obodo oyinbo

135 Results / Page 2 of 15

Background

obodo oyinbo

Trump Say Fight With Iran Fit Last Four Weeks

U.S. Presido Donald Trump say di fight with Iran fit last four weeks. E tuk dis one for interview, say di country big, so e go take about four weeks or less. And from report say na three U.S. soldiers don kpai and five get serious wunjury. Trump dey praise im soldiers wey die, call dem “great people and dat, Iran must hear word.

todayMarch 2, 2026 3

obodo oyinbo

Hezbollah Fire Rockets, Drones Enter Israel To Revenge Iran Attack

Hezbollah for Lebanon say dem don fire rocket and send drone to military base for south of Haifa for Israel. Dem say na revenge for Iranian oga Ali Khamenei wey kpai afta U.S. and Israel attack for Tehran. However, Israel tuk say dem don fire back Hezbollah for Lebanon and no go do wahala with dem. Lebanon PM Nawaf Salam say, im ready to protect im pipo to di fullest.

todayMarch 2, 2026 4

obodo oyinbo

Iran Attack Ship For Strait of Hormuz

Global oil price don jump up afta jaguda pipo go attack at least three ship for Strait of Hormuz. UK Maritime Trade Operations Centre (UKMTO) report, na im dey report dis one say, di jaguda boys attack Two ship for Kena. Say dis one sef na based on say Iran dey strike back Middle East aftA  US and Israel bomb Iran. Iran don warn say dem nor go allow any […]

todayMarch 2, 2026 4

obodo oyinbo

Plenti Flight Cancel Afta US-Iran Fire Each other

Flights don scatter everywhere, as thousands of passengers dey stranded as US and Israel attack on Iran make global air travel choke. Countries like Iran, Israel, Qatar, Iraq and UAE lock dia space for air as missile and strike action burst for Gulf region. Airlines from Europe, Asia and America cancel plenti flights as tension for Middle East still dey hot like fire. Iran sharpaly lock dia airspace until further […]

todayMarch 1, 2026 5

obodo oyinbo

Iran Strike Israel and US Base Afta Khamenei Kpai

Iran launch fresh wave of missile and drone attack on Sunday, target 27 US military base for di region and Israel military headquarters for Tel Aviv, say na payback afta big US-Israel strike kill Supreme Leader Ayatollah Ali Khamenei. Iran army for statement wey dem show for state TV talk say dia air force bomb US base for Gulf countries and Kurdistan region of Iraq for different phases of operation. […]

todayMarch 1, 2026 5

obodo oyinbo

China Remove 19 Lawmakers, 9 Na Military Men, Before Big Election Meeting

By: Esther Ayoola China don shake table, remove 19 people, including nine military officers, from lawmaker list before dia big political meeting next week. National People's Congress Standing Committee konfamate di removal, but no share any reason for di removal. Dis one dey hapun soon afta President Xi Jinping remove Zhang Youxia, him top general and close ally. Some people dey tuk say Xi dey fight corruption, but others tuk […]

todayFebruary 27, 2026 8

obodo oyinbo

Pakistan Fire Kabul, Kandahar Afta Taliban Attack Border

By: Esther Ayoola Pakistan gornment don konfamate dia doings, say dem fire Afghan cities, like Kabul and Kandahar, all collect for early Friday, afta Afghan Taliban attack Pakistani border soldiers late Thursday. Taliban tuk, tuk put for X say, dem fire back for Pakistan border, but di post, dem don delete am. Both Pakistan and Taliban dey claim say, dem sactta ground, despite ceasefire tuks since last October.

todayFebruary 27, 2026 3

obodo oyinbo

US-Iran Make Big Progress For Nuclear Tuk

By: Esther Ayoola Omani foreign minister Badr Albusaidi, say US and Iranian officials don make “big progress” for nuclear tuks for Geneva dis week. Badr clear tori pipo on Thursday afta di meeting for Geneva, say dem plan to continue tuks  sha  afta dem go back dia countries, and technical-level discussion go hapun for Vienna next week. Iran foreign minister Abbas Araghchi sef clear mata say dem agree for some […]

todayFebruary 27, 2026 4

obodo oyinbo

Kim Jong Un Talk Say E Go Boost Nuclear Power For North Korea

North Korea Leader, Kim Jong Un don yarn say e go boost North Korea nuclear weapons power, as e waka go watch big night military parade with im daughter. Around 14,000 soldiers march for Pyongyang Kim Il Sung Square, dey goose-step under strong floodlight as fighter jets dey shout for sky. Kim daughter, wey people dey suspect say fit be Ju Ae, show face beside her papa for parade, but […]

todayFebruary 26, 2026 5

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app