obodo oyinbo

580 Results / Page 8 of 65

Background

obodo oyinbo

Iran Say US Hit Dia Oil Tankers, Warns of Regional Gbege

By: Kofoworola Olayinka Iran Foreign Ministry don condemn US strikes on Iranian oil tankers on Wednesday, saying di attack threaten peace and security for di region. Di ministry say di US action against Iranian commercial vessels go increase tension for di region and pose serious danger to regional and international security. Iran also claim say dia forces attack US military facilities across di region as part of self-defence after di […]

todaySeptember 9, 2026 12

obodo oyinbo

Iran And America Start Another Round of War

By: Damilola Adekunle Iran and America don exchange fresh blows again as Tehran attack US targets for Middle East, following American strikes on Iranian oil tanker. Iran Revolutionary Guards tok say dem attack 20 US vessels around Strait of Hormuz, as dem also target an American military base for Jordan. Di US military tok say Iran first target one of di warships, as di fresh attacks don push oil price […]

todaySeptember 9, 2026 9

obodo oyinbo

UN Cry Out As Ebola kpai over 3,200 Pipo for DR Congo

By: Mariam Ajayi Dis Ebola virus nor get same for eyes oh, see di way e dey rush  DR Congo, you go sorry for dem. Infact United Nations dey  scream, help oh help for DR Congo, say na over 3,200 pipo don kpeme, and like dis health workers dey sweat like person chrismas Goat, e nor easy. According to UN tok-tok person, Stephane Dujarric, To pull di handbrake on dis […]

todaySeptember 9, 2026 11

OBODO NAIJA

Nigerians for UK Vex Over Manchester Passport Delay

By: Ayobami Dada Nigerians wey go collect passport for Manchester, UK, don vex as dem wait for hours without anybody attending to dem on Tuesday. One Nigerian, Oluomo of Derby, tok say people wey reach di centre since 9 a.m. still dey wait by 11:30 a.m., even after dem travel far and comot work. Oluomo say di whole thing no make sense, and e call for better arrangement so Nigerians […]

todaySeptember 8, 2026 11

obodo oyinbo

Cape Verde Bus Crash Kill 25, Mostly Children

By: Ayobami Dada Cape Verde don begin two days national mourning after bus crash for Fogo Island kill 25 people, mostly children and teenagers, on Saturday night. Di bus wey carry 32 people dey return São Filipe when e veer off road enter deep ravine, killing di driver and 24 others. Families and residents gather across Fogo Island on Sunday to bury di victims and pay dia final respect.

todaySeptember 8, 2026 11

obodo oyinbo

Qatar Cry Out Say Iran And US Dey Spoil Business For Dem

By: Yusuf Abuh Oya oh, Middle East dey boil like dis, pepper bodi everywia as  Qatar Foreign Ministry spokesperson, Majed Al-Ansari, dey cry give US make dem calm down for di Strait of Hormuz, say oil business dey suffer. According by di oyinbo wey dem speak news statement, “industrial catastrophe naim dey hapun for di strait of Hormuz. Kpler data show say na only about 10 cargo ships dey manage […]

todaySeptember 8, 2026 13

obodo oyinbo

Iran Say Hormuz Still Dey Closed, Warn US

By: Kofoworola Olayinka Iran security chief Mohsen Rezaei say vessels wey enter Strait of Hormuz without Iran approval go face sanctions wey fit affect dia insurance and future passage. E insist say di waterway still completely closed, accusing America of lying about ships and oil tankers wey dey cross am through routes near Oman. Rezaei also say Iran don test-fire new anti-destroyer missile over US aircraft carrier as warning say […]

todaySeptember 7, 2026 13

obodo oyinbo

Iran Threaten Say E Go Block Hormuz After US Sink 3 Oil Tankers

By: Mariam Ajayi Iran top security boss, Mohsen Rezaei, don threaten to block road near Strait of Hormuz like road safety, come dey command ships to pass Oman side. Dis one  pass pepper body sef,  as Iran Parliament Speaker, Mohammad Bagher Ghalibaf, vex warn America,  say, dem dey load  shege  for oil business, after US military sink three of dia oil tankers. While dis big men dey drag muscle, Israel […]

todaySeptember 7, 2026 14

obodo oyinbo

US Vice Presido JD Vance Dodge Update on Iran War

By: Mariam Ajayi US Vice President JD Vance like dis now dey dodge questions on updates of how di war between America, Israel, and Iran go end. Tatafo pipo bin block Vance, e  try to cool di matter down for White House press briefing on Thursday, con even ague say nor be war dem dey fight for Iran. Although heavy bomb-blast don dey fly between US and Iran for days, […]

todaySeptember 4, 2026 18

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app

This will close in 0 seconds