e still dey support Russia for di Ukraine war after di foreign ministers of both countries meet for Moscow, according to state media on Tuesday. Since Russia begin full-scale invasion of Ukraine for early 2022, North Korea and Russia don strengthen dia relationship despite international pressure. Reports say Pyongyang don send soldiers and weapons go help Russia, while Moscow dey […]

todayJuly 21, 2026 14

obodo oyinbo

Trump Slam 50% Tariff on Canada Goods, Trade Wahala Deepen

By: Esther Daniel US Presido Donald Trump don announce 50 percent tariff on plenty goods wey dey come from Canada, say na because Canada no dey treat American cars, dairy products and alcohol fairly. Di new tariff go affect items like wine, hockey sticks and cement, but energy, critical minerals, potash and fish no go join. Di announcement come on Tuesday, and di White House say di new import duty […]

todayJuly 21, 2026 15

obodo oyinbo

Andy Burnham To Collect Swear As New Britain Prime Minister

By: Esther Daniel Andy Burnham don become Britain new Prime Minister today as e move enter 10 Downing Street, replacing Keir Starmer after Labour change leader. Burnham go try solve all di jogolos inside di UK, from economy to public services, as people dey expect quick results. After King Charles III ask am to form new gornment, Burnham go give im first speech outside 10 Downing Street. Burnham promise to […]

todayJuly 20, 2026 19

obodo oyinbo

Trump Knock Tuchel Over England World Cup Exit

By: Esther Daniel US President Donald Trump don condem England coach Thomas Tuchel over di team 2-1 loss to Argentina for di 2026 FIFA World Cup semi-final. Trump say Tuchel make big  mistake wey im move captain Harry Kane into a defensive role after England score first. According to am, di decision give Argentina chance to take over di game and score two late goals to qualify for di final […]

todayJuly 20, 2026 16 2

obodo oyinbo

Presido Faye Become New Chairmo of ECOWAS

Senior man Presido of Senegal, Bassirou Faye, don become di new Chairmo of ECOWAS. Dis one na after election inside di 69th Ordinary Session of Heads of State and Government meeting wey happen for Sierra Leone on Sunday. Faye take over from Sierra Leone Presido, Julius Maada Bio, wey bin dey lead di regional body before now.

todayJuly 20, 2026 16

obodo oyinbo

21 Childrensis Kpai As School Bus Crash For Uganda

By: Esther Daniel At least 20 pikin and one adult don kpai after one school bus carry students from excursion lose control and crash for Uganda. Police tok say di bus wey dey return from Sipi Falls comot from road, hit one big stone before e turn upside down. Three adults and several pikin still get wunjury, and dem dey receive treatment for hospital as police continue investigation. Road accidents […]

todayJuly 17, 2026 14

obodo oyinbo

World Energy Oga, Birol Fry Mouth On How Middle East War Fit Spoil Things

By: Yusuf Abuh Di head of International Energy Agency, Fatih Birol, don warn say global energy security fit face serious threat if US-Iran tensions no reduce and oil flow through Strait of Hormuz no improve. Birol put for statement say di world need to worry about oil supply if di situation no change in di next few weeks. His warning come as US attacks on Iran continue, while Tehran dey […]

todayJuly 17, 2026 15

obodo oyinbo

Orphanage Home Catch Fire As Heatwave Scatter Algeria

According to authorities for Inside Algeria, on Thursday, at least 11 pipo, including childrensis, don kpai after serious fire burn one orphanage for Mohammadia, one area for Algeria capital, Algiers. Dis badness happen as di country dey battle severe heatwave wey don cause hundreds of fire outbreaks. According to one resident, Abdessalam Merrah, he talk say around 3 a.m. dem hear fire engines and childrensis wey dey scream inside di […]

todayJuly 16, 2026 14

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds