obodo oyinbo

60 Results / Page 2 of 7

Background

obodo oyinbo

Iran Go Fast Track Trials Afta Trump Threat

By: Esther Ayoola Iran gornment vow to fast-track trial for people wey dem arrest during big protests, Iranian Judiciary Chief Gholamhossein Mohseni Ejei tuk on Wednesday. Di promise come afta US President Donald Trump warn say dem go face “very strong action” if Iran go ahead with hangings. Rights groups say crackdown fit don kill thousands as protesters challenge Iran clerical leadership, but government insist dem don regain control. Ejei […]

todayJanuary 14, 2026 5

obodo oyinbo

France Wan Open Emergency Mata House For Greenland February

By: Esther Ayoola Say, France wan open emergency mata house, wetin oyibo dey call consulate for Greenland on February 6, 2026. French Foreign Minister Jean-Noel Barrot tuk on Wednesday, say, di move na beta political move based on say Greenland dey strategic. Dis one dey come following US Presido, Donald Trump don bin yarn, dat im wan seize di island. Say infact, Denmark top diplomat dey meet US officials for […]

todayJanuary 14, 2026 4

obodo oyinbo

Iran Tell Us: We Ready To Tuk, But No Go Accept Intimidation

By: Esther Ayoola Iran tuk say dem still dey communicate with America through Switzerland, even as protest and violence dey spread for di country. Iran foreign ministry tuk say dem ready for dialogue but no go accept any one-sided tuk or foreign interference. Untop yaning for us, President Trump confamate say, Iran call am to negotiate nuclear matter, while e still dey threaten strong action. Meanwhile, gornment don shut internet, […]

todayJanuary 12, 2026 7

foreign

Iran Presido, Pezeshkian Promise to Listen to Protesters

By Ebi Oboko Iran presido, Masoud Pezeshkian, don bow to pressure,   say  dem go  rearrange di iran economy wey dem spoil, dey warn protesters to be calming down. Pezeshkian dey beg for tv sit don tuk, say make di protesters nor go do until  “rioters” and “terrorist elements”  con take over di mata, say dat one  go be big  wahala. The protest don enter third week after market people for […]

todayJanuary 12, 2026 8

obodo oyinbo

Trump Warn: US Fit Hit Nigeria Again Over Killings

By: Esther Ayoola US President Donald Trump don warn say America fit launch more military strikes for Nigeria if violence against Christians no stop. Trump tuk dis one on Thursday during wide interview with The New York Times, as e respond to question about di US airstrike wey happen on Christmas Day for northwest Nigeria. According to am, di December 25 strike target Islamic State-linked militants at di request of […]

todayJanuary 9, 2026 11

obodo oyinbo

Naija Collect $9.5M from Jersey – Govt Yarn

By: Esther Ayoola Authorities for Jersey, British Crown Dependency wey dey between UK and France, yarn say dem go return over $9.5 million (£7 million) wey belong Nigeria government. Attorney General for Jersey, Mark Temple KC, tuk say di money go dey used for infrastructure projects across Nigeria. Him yarn dis one follow Memorandum of Understanding wey dem sign with Nigeria government for December. Dis repatriation na continuation of past […]

todayJanuary 9, 2026 3

obodo oyinbo

Turkish Airlines No Dey Fly Tehran Again As Iran Protest Dey Hot

By: Esther Ayoola Turkish Airlines don cancel five Friday flights wey suppose go Tehran, Iran, afta di city don dey rocked by protests over rising living cost, di Istanbul Airport app report on Thursday. Di airport app also show say five oda  flights wey Iranian airlines dey operate don cancel, while seven others still dey go ahead as scheduled. Turkish authorities never comment on di situation yet, wey dey happen […]

todayJanuary 9, 2026 6

obodo oyinbo

No Send Soldiers Go Ukraine, War Fit Sup – Russia Warn US, Europe

By: Esther Ayoola Russia don drop hard warning give US and Europe say make dem no try send soldiers go Ukraine, say if dat one happen, na bigger war go burst, as di fight don already drag near four years. Russia say foreign troops no go calm anything, e go only scatter di marras and cause face-to-face wahala. But US and European leaders still dey yarn about security cover for […]

todayJanuary 9, 2026 6

foreign

U.S Take Over Venezuela Oil Money

By Ebi Oboko US  say dem don dey control Venezuela oil sales and dat,  na dem go  decide how Venezuela go take spend dia money. US Department of Energy na dey troway dis one for social media, say dem don even start to sell the oil for world market, and all the money go first enter bank accounts wey US dey control. Dem say, dem don succeed sell about 30 […]

todayJanuary 8, 2026 6

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app